News-edi 1

2593 Results / Page 39 of 289

Background

OBODO NAIJA

Court Back David Mark As ADC Leader

Di Federal High Court for Abuja don back David Mark branch as di correct leader of di  opposition party, African Democratic Congress (ADC). Justice Musa Liman throway di case wey one House of Reps member, Leke Abejide, file, according to di court senior man, dem nor get power to put mouth for political party inside house wahala. Former Vice-President Atiku Abubakar don  hail dis judgment,  say di ruling na big […]

todayJuly 3, 2026 22

OBODO NAIJA

Kelechi Anosike Blast Govo Alex Otti

Govonorship candidate for Peoples Democratic Party (PDP) for Abia 2027 guber race, Kelechi Anosike, don blast  Governor Alex Otti administration, say he no dey show workings at all for matter wey concern pipo welfare. He fry mouth on top di matter for one press conference for Umuahia on Thursday, say many policies of di current government no dey touch di life of ordinary people for ground. Di PDP candidate spoil […]

todayJuly 2, 2026 23

Sports

Everywhere Choke As 2026 FIFA World Cup Round of 16 Dey Near

As e be like dis, na only 10 countries don already secure dia place for 2026 FIFA World Cup Round of 16, as di battle for di trophy dey hot. Di latest teams wey qualify na USA, England and Belgium as dem beat dia opponents yesterday. Di other teams wey don book dia tickets to di last 16 na France, Brazil, Norway, Morocco, Paraguay, Canada and Mexico. And later dis […]

todayJuly 2, 2026 16

obodo oyinbo

Gaza Mark 1,000 Days Of War Wahala As Over 73,000 Pipo Kpai

Gaza officials don announce say di war don clock 1,000 days, as over 90 percent of di territory don suffer serious damage from di fighting. Di Gaza Gornment Media Office talk on Thursday say Israeli forces now control about 80 percent of Gaza land. According to di latest figures from Gaza, at least 73,066 Palestinians don die since di war begin for October 2023. As di war continue, international organizations […]

todayJuly 2, 2026 16

OBODO NAIJA

FG Announce Big NYSC Reform Say Adire Go Replace Khaki Uniform

Federal Gornment don announce say dem dey plan for major changes for NYSC programme, and one of dia plan na to replace di traditional khaki uniform with locally made Adire material to support Naija economy. Na Minister of Youth Development, Ayodele Olawande, announce dis one for TV siddon tuk on Thursday, He tuk say di reform go ensure say corpers go receive postings wey match dia course of study. E […]

todayJuly 2, 2026 31

Lagos

LASEMA Yarn Say No Building Collapse For Alakija

Di Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) don officially clear bad air wey dey spread for social media say one building collapse for Alakija area. LASEMA Permanent Secretary, Dr. Olufemi Oke-Osanyintolu, konfamate dis for statement on Thursday say di report na lie and e dey mislead di public. Officials wey dem send to check di area after di news show face no find any evidence of any building collapse for […]

todayJuly 2, 2026 13

Lagos

Gbadebo Rhodes-Vivour Dey Prepare For 2027 Lagos Governorship Race

Gbadebo Rhodes-Vivour of di African Democratic Congress (ADC) don clear say him 2027 Lagos governorship ambition no depend on Peter Obi or di Obidient movement. Di politician tok dis one for one siddon tuk on Thursday, as e emphasize say e don dey build strong structure for grassroots communities. Rhodes-Vivour explain say e don work hard to connect with Lagos residents wey dey face challenges like demolition, and e believe […]

todayJuly 2, 2026 22

Sports

Belgium Shock Senegal with Late Comeback, Knock Senegal Comot 3-2

Nor be small drama, as Belgium complete one big comeback after beating Senegal 3-2 for extra time inside World Cup last-32 match wey happen for Seattle on Wednesday. Senegal bin dey lead 2-0 through Habib Diarra and Ismaila Sarr, but Romelu Lukaku and Youri Tielemans score late goals for di last four minutes to force extra time. For di 125th minute, VAR confirm penalty after Lamine Camara foul Tielemans, and […]

todayJuly 2, 2026 33 2

Economics

FG Promise To Tighten Security For Niger Delta To Push Oil Production Up

By : Jolayemi Olajide Di Federal Gornment don tuk am again say dem dey ready to wire security for Niger Delta so that Nigeria fit start to drill more crude oil. Di Minister of Defence, Christopher Musa, tuk dis one after one closed-door meeting with big stakeholders inside di oil and gas sector for Port Harcourt Barracks, Rivers State. Musa tell journalists say things like sea piracy and armed robbery […]

todayJuly 1, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds