News-edi 1

2592 Results / Page 9 of 288

Background

obodo oyinbo

China Ready To Protect Iran Rights

China Foreign Minister, Wang Yi, say Beijing ready to hellep protect Iran rights as e meet Iran Foreign Minister, Abbas Araghchi, on Wednesday for China. Wang say China ready to tok and work with Iran and make sure say Iran legitimate right dey protected. Di meeting come as China dey try help find way to settle di war between Iran and America. Di talks happen one week before China Presido, […]

todaySeptember 17, 2026 10

OBODO NAIJA

Federal Gorment Hellep Workers As Petrol Price Dey Rise – NLC

Nigeria Labour Congress (NLC), don call on Federal Gornment to quickly bring measures wey go reduce di suffering wey rising petrol price dey cause. NLC Presido, Joe Ajaero, tok for statement on Wednesday say petrol don reach about ₦1,430 per litre for major cities, while di price fit dey higher for places wey hard to reach. Labour warn say di petrol price increase go make economic hardship worse, as transport […]

todaySeptember 17, 2026 8

OBODO NAIJA

Only Six Northern Gofnors Support Tinubu For 2023 – Shettima

Vice Presido, Kashim Shettima don reveal on Wednesday say na only six out of 19 northern Gofnors support President Bola Tinubu presidential ambition for di 2023 election. Shettima talk dis one for di palace of Emir of Ilorin, Alhaji Ibrahim Sulu-Gambari, during di turbaning of Kwara Gofnor, AbdulRahman AbdulRazaq, as Sardauna of Ilorin Emirate. E say di tension wey follow di 2023 presidential campaign and election dey very clear, and […]

todaySeptember 17, 2026 15

Lagos

Nobody Kpai For Di Askident Wey Happun For Otedola Bridge

Di Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) don rescue everybody wey involve for di serious askident  wey happen for Otedola Bridge, inward Berger, on Wednesday afternoon, as nobody kpai for di askident. Na two trucks, one trailer, one white Honda car and one Lexus dey involved for di askident as initial check show say one container truck develop mechanical problem as e dey move, di driver kon lose control, jam […]

todaySeptember 17, 2026 12

Education

Must Read: How School Pressure Fit Affect Students

Behind some of di best results na students wey dey fight battles nobody know about. By Kofoworola Olayinka Around 2:00a.m, Oyinkansola close her textbook, just dey look ceiling. For almost thirty minutes, she don dey read di same page, but di words wey dey in front of her eyes no longer dey enter her head, her examination timetable dey hang for wall, three days remain for her hardest paper, and […]

todaySeptember 14, 2026 63 152 2

Lagos

Woman Don Enter Prison For Throway Dirty For Gutter

By : Jolayemi Olajide A 53-year-old woman, Nelly Monday, don get one month prison sentence for throwing dirty inside gutter for Lagos. Dem arrest her for Meiran on Wednesday, September 9, 2026, after dem say she throway dirty for gutter while rain dey fall. Dem carry her go Magistrate Court for Bolade, Oshodi, where she plead guilty to wetin she do. Di court later find her guilty and sentence her […]

todaySeptember 11, 2026 14

obodo oyinbo

National Assembly Don Stop Trips Go South Africa

By : Jolayemi Olajide National Assembly don tell senators, members and workers make dem no travel go South Africa for official work until further notice. Dem also say make nobody from National Assembly join any meeting or programme wey South Africa organise for lawmakers. House of Representatives spokesman, Akin Rotimi, talk say dem take dis decision because of reports say Nigerians and other Africans still dey face attack and serious […]

todaySeptember 11, 2026 9

Education

FG Wan Train 250,000 Teachers Wey No Get Teaching Qualification

By : Jolayemi Olajide Federal Government don plan to train 250,000 teachers wey dey teach for schools but no get proper teaching qualification, and di six-month training go start for October 2026. Di training go help dem get certificate to show say dem qualify to teach, but dem no need stop work or comot from classroom while dem dey do am. Teachers wey study university course wey no be education […]

todaySeptember 11, 2026 11

Entertainment

Carter Efe Vow Say E Go Beat Speed Darlington For Ring

Nigerian content creator Carter Efe don vow say e go beat entertainer Speed Darlington when dem enter ring on October 1, tok say na because Speed dey talk about Burna Boy anyhow. Carter tok dis one for heated face-off with Speed ahead of dia celebrity boxing fight wey go hold for Federal Palace Hotel, Lagos. For di face-off, Speed Darlington tell Carter say na beating e go use beat am, […]

todaySeptember 11, 2026 13 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds