News-edi 1

1461 Results / Page 10 of 163

Background

obodo oyinbo

Trump Set Up Board Of Peace For Davos Summit

By: Rilwan Agbomeji US Presido Donald Trump don launch im new Board of Peace for Davos with $1 billion membership fee Leaders from 19 countries, including Trump padi dem from Argentina and Hungary, sign di founding charter. Board suppose dey manage Gaza peace, but e fit settle oda international wahala too, wey dey make people fear say e wan compete with UN.

todayJanuary 22, 2026 8

Sports

Osimhen Dey Call Lookman, Onyedika Make Dem Join Am For Galatasaray

By: Rilwan Agbomeji Galatasaray and Super eagles Striker, Victor Osimhen don yarn say e dey try make im Super Eagles padi, Ademola Lookman and Raphael Onyedika, join am for Galatasaray. Di Naija striker talk dis afta Galatasaray draw 1-1 with Atletico Madrid for UEFA Champions League match wey happen on Tuesday night for Rams Park. Osimhen yarn say e dey work actively to bring Onyedika and Lookman enter im team, […]

todayJanuary 22, 2026 20 2

Entertainment

DNA Clear Davido For Pikin Wahala – Im Papa Talk

By: Rilwan Agbomeji Dr. Deji Adeleke, wey be papa of Afrobeats star Davido, don yarn say DNA test don show say im pikin no be papa of one girl wey dem dey call Aanu. Di mata don dey gbege before, but Dr. Adeleke yarn am for journalists for im Lagos house on Wednesday. Im talk say di DNA test wey hospitals for Lagos do show say di girl no be […]

todayJanuary 22, 2026 16 1

Lagos

Lagos Govment Tell Obalende Bridge Squatters To Comot

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Govment don give squatters wey dey under Obalende bridge small small time make dem comot as dem wan beautify di place. Untop yarnings with tori pipo yesterday, Commissioner for Environment, Tokunbo Wahab, talk say dem don dey tell dem since 2024, and enforcement officers dey ground to carry out di quick notice. According to report Gornment wan hand over di space to company wey wan […]

todayJanuary 22, 2026 9 1

OBODO NAIJA

NAFDAC Start Work On Top Sachet Alcohol Ban

By: Rilwan Agbomeji Di National Agency for Food and Drug Administration and Control, NAFDAC, don begin to enforce di ban on production and sale of alcohol for sachet and small PET bottle wey no reach 200ml. Director-General of NAFDAC, Prof. Mojisola Adeyeye, talk am for media briefing for Lagos, say Senate don give dem final order to go ahead. She say although Federal Govment bin say make dem pause di […]

todayJanuary 22, 2026 6

OBODO NAIJA

APC Declare Say Tinubu Dey Set For Second Term

By: Rilwan Agbomeji Di National Chairmo of di All Progressives Congress, Prof. Nentawe Yilwatda, on Wednesday don enter area for Abuja dey canvas for Northern support Presido Bola Tinubu second term. Untop yanings for Northern leaders meeting for Abuja yesterday, Yilwatda declare say President Tinubu dey well for second term because of youth support, good policies, party growth, and organized mobilization wey dey di APC. Party leaders for Abuja still […]

todayJanuary 22, 2026 6

OBODO NAIJA

CJ Kekere-Ekun Yarn Why Courts Gats Enter Digital Levels

By: Rilwan Agbomeji Chief Justice of Nigeria, Justice Kudirat Kekere-Ekun, don tell court registrars make dem embrace technology and court automation so justice go dey faster, clearer and easier for people to access. She talk dis one for 2026 Strategic Retreat of Chief Registrars on Wednesday for Abuja, say judiciary dey face plenty cases, higher public expectations and fast technology changes. According to her, if court administration weak, justice go […]

todayJanuary 22, 2026 6

OBODO NAIJA

FG Draw Red Card For Corruption Wey Dey Nigerian Universities

By: Rilwan Agbomeji Federal Govment don declare war against corruption and impunity for Nigeria tertiary institutions, say any university lecturer wey dem catch go face di musik. Minister of Education, Dr Maruf Alausa, yarn dis one for Abuja during retreat for polytechnic and college heads, say govment no go tolerate money mismanagement, abuse of office and any unethical behaviour again. E say from now, transparency, accountability, timely audit and zero […]

todayJanuary 22, 2026 6

obodo oyinbo

President Trump Drop Plan To Take Over Greenland

By: Rilwan Agbomeji US Presido, Donald Trump don comot im threat to put tax for European countries wey no like im plan to take over Greenland. E tuk dis one yesterday for Davos wia im hold meeting with leaders for Europe, say e no go use force take di land again, and im dey try do deal wit NATO Secretary-General Mark Rutte. Trump talk say if dem fit agree, e […]

todayJanuary 22, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app