News-edi 1

2502 Results / Page 12 of 278

Background

OBODO NAIJA

Govo Aiyedatiwa Beg Politicians Make Dem Give Women More Political Positions

Ondo State Govo, Lucky Aiyedatiwa, don call on politicians across Nigeria make dem give more women chance for political and elective positions. Aiyedatiwa tok dis one on Wednesday during di launch of di 774 Explode Project for Akure, Ondo State capital. E say women dey important to national development and add say im administration dey run government wey include everybody, both men and women. Dis 774 explode project na women […]

todayJuly 30, 2026 22

OBODO NAIJA

Oshiomhole Blast Umahi On Top Bad Federal Roads

Senator wey dey represent Edo North, Adams Oshiomhole, don blast Minister of Works, Dave Umahi, say e dey rush start new road projects while plenty old roads still dey bad condition. Oshiomhole tok dis one for Senate on Wednesday, as e point say road wey connect Edo and some Delta cities still dey poor shape. E say di way Umahi dey share road projects no balance and e fit make […]

todayJuly 30, 2026 15

Lagos

Adedeji Omope Promise More Development For Bariga

Bariga LCDA Chairman, Adedeji Omope, don promise more infrastructure, youth empowerment and social programmes for residents. Omope make di promise as Bariga LCDA celebrate her first anniversary in office on Wednesday. During di celebration, more than 2,000 residents receive bags of rice to help reduce di effect of economic hardship. She thank residents for dia support and say di achievements come through teamwork between government and di pipo.

todayJuly 30, 2026 17

Sports

Tobi Amusan Eye Third Commonwealth Games Gold

Nigeria star athlete, Tobi Amusan, go start her fight for third straight Commonwealth Games gold medal today for women 100 metres hurdles for Glasgow, Scotland. Di world record holder and defending champion go run for di first heat against athletes from Ghana, Canada, Jamaica and other countries. Di qualifying race go start by 11:30 dis morning, while di final go happen by 9:49 tonight for Scotstoun Stadium. Amusan, wey don […]

todayJuly 30, 2026 16

obodo oyinbo

Russia Missile Attack Kpai One Pesin for Kyiv

Ukraine officials say at least one pesin kpai after Russia launch missile attack early Thursday morning for Kyiv, Ukraine capital. Say na so everything spoil for di city sote Mayor, Vitali Klitschko con tell residents make dem run enter shelter for safety. Poland Armed Forces say dem quickly send fighter jets protect dia airspace because di Russian air strikes happen close to dia border, while rescue workers rush go affected […]

todayJuly 30, 2026 13

OBODO NAIJA

Head of Civil Service Konfam Say Fake Agency DG Documents Na Scam

House of Representatives committee chairmo, Yusuf Gagdi, don tok say investigation don show say di appointment letter wey Director-General Adeyemi present na fake, and even di law wey e use support am na forged document. Gagdi tuk dis for Abuja on Wednesday, as Head of Civil Service of di Federation, Didi Esther Walson-Jack, appear before di committee for di second time and confirm say di documents no be original. Walson-Jack […]

todayJuly 30, 2026 17

Lagos

Police Gbab Suspected Armed Robber for Lagos

Lagos State Police Command don arrest one 29-year-old man wey dem suspect say na armed robber during routine patrol on Wednesday for Igando area of Lagos. Police tuk, tuk person, SP Abimbola Adebisi, naim konfamate dis one say officers sight three men wey dey ride one motorcycle and dey behave funny and na so dem take follow dem up. She say as di suspects see police, dem try run, but […]

todayJuly 30, 2026 40 1

obodo oyinbo

Europe Dey Feel Di Heat As Wildfire Spread

European Union don call for stronger action against climate change as fresh heatwave dey threaten France, Spain and other European countries with more wildfires. EU Crisis Management Commissioner, Hadja Lahbib, say Europe must invest more in climate action, forest management and disaster preparedness as global warming dey get worse. So far, more than 330,000 people don run from their homes, with about 220,000 evacuated in France and 110,000 in Spain […]

todayJuly 29, 2026 16

OBODO NAIJA

Reps Committee Reopen Investigation On Top Presidential Council Marras

House of Representatives ad hoc committee again don open mata to touch light every every unto wetin sup  into di alleged operation of di disputed Presidential Foreign Intervention Promotion Council. Di committee like dis dey ask di self-acclaimed Director-General of the council, Adeniyi Adeyemi, thick thick question and dem con finally konfam say di appoint letter na fake. Head of di  Civil Service of di Federation, Didi Esther Walson-Jack, and […]

todayJuly 29, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds