News-edi 1

1354 Results / Page 2 of 151

Background

Lagos

Lagos Gorment Release Plan For Waterside Business

By Ebi Oboko Lagos State  gorment don release new plan say, dem wan turn all   watersides for  di state to beta business wey go bring state  money. Based on yanings with tori pipo,  Di  Commissioner for Waterfront Infrastructure Development, Dayo Alebiosu, tuk say, dis new policy go hapun dis  2026 and say, e show beta workings for  2025. Before now, say  people dey buy land dem for di waterside, dem […]

todayJanuary 12, 2026 5 4

National

Wike Challenge Haters to Tell Tinubu to Sack Am

By Ebi Oboko FCT Minister, don tell im haters say make dem dey dia dey,  say, na only President Bola Tinubu get power to sack am from im cabinet, not people wey dey criticize am. Di minister yarn this one on Sunday when e go Obio/Akpor LGA for Rivers State for the last part of im “thank you” visit. Wike say if Tinubu feel say e no get anything to […]

todayJanuary 12, 2026 5

foreign

Iran Presido, Pezeshkian Promise to Listen to Protesters

By Ebi Oboko Iran presido, Masoud Pezeshkian, don bow to pressure,   say  dem go  rearrange di iran economy wey dem spoil, dey warn protesters to be calming down. Pezeshkian dey beg for tv sit don tuk, say make di protesters nor go do until  “rioters” and “terrorist elements”  con take over di mata, say dat one  go be big  wahala. The protest don enter third week after market people for […]

todayJanuary 12, 2026 5

Sports

El Clasico Final: Barcelona Conquer Real Madrid 3-2

By Ebi Oboko Barcelona don go beat  Real Madrid 3-2 for El Clasico for Spain Super Cup final for Saudi Arabia, ni dem run dis one. Raphinha shine shine bobo, score two goals for  di Catalan side. Barcelona  wey dey top La Liga  qualify for di final afta dem hammer Real Betis 5-0 for semifinal. Real Madrid beat Atletico 2-1 for di second semifinal before dis final. Last year, Barcelona […]

todayJanuary 12, 2026 8 5

Sports

Super Eagles To Buy Waka To Rabat For AFCON Semis

By Ebi Oboko Unto update for AFCON, say Super Eagles go waka from Fes go Rabat on Monday afternoon for dia semi-final match wey dem go play against AFCON 2025 host Morocco. Team media officer Promise Efoghe na im yan one. On Sunday, Super Eagles don return Fes and dem do recovery session by 6:15pm for Saardienne football complex. Now, all the players and officials go travel to Rabat,  ready […]

todayJanuary 12, 2026 8 2

Lagos

Lagos State Varsity Don Open Job Recruitment For Students

By: Rilwan Agbomeji Lagos State University (LASU) don start recruit students enter LASU Cadet Corps, as dem officially announce am for X dis week. Di programme na student-focused paramilitary and leadership training, wey go help build discipline, patriotism, teamwork and leadership skills among undergraduates. How e go work be say cadets go also help with campus security, orderliness and official school events inside LASU. So if you be student wey […]

todayJanuary 9, 2026 6

Sports

CAF Comot Referee For Super Eagles Match Against Algeria

By: Rilwan Agbomeji CAF don comot Somali referee Omar Abdulkadir Artan from handling Super Eagles vs Algeria quarter-final for AFCON 2025, wey go happen Saturday for Grand Stade de Marrakech. Na because dem catch am say e wear boot brand wey no dey approved by official sponsors for one earlier match, and that one break CAF rule. Even though na di same man wey win Referee of di Year for […]

todayJanuary 9, 2026 7

Sports

Mahrez Yarn Say E No Fear Super Eagles Attack At All

By: Rilwan Agbomeji Algeria captain Riyad Mahrez don talk say e no dey fear  Super Eagles attack at all at all, ahead of Nigeria vs Algeria quarter-final for AFCON 2025 dis Saturday. Di Desert Foxes and Super Eagles go meet again for anoda big rivalry match as dem both enter knockout stage unbeaten. Nigeria don score 12 goals so far, pass any oda team for di tournament, but Mahrez still […]

todayJanuary 9, 2026 10 2

National

INEC Open Phase Two For Voter Registration For Lagos

By: Rilwan Agbomeji Di Independent National Electoral Commission (INEC) don drop message for all Lagosian phone, wey never register with INEC, to go do dia voter registration. Resident Electoral Commissioner (REC) for Lagos, Ayobami Salami, ni on di message on Thursday. Say, Di first phase of voter registration end December 10, 2025, but di second phase don start since January 5, 2026, and dey happen for all local government areas […]

todayJanuary 8, 2026 12 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app