News-auth

697 Results / Page 9 of 78

Background

National

ICPC Raid Abuja House Of Former Kaduna Gov El-Rufai

By: Esther Ayoola Di Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission (ICPC) don go break enter di Abuja house of former Kaduna State govo, Nasir El-Rufai, like jet li, to search for possible corruption-related evidence. El-Rufai media adviser, Muyiwa Adekeye, ni dey konfamte dis mata give tori pipo on Thursday. According Adekeye, dem waka enter the house around 2pm and start dey search every corner of di property. El-Rufai […]

todayFebruary 20, 2026 7

National

CDS make Rambo Move to Flush Out Terrorists and Kidnappers

By: Esther Ayoola Chief of Defence Staff, General Olufemi Oluyede don launch new military operation wey dem call Operation SAVANNAH SHIELD for Ilorin, Kwara State. Di ceremony hapun for 22 Brigade, Sobi Military Cantonment, and dem say di mission na to fight terrorists, kidnappers and other criminal gangs for North Central region. For di flag-off, di CDS say dis one no be ordinary deployment, dat na Rambo movement to flush […]

todayFebruary 20, 2026 5

National

Olawale Edun Explain Wia FG Keep Naija N58.472 Trillion 2026 Budget

By: Esther Ayoola Minister of Finance, Olawale Edun, don clear air say Naija N58.472 trillion 2026 budget dey safe based on di size, dat e dey fridge dey cool. Edun yarn dis one when im lead him economic team go defend di budget for Senate Appropriations Committee. Di committee members, wey Solomon Olamilekan Adeola dey lead, ask plenty questions and di team answer one by one.

todayFebruary 20, 2026 3

National

Obi remind Tinubu Of Im Election Promise

By: Esther Ayoola Di 2023 Labour Parti presidential candidate, Peter Obi, once again don call out to oga presido, Bola Tinubu, say why dem one drop national grid for full solar energy. Di former Anambra state govo post for X, say e dey shock am say baba Seyi wan move go solar afta raking, dat im go bring steady light for im first tenor. Obi say, im bodi dey do […]

todayFebruary 20, 2026 2

National

Ogun Police Cut Chain For Tiktoker Say She Deceive Members Of Di Public

By: Esther Ayoola Ogun State Police command don plan to arrest one female TikTok user wey dem sabi as Mirabel afta investigation proof she lie say person rape her. Nor be amebo say, Mirabel tuk for one viral phone chat with social media influencer, VeryDarkMan (VDM) of how one man rape her. Say na only she implicate herself, tell VDM for audio call say, di claim na lie, For di […]

todayFebruary 20, 2026 2

Lagos

LAWMA to Recruit 300 Pipo To Make Lagos Streets Clean

By: Esther Ayoola Di Lagos State Waste Management Authority (LAWMA) don announce say dem go employ 300 pipo wey go dey make sure say Lagos streets dey clean. LAWMA MD, Dr Olumuyiwa Gbadegesin, tuk dis one during a visit to one ogbonge news house for Lagos. Gbadegesin sey, dem go sha train di people, den di LAWMA pipo, go con train Lagosians on how to handle waste, and anybodi wey […]

todayFebruary 20, 2026 3

Lagos

Education Stakeholders Call Gorment To Arrange Lagos Future

By: Esther Ayoola Education pipo for Lagos on Thursday don clear gorment dia mind, say dem need sharp doings, inclusion, teacher training, correct data and beta action plans to build strong education system. Dem tuk dis one for 2026 Lagos State Education Stakeholders panel wey Ministry of Basic and Secondary Education package. Different partners like UNICEF, British Council, SKLD and New Globe show face for di programme, as dem press […]

todayFebruary 20, 2026 2

Lagos

LASEMA Warn Drivers Afta Two Pipo Kpai For Trucks Askident

By: Esther Ayoola Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) like dis now, dey vex oh, dey, warn drivers to stop wawawa driving asap, afta two pipo kpai for askident wey hapun Thursday morning for Cele Bus Stop, Apapa-Oshodi Expressway. Untop yarnings with tori pipo, LASEMA Permanent Secretary, Dr Olufemi Oke-Osanyintolu, say, di  two 40-foot container trucks wey nor get  plate number,  collide, jam di other one wey park on im […]

todayFebruary 20, 2026 3

Lagos

Babajide Sanwo-Olu Cleartruck Owners To Avoid Drunk Drivers

By: Esther Ayoola Oga govo, Babajide Sanwo-Olu don sama beta warning to truck and cargo motor owners, say make dem nor dey give dia motor to drunk drivers. Sanwo Olu, make am clear say, any driver wey dem catch on hard drugs go get am hot, hot from di state gorment. U sabi say, na About 1,000 officers of National Drug Law Enforcement Agency Lagos State Command, don benefit from […]

todayFebruary 20, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app