News-auth

320 Results / Page 8 of 36

Background

National

FG: NARD Dispute Na Structural Issue

By: Esther Ayoola Federal Government don explain say di ongoing wahala between dem and di National Association of Resident Doctors (NARD) no be because dem no care, but na structural and policy issues dey cause am. Honourable Minister of State for Health and Social Welfare, Dr Iziaq Adekunle Salako, tuk dis on Wednesday for statement wey Statehouse release. Im explain say Tinubu gornment still dey committed to good relation with […]

todayJanuary 7, 2026 5

Sports

Gary O’Neil Be New Strasbourg Coach

By: Esther Ayoola French club Strasbourg don announce on Wednesday say Gary O’Neil go replace Liam Rosenior as dia new coach. Rosenior leave di Ligue 1 team on Tuesday to join Premier League side Chelsea. O’Neil, wey 42 years old, don play for clubs like Portsmouth and Middlesbrough and even represent England under-21s. For official statement, O’Neil tuk say e dey excited and proud to join Strasbourg, and e dey […]

todayJanuary 7, 2026 4 3

National

NASENI Launch Youth Tech Innovation Program

By: Esther Ayoola Federal Gonment don share ogbonge update say dem wan turn Nigeria to global tech house and like dis, dem don officially launch di movement wey dem dey call Di National Agency for Science and Engineering Infrastructure (NASENI) Future makers initiative across obodo Naija. Executive Vice Chairmo and CEO of National Agency for Science and Engineering Infrastructure, Khalil Suleiman Halilu, unveil di programme during event wey hold for […]

todayJanuary 7, 2026 7

obodo oyinbo

US Sets $15,000 Visa Bond for Nigerians

By: Esther Ayoola United States gonment don announce new travel rules dis week, wey fit make Nigerians wey dey apply for B1/B2 visa pay bond of up to $15,000. According to US Department of State website, Travel State.Gov, even if applicant pay di bond, e no guarantee say dem go issue visa. Dem also warn say any fee wey person pay without direction, say consular officer no go fit return […]

todayJanuary 7, 2026 2

Sports

Super Eagles Buy Waka Marrakesh For AFCON Quarterfinal

By: Esther Ayoola Nigeria Football Federation don confamate say Super Eagles go comot Fez go Marrakesh on Thursday as dem dey prepare for Africa Cup of Nations quarterfinal. Dem go face Algeria for match on Saturday by 5pm. According NFF post on X, say All 26 available players join training on Tuesday evening for Sardienne Complex. Defender Ryan Alebiosu still dey sidelined as e dey recover from injury.

todayJanuary 7, 2026 3 2

Lagos

Lagos Gorment Carry Measles–Rubella Vaccine To 10.5m Pikin

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment, joinbodi with State Primary Health Care Board, on Tuesday don announce oh, say dem go carry out Measles–Rubella (MR) vaccination campaign to fight vaccine-preventable sickness for di state. Dem say di ogbonge campaign go run from January 20 to January 31 across Lagos, covering schools, religious centres, primary healthcare centres and markets, and e go target pikin wey age dey between nine and 14 […]

todayJanuary 7, 2026 6

National

Wetin You Need Sabi About Bank Charge

By: Esther Ayoola Chairmo of di Chartered Institute of Taxation, Abuja District, Ben Enamudu, don clear  Nigerians say, nobodi dey tax anybodi bank balances under di new tax reform. Untop yanings with news tuk tuk pipo on Tuesday, Enamudu, say only some electronic transfers dey attract ₦50 stamp duty. Im say, na wrong tori wey dey spread dey make people fear unnecessarily, say bank go collect tax from account balance. […]

todayJanuary 7, 2026 4

Lagos

Former-Lagos Education Director Chop Jail Sentence For N48m Steal

By: Esther Ayoola Lagos State Special Offences and Domestic Violence Court wey dey Ikeja don sentence 64-year-old former education director, Olawale Solomon Feleti, to 2 years 5 months jail. EFCC tuk say, during COVID-19 wahala for 2020, Feleti use bank glitch take waka enter Access Bank credit card system. According to EFCC, im withdraw at least N43,000 per transaction, kon convert total to N48.9 million comot wey im thief from […]

todayJanuary 7, 2026 5

obodo oyinbo

Iran Army Chief Wire SMS Say Dem Go Reply Trump

By: Esther Ayoola Commander of di Iranian military, General Amir Hatami,  don sama warning say Iran no go siddon dey watch if outside powers dey threaten dem. Him tell news tuk tuk on Wednesday  say any hostile tuk against di Iranian nation dey considered threat, and dem no go tolerate am. Hatami warn say if enemy make mistake, Iran response go dey stronger, pass last year 12-day war with Israel. […]

todayJanuary 7, 2026 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app