News-auth

322 Results / Page 9 of 36

Background

Lagos

Former-Lagos Education Director Chop Jail Sentence For N48m Steal

By: Esther Ayoola Lagos State Special Offences and Domestic Violence Court wey dey Ikeja don sentence 64-year-old former education director, Olawale Solomon Feleti, to 2 years 5 months jail. EFCC tuk say, during COVID-19 wahala for 2020, Feleti use bank glitch take waka enter Access Bank credit card system. According to EFCC, im withdraw at least N43,000 per transaction, kon convert total to N48.9 million comot wey im thief from […]

todayJanuary 7, 2026 5

obodo oyinbo

Iran Army Chief Wire SMS Say Dem Go Reply Trump

By: Esther Ayoola Commander of di Iranian military, General Amir Hatami,  don sama warning say Iran no go siddon dey watch if outside powers dey threaten dem. Him tell news tuk tuk on Wednesday  say any hostile tuk against di Iranian nation dey considered threat, and dem no go tolerate am. Hatami warn say if enemy make mistake, Iran response go dey stronger, pass last year 12-day war with Israel. […]

todayJanuary 7, 2026 4

National

Chief Of Army Staff Promise Say Army Go Do All E Fit Do To Stop Terrorist Wahala

By: Esther Ayoola Chief of Army Staff, Lt.-Gen. Waidi Shaibu, don drop update say Naija  Army go do everything wey human fit do to stop di plenty terrorist attacks for Niger State and other parts of di country. E tuk dis one dis week for Minna, Niger State, during di opening of di 2026 Doctrine and Training Conference for Army Doctrine and Training Command. According to am, di Army dey […]

todayJanuary 7, 2026 6

National

BREAKING: Court Giv Malami ₦500 Million Bail Con Sti Tell Am Make E Nor Travel

By: Esther Ayoola Justice Emeka Nwite of Federal High Court for Abuja don grant former Attorney General, Abubakar Malami, bail of ₦500 million with two sureties. Di make di judgement on Wednesday say di sureties must get landed property for Asokoro, Maitama or Gwarinpa, and dem go submit dia travel documents to di court. Court also order make Malami drop im international passport and no comot Nigeria without court permission. […]

todayJanuary 7, 2026 7

Lagos

Lagos Court Jail Man 6 Months Say Im Sell Marijuana

By: Esther Ayoola A Federal High Court for Lagos don convict 35-year-old man, Deji Adesanya, dey sentence am to six months jail say im dey sell hard drugs, cannabis sativa, wey mehn dey call marijuana. Justice Akintayo Aluko give di sentence afta Adesanya confess by imself say im dey guilty for di one-count charge wey NDLEA carry come court. NDLEA tuk say dem catch am on November 22, 2025, for […]

todayJanuary 7, 2026 2

National

Police Confamate Release of Six Vigilantes Wey Army Arrest For Edo

By: Esther Ayoola Kwara State Police Command show workings confamate say dem don receive and later release six vigilante members wey Nigerian Army arrest earlier for Edo State. Police tuk say soldiers stop di vigilantes for Auchi–Ikpeshi Road for Akoko-Edo LGA for early December 2025 as dem dey travel inside motor wey belong to Ifelodun Local Government for Kwara State. According to police statement wey come out on Tuesday 6th […]

todayJanuary 7, 2026 1

National

Atiku No Go Step Down, Drag Tinubu

By: Esther Ayoola Former Vice Presido Atiku Abubakar don tuk say e no go step down for African Democratic Congress (ADC) presidential race. E still accuse President Bola Tinubu say dey try put hand for opposition matter. Atiku, through im media adviser Paul Ibe, call Nigerians make dem no allow All Progressives Congress (APC) scare or weaken opposition. Dis tuk come as people dey speculate say Atiku dey under pressure […]

todayJanuary 7, 2026 15

National

NiMET Share Update Say Haze, Sun And Thunder Go Hit Nigeria This Week

By: Esther Ayoola Di Nigerian Meteorological Agency (NiMet) don yarn say from Wednesday reach Friday, plenty haze and sunshine go dey across Nigeria. NiMet tuk dis on Tuesday for Abuja. For north, sky go dey sunny and hazy every day, while for south, sky go dey sunny with small clouds. NIMet also tuk say small chances of thunderstorm and light rain fit happen for Bayelsa, Rivers, Akwa Ibom, and Cross […]

todayJanuary 7, 2026 1

National

FG Sukili N1.98tn For Electricity Subsidy

By: Esther Ayoola Based on wetin di Nigerian Electricity Regulatory Commission (NERC) report tuk, di Federal Government don spend N1.98tn for electricity subsidy from October 2024 reach September 2025. For di fourth quarter of 2024, dem spend N471.69bn, first quarter of 2025 na N536.4bn, second quarter N514.35bn, and third quarter N458.75bn. NERC tuk say dis subsidy na because electricity tariffs never reach cost-reflective level, so gornment gatz cover di gap. […]

todayJanuary 7, 2026 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app