News-edi 1

2502 Results / Page 15 of 278

Background

OBODO NAIJA

Police burst pipeline vandal syndicate, arrest seven suspects for Adamawa

By : Jolayemi Olajide Police don arrest seven people wey dey vandalise NNPC pipelines for Adamawa State. Police tok for statement on Wednesday say officers recover 285 pieces of vandalised pipelines during di operation. Police say dem stop one J5 bus wey carry di pipelines for Yola-Numan Road after intelligence report. Investigation still dey continue as police dey find other people wey join for di crime.  

todayJuly 22, 2026 10

OBODO NAIJA

ICPC uncover 908 ghost workers, recover N942 million

By : Jolayemi Olajide ICPC don uncover 908 ghost workers for over 50 federal MDAs and recover about N942 million wey dem allegedly pay through fake salary scheme after investigation begin for 2024. ICPC Chairman Musa Aliyu siddun tuk say di probe start after commission notice mago mago for pension payments and expose payroll fraud. Aliyu allege say some senior public officials put dia relatives and associates for government payroll […]

todayJuly 22, 2026 13

OBODO NAIJA

Boko Haram release obituary for media operative wey soldiers kill

By : Jolayemi Olajide Boko Haram don release obituary video for dia media operative, Abu Salim al-Barnawi, wey Nigerian troops kill during failed attack on military base for Borno State last week. Operation HADIN KAI Acting Media Information Officer, Captain Mohammed Goni, siddun tuk on Wednesday say terrorists lose dia cameraman during di fierce battle for Lake Chad Basin. According to Goni, al-Barnawi bin dey lead attacks into Cameroon before […]

todayJuly 22, 2026 12

Sport Yarns

FIFA say stability fit carry Super Eagles to 2030 World Cup

By: Jolayemi Olajide FIFA don siddun tuk say Nigeria get everything wey e need to qualify for di 2030 FIFA World Cup, but say stability go decide whether Super Eagles go make am. Di world football body say although Nigeria get plenty talented players, success for di next qualifiers go depend more on stable planning than ability. Super Eagles miss di last two World Cups after dia 2026 qualification campaign […]

todayJuly 22, 2026 9

OBODO NAIJA

Fake doctor wey collect N500,000 for fake UCTH job don land police net

By : Jolayemi Olajide Cross River Police don arrest 39-year-old Udeme Emmanuel Ekpeme for allegedly posing as medical doctor and collecting N500,000 from one woman to help her children get job for UCTH after she report di matter. Police tuk, tuk, ASP Sunday Eitokpah, put for statement on Tuesday for Calabar say di suspect deceive di woman by claiming say e be doctor and fit arrange di jobs. Police say […]

todayJuly 22, 2026 11

obodo oyinbo

Fresh US attack make Tehran air defence spring into action

By : Jolayemi Olajide Fresh US strikes don trigger air defence for Tehran on Wednesday after President Donald Trump warn say e never finish with di war against Iran. US forces attack military logistics targets across Iran after fighting around Strait of Hormuz scatter earlier peace agreement and make di Middle East conflict worse. US top diplomat Marco Rubio, wey speak for ministers meeting for Manila, say America still ready […]

todayJuly 22, 2026 13

obodo oyinbo

Traore warn say nobody fit challenge im power for Burkina Faso

By : Jolayemi Olajide Burkina Faso military leader Ibrahim Traore don warn say nobody fit lead di country apart from am, as e dismiss rumour of power struggle inside di junta on Thursday for Ouahigouya. Traore tok dis for news statement say "two capons nor fit dey for di same boat. According to Traore, any person wey im go catch do nonsense go face di music. Rumours of infighting start […]

todayJuly 22, 2026 13

Entertainment

Mo Bimpe threaten legal action over fake paternity rumour

By : Jolayemi Olajide Nollywood actress Mo Bimpe don threaten legal action after one X user post fake claim on Tuesday say her husband, Lateef Adedimeji, file for divorce over alleged paternity issue. Di X user allege say hospital reject Lateef blood donation for one of dia triplets before DNA test supposedly show say e no be di biological father. Mo Bimpe react for her Instagram Story, describe di report […]

todayJuly 22, 2026 15

Entertainment

Falz clear air say e never support any politician 

By : Jolayemi Olajide Nigerian rapper Falz don clear di air on Tuesday say e never openly support Peter Obi or any politician, as e yarn for siddun tuk. Falz say people get am wrong because all along na to encourage Nigerians, especially youths, make dem come out vote naim e dey do. Di singer explain say e believe for free and fair elections and no wan tie himself to […]

todayJuly 22, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds