News-edi 1

2592 Results / Page 4 of 288

Background

OBODO NAIJA

20 NYSC Members Wey Kidnapers Carry Don Get Dia Freedom

By: Mariam Ajayi Twenty NYSC members wey kidnappers carry for Imo State don regain dia freedom after seven days for captivity. Police Force Public Relations Officer, CSP Anietie Iniedu, konfamate dia release on Wednesday, say dem rescue di victims safely. Police, Army, DSS and oda security agencies join hand for di rescue, as authorities don take di victims go hospital for medical check-up and treatment.

todayOctober 8, 2026 6

Lagos

ADC Candidate Clear Community NEPA Bill For Residents

By: Mariam Ajayi ADC candidate for Eti-Osa Constituency II, Ayodele Adio, don clear  NEPA bills wey pipo owe for one community wey no get light tey tey. Adio make di move during im visit with community leaders and NEPA officials on Wednesday, as residents celebrate when power return to di community. But residents later complain say light don go off again after one alleged instruction to NEPA to disconnect am, […]

todayOctober 8, 2026 9

Lagos

Sanwo-Olu Tell Nigerians Make Dem Unite and Love Nigeria

Lagos Govo, Babajide Sanwo-Olu, don call on Nigerians to come together, love dia country and play dia part as Nigeria dey celebrate 66th Independence anniversary. Sanwo-Olu, wey be Chairman of South-West Governors’ Forum, tell Nigerians, especially Lagosians, make dem learn from di strength and determination of di pipu wey fight for Nigeria independence and help build better country. Di Govo tok dis one for Independence Day message wey im Special […]

todayOctober 1, 2026 11

OBODO NAIJA

NLC Tell Gornment Say Make Dem Bring Fuel Price Down

Nigeria Labour Congress, NLC, don call on gornment to reduce petrol price, pay workers nationwide wage award and start fresh toks on new minimum wage, as Nigerians dey struggle to survive under high cost of living. For Independence Day statement wey dia Presido, Joe Ajaero, sign on Wednesday, di union tok say workers and ordinary Nigerians don dey suffer under high transport fare, food price, house rent and school fees. […]

todayOctober 1, 2026 9

OBODO NAIJA

I Go Resign If Tinubu Lose for Rivers, FCT – Wike

Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, don vow say e go resign from im position as minister if Presido Bola Tinubu lose di 2027 presidential election for Rivers State and FCT. Wike make dis statement during meeting with leaders and members of Apo Mechanics and Traders Association for Abuja, as e say im stay for Tinubu cabinet depend on whether e fit deliver electoral victory for di Presido. […]

todayOctober 1, 2026 11

obodo oyinbo

Plane Almost Crash For Dubai

Israeli leaders on Wednesday say one pilot wey dem describe as “jihadist” try to crash a flydubai plane wey carry mostly Israeli passengers, but some passengers overpower am and stop wetin fit cause big disaster. Prime Minister Benjamin Netanyahu say as di plane dey near Israel, one of di pilots stab di other pilot and apparently try to crash di plane with everybody wey dey inside. Netanyahu say one Israeli […]

todayOctober 1, 2026 10

Sports

Ronaldo Comot From Portugal Camp, Return Madrid

Cristiano Ronaldo don return Madrid after e announce say e don comot from Portugal national team camp on Wednesday. Football transfer expert, Fabrizio Romano, disclose dis one for im post on X, as Ronaldo land for Madrid around 2 a.m. local time after e officially withdraw from di Portugal squad. Di Al-Nassr striker reportedly decide to leave di camp after e discuss with Pedro Proença, President of Portuguese Football Federation, […]

todayOctober 1, 2026 14

Lagos

How Lagosians Take Fall Hand Rush Beer After Road Askident

Kwake, dem say, problem everywia, na yesterday for Ajegunle, wia one beer truck don go get askident with one dispatch rider and two vehicles for Abalti Barracks, as bottles of beer scatter for road and commuters rush to pick dem dey drink. LASTMA officials na so dem enter di area dey form defend, dey defend beer wetin nor gud. According by di LASTMA tok, tok, Adebayo Taofeeq, say the truck […]

todaySeptember 30, 2026 18

OBODO NAIJA

Baba Presido Drop Hin Mouth Odour For 2027 Opposition

For di Bad belles and  opposition, ogbonge update oh, baba, aka Jagaban, President Bola Tinubu  just land Lagos yesterday  from  holiday, incase u dey think say senior man dey sick, as senior man say  hin don ready for di 2027 race, person wey leg nor strong comot body. Na so e tell all di news tatafos for airport, comot body, comot body, energy dey fully 100 percent. Baba seyi say […]

todaySeptember 30, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds