News-auth

322 Results / Page 11 of 36

Background

Lagos

Bus Catch Fire For Adekunle Side, Say Traffic Choke For Third Mainland Bridge

By: Esther Ayoola Another gobe, say One ogbonge commercial bus say catch fire for Third Mainland Bridge near Adekunle on Tuesday afternoon. Konfam gather from Lagos state traffic management agency say di fire cause heavy traffic for  Iyana Oworo, but dem successfully manage am According to report, Lagos State Fire Service quick reach di area fight di fire. Say di fire happen because di bus catch fire for unknown reason, […]

todayJanuary 6, 2026 4 1

Sports

Eddie Howe Dismis Tuk Say Im Wan Go Manchester United

By: Esther Ayoola Newcastle United manager Eddie Howe don make am clear say Man united job nor dey im eyes, because e dey very happy for him job. Howe don dey manage Newcastle since November 2021, and na one of di longest-serving managers for Premier League now. Even though some top pipo like di sporting director and chief executive don change, Howe don build strong relationship with di new bosses. […]

todayJanuary 6, 2026 5

obodo oyinbo

Maria Machado Vow Say She Go Return Venezuela

By: Esther Ayoola Venezuelan opposition leader Maria Machado tuk say she go return afta US military comot President Nicolas Maduro from power. For her first public tuk since di weekend post, di Nobel Peace Prize winner yarn for Fox News say she dey plan come back Venezuela as soon as possible. Machado no gree with interim president Delcy Rodriguez, say, she na one of di people wey plan torture, persecution, […]

todayJanuary 6, 2026 5

National

Former Rep Member Say PDP Don Fail, Na Why Pipo Dey Run

By: Esther Ayoola Former House of Reps member, Dachung Bagos, don finally expose wey pipo dey gbase comot di pipos democratic party say di party don spoil beyond repair. Bagos yarn dis one for TV sitdon tuk afta e officially join APC, say dem no dey jump party for ambition or eye service but because PDP no dey give people voice again. According to am, APC agenda dey align with […]

todayJanuary 6, 2026 6 9

National

Jaguda Bandits Storm Katsina Communities

By: Esther Ayoola Say nor be small tin Katsina state, dat some jaguda Bandits, wey carry dangerous weapons enter some communities for di State, kidnap  pipo for  night. Witnesses tuk say the armed men attack Unguwar Alhaji Barau before dem move go Gidan Dan Mai-gizo and Gidan Hazo for Na’alma Ward, Malumfashi Local Government Area. Security pipo never tuk officially, and nobody still know the exact number of people wey […]

todayJanuary 6, 2026 5 2

National

Army Stop Kidnap For Taraba, Rescue Three People

By: Esther Ayoola Troops of di 6 Brigade Nigerian Army don foil one kidnapping attempt and rescue three people for Taraba State. According to statement wey Umar Muhammad, Army Public Relations Officer for 6 Brigade, sign, di operation happen on January 5, 2026, afta soldiers get correct intelligence about kidnappers for Sangai Village, Karim Lamido LGA. Di Army tuk say as di troops pursue di suspects towards Taraba–Plateau border, di […]

todayJanuary 6, 2026 5 4

National

Army Torchlight Soldier Allegedly Kpaiing Of 13-Year-Old Boy For Akwa Ibom

By: Esther Ayoola Nigerian Army don start investigation into death of one 13-year-old boy wey dem allege say soldier shoot for Ikot Abasi Local Government Area of Akwa Ibom State. Di incident happen early momo of January 1, 2026, for Akongntekong Road, Ete, and e cause serious anger and tension for di community. Army Public Relations Officer for 2 Brigade, Mbiokporo, Captain Lawal Mohamed, tuk say Military Police don take […]

todayJanuary 6, 2026 5

obodo oyinbo

China Move Mehn To Guide Latin America Say Ameriaca Dey Misbehave

By: Esther Ayoola China Foreign Ministry don yarn again say dem no dey happy with wetin US dey do for Venezuela and dem ready join other countries make international law stand gidigba. Dem tuk say dem ready to join hand with countries for di region to protect peace for Latin America plus Caribbean. You sabi say, China don call on US make dem free Maduro sharp-sharp and stop dey topple […]

todayJanuary 6, 2026 7

Lagos

LSFRS Update GNI, Fire Scarra House, Church for Lagos

By: Esther Ayoola Say nor be small fire burn area yesterday for 15, Pipeline Road, off Ekoro Road, Abule Egba, Lagos, wey scarra one residential house plus small church for di area. Lagos Fire Service wey confamate di tori  say, dem receive distress call around 1pm. and sharp-sharp na so dem rush with  dia fire crews from Agege and Abesan station go fight di blaze. Controller General, Margaret Adeseye, tuk […]

todayJanuary 6, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app