News-edi 1

1452 Results / Page 2 of 162

Background

Lagos

Sanwo-Olu Hail Disu As E Become Acting IGP

Lagos state govo, Babajide Sanwo-Olu don hail Olatunji Disu as President Bola Tinubu appoint am Acting IGP for Nigeria Police Force. Sanwo-Olu talk say Disu deserve di work because im don serve police with strong mind, professionalism, and over 30 years oga-level experience. E still yarn say Disu be seasoned officer wey don show leadership for different serious police assignments before and e sure say Disu go perform well for […]

todayFebruary 26, 2026 3

Uncategorized

Lagos First Lady, Ibijoke Gather Boys To Stop Yahoo

Wife of di Lagos State Govo, Ibijoke Sanwo-Olu,  don advice young boys for Lagos make dem comot body from cybercrime, say na bad character bi dat. She yarn dis one for the Lagos Boy Child Initiative Residential Workshop wey happen for St. Gregory’s College, say boys must use social media for good and no allow peer pressure push dem enter bad tin. According to her, too much exposure to digital […]

todayFebruary 26, 2026 4

OBODO NAIJA

How FG Package Kano Market Fire Victims With 5 Billion Naira  

Vice President, Senator Kashim Shettima, don throw mouth say Federal Gornment go join hand with Kano State Gornment and other agencies to stop fire disaster for markets. Shettima give dis assurance for Abuja when leaders of Association of Kano Business Community, led by Presido Alhaji Sabiu Bako, visit am for Presidential Villa to thank am for di support. Oga vice presdo explain dat Federal Ministry of Humanitarian Affairs don complete […]

todayFebruary 26, 2026 3

OBODO NAIJA

New Police Oga Disu Vow To End Corruption And Oppression

President Bola Tinubu don officially decorate new Acting Inspector-General of Police, Tunji Disu, for State House, Abuja, on Wednesday. After di ceremony, Disu tell tori pipo how matas go dey go moving foward say, im go stop impunity for Nigeria Police Force, promise to end corruption and human rights abuse. Oga Disu make clear say di kontri na every get am and not just political leaders or police.

todayFebruary 26, 2026 5

obodo oyinbo

Iran, US Gather For Third Round Of Nuclear Talk For Switzerland

Say Iran and US go start third round of nuclear tuk for Switzerland,  an according to report both of dem still dey look for diplomatic solution. Iran Foreign Minister Abbas Araghchi reach Geneva on Wednesday, meet im Omani counterpart wey dey hellep arrange di tuk. Araghchi say dem fit reach  fair and balanced deal afta di meeting, but Iran nor wan give up right to use nuclear technology peacefully. Say […]

todayFebruary 26, 2026 3

Sports

D’Tigress Drop Provisional Squad for Women’s World Cup Qualifiers

Nigeria seven-time African champions, D’Tigress, don announce dia provisional squad for FIBA Women’s Basketball World Cup Qualifying Tournament wey go hold for Lyon, France from 11–17 March 2026. Coach Rena Wakama pick mix of experience players and new talents wey go face France, Germany, South Korea, Colombia and Philippines. Big names like Amy Okonkwo, Sarah Ogoke, Promise Amukamara and Ezinne Kalu dey lead di team, plus young guns like Pius […]

todayFebruary 26, 2026 5

obodo oyinbo

Underage Pikin Dem Full Instagram – Zuckerberg Yarn

Meta oga Mark Zuckerberg don bow head small, talk say dem slow well-well to fish out underage pikin wey full Instagram, as e stand trial for California. Families for America dey accuse Meta say dem knowingly hook children and no block those under 13 sharp sharp. Zuckerberg admit say dem don upgrade dia system, but confess say dem for move faster pass wetin dem do. Na im be di hottest […]

todayFebruary 19, 2026 4

OBODO NAIJA

Every Vote Go Count – Akpabio

Senate Presido, Godswill Akpabio don yarn say di new Amendment Electoral Act 2026 wey Presido Bola Tinubu sign go make every Nigerian vote matter. Akpabio talk say di law go stop di gbege wey dey happen when results dey waka from polling units go collation centres. E still yarn say e go fix di wahala wey Nigerians dey fear about election palava, make future elections clean and correct, say Nigerians […]

todayFebruary 19, 2026 8 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app