News-edi 1

1360 Results / Page 10 of 152

Background

Local

First Lady Welcome Nigeria First Pikins dem for 2026

By Ebi Oboko First Lady of Nigeria, Senator Oluremi Tinubu, don welcome Nigeria first pikin of the year, baby girl Enekole Zion Adakole, wey born exactly 12:00 midnight for FMC Jabi, Abuja, January first. The baby mama na 26-year-old first-time mother, Omeyi Patience Adakole, with her husband Celestine Adakole, as Madam First Lady present official birth certificate from National Population Commission give the newborn. She also celebrate Blessing Oragwu wey […]

todayJanuary 2, 2026 2

Lagos

Police Kramp Anthony Joshua Driver For Driving Wawa

By Ebi Oboko Ogun State Police don confamate say dem don arrest the driver of the Lexus SUV wey get accident wey kill di two frens of former boxing champion Anthony Joshua. The accident happen on Monday for Lagos-Ibadan Expressway as the vehicle jam stationary truck, kill Latif Ayodele and Sina Ghami on the spot, while Joshua and the driver get minor injuries. Police PRO Oluseyi Babaseyi talk say investigation […]

todayJanuary 2, 2026 5

Sports

AFCON Wahala: Gabon Ban Aubameyang, Manga, Suspend National Team

By Ebi Oboko Gabon sports minister don ban veteran players Pierre-Emerick Aubameyang and Bruno Ecuele Manga, suspend the whole national team, and sack the coaching staff after dem shameful AFCON performance. Dem lose 3-2 to Ivory Coast because Bazoumana Toure score injury-time winner. Gabon con finish last for Group F after dem lose all three matches, even pass Mozambique. Minister Simplice-Desire Mamboula talk say government no go allow Panthers play […]

todayJanuary 1, 2026 17

Lagos

New Year Fire Scarra Four Shops for Ikotun, Lagos

By Ebi Oboko Unto 2026 new year  day  updates, Say Four electronics shops for one building wey nia Transport Company for Ikotun, Lagos, don burn down early mormor for New Year Day. According to report Everything for di shops, including washing machines, TVs and generators, don destroy. Di cause of di fire, nobodi know, but people dey suspect say na faulty electric circuit. And as the time Konfam news package […]

todayJanuary 1, 2026 8

Local

ADC Disown Obi Say Im Registration No Follow

By Ebi Oboko One faction of the African Democratic Congress (ADC), wey Nafiu Gombe dey lead, don reject Peter Obi. Ontop yrnings with tori pipo,  the ADC faction talk say Obi no follow correct procedure when e register for the party for Enugu. Di faction call demself di real leaders of ADC. U sabi say   Obi announce dat,  im ma don join ADC for event wey hold for Nike Lake […]

todayJanuary 1, 2026 5

National

Senate Presido, Akpabio Repent Sake Of New Year Mass Message Wey Touch Im Heart

By Ebi Oboko Wi oga Senate Presido, Senator Godswill Akpabio, in the spirit of the new year don tell him lawyers make dem withdraw all di defamation cases wey e get against some people for inside the obodo naija. Akpabio speak on Thursday for Sacred Heart Parish, Uyo, say e get almost nine cases for court against people wey e accuse of defaming am. E explain say e hear di […]

todayJanuary 1, 2026 6

Lagos

Lagos APC Yansay Dia Full Support For Tinubu New Year Reforms

By Ebi Oboko Lagos State All Progressives Congress, APC,  tuk tuk, Hon. Seye Oladejo, don tuk again oh, say the party dey fully support oga  Presido, Bola Tinubu New Year message and reforms. According to Oladejo, through one official statement, say because dem believe say Tinubu dey take hard but necessary decisions to fix Nigeria, dem go support am beta style. Oladejo say for Lagos, APC see signs dat economy […]

todayJanuary 1, 2026 10 1

obodo oyinbo

Russia Accuse Kyiv Say Dem Do New Year Drone Attack For Moscow

By Ebi Oboko Russia don go put  accuse for  Kyiv head say dem  jet li drone attack wey kill at least 20 people for hotel for Moscow-controlled part of Kherson, Ukraine, for new year day. Vladimir Saldo, wey be Russia-appointed governor for Kherson, talk say three drones hit cafe and hotel wey people dey celebrate New Year. Russia Investigative Committee don open probe into di attack, wey still wunjor plenty […]

todayJanuary 1, 2026 3

Sports

Chelsea Fc sharpaly turn Maresca to EX

By Ebi Oboko Chelsea Football Club don announce say dem and dia  head coach Enzo Maresca don agree to part ways on Thursday. During him time, Maresca lead Chelsea win UEFA Conference League and FIFA Club World Cup. Club tuk say di decision follow dia ongoing plans and ambitions for the team. Chelsea thank Maresca for im contribution and say im achievements go remain important part of the club history.

todayJanuary 1, 2026 8 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app