News-edi 1

2593 Results / Page 55 of 289

Background

Politics

Court Order INEC to Wipe Out ADC, Four Other Parties From Election List

By : Jolayemi Olajide Federal High Court for Abuja don order make INEC deregister ADC and four other political parties say dem nor reach  meet constitutional requirements. Justice Peter Lifu give di judgment on Monday, say di parties no fit get di required 25 per cent votes for di last general elections. Di affected parties na ADC, Accord, Action Alliance, Action Pipos Party and Zenith Labour Party. Di court also […]

todayJune 15, 2026 14

Lagos

Lagos Agency Don Share N15bn to Small Businesses

By : Jolayemi Olajide Lagos State Employment Trust Fund don give about N15 billion loan support to 20,000 small businesses across the state. Executive Secretary, Feyisayo Alayande, tok dis one on Monday for Alausa, Ikeja, as she dey give report of wetin the agency don achieve for the last 10 years. According to am, LSETF intervention don help create more than 320,000 direct and indirect jobs through access to finance […]

todayJune 15, 2026 15

OBODO NAIJA

Delta Activist, Mulade Drag NDC Go Court, Demand ₦5 Billion Over 2027 Ticket

Nor be small gbege for Warri as Delta activist, Sherrif Mulade, don drag im party, Nigeria Democratic Congress (NDC), go court dey demand N5 billion damages. Mulade dey vex say di party leadership sharp-ally corner di Warri Federal Constituency primary ticket wey im win, con give am to another person because of money. Di senior man tuk say di party don abandon democracy sell the ticket to the highest bidder, […]

todayJune 15, 2026 15

Sports

Edo Queens Lift NWFL Title After Dem Hold Bayelsa Queens

Edo Queens don win Nigeria Women Football League (NWFL) 2025/26 title after dem draw goalless with Bayelsa Queens for final Super Six match for Port Harcourt. Di result give dem enough point to carry di trophy as dem already dey on nine points before the game and just need one point to seal am. Na coach Moses Aduku team second league title in three years, showing say dem still strong […]

todayJune 15, 2026 26 15

OBODO NAIJA

Warri Ijaw, Urhobo Cry Out, Tell INEC To Carryout Court Order

Ijaw and Urhobo pipo for Warri Federal Constituency don drop micro soft word to INEC to execute di Supreme Court order wey concern ward delineation report. Na leaders from both tribe tuk dis one for joint press conference wey happen for Warri on Sunday. Di meeting come after Abuja stakeholders session wey President Bola Tinubu arrange with dem. Dem also yarn say any further delay fit scatter di small peace […]

todayJune 15, 2026 21

National

Late General Rabe Family Kwanta with Kastina State Gorment

Con see problem oh, as pikin of late Major General, Rabe Abubakar (rtd), Isyaka Rabe,  don reject claim wey Katsina State Gornment tuk say im papa die from diabetes and hypertension. Im talk dis one for interview with news pipo, say kastina state gorment report nor correct, as im papa no get history of diabetes. Isyaka add say some pipo dey even tuk say na snake bite or heart attack, […]

todayJune 15, 2026 26 2

National

Umahi Defend FG Roads, Tinubu Highways Go Boost Economy

Minister of Works, David Umahi, don defend Federal Government road project spending, say President Bola Tinubu four legacy highways na important economic corridors. Im talk dis one during Renewed Hope Media Tour for Ndi-Egbe Bridge site for Afikpo, Ebonyi State, wey link Ebonyi to Cross River State. Umahi still talk say dem dey build wetin fit be di longest flyover for Africa near Dangote Refinery axis of Lagos-Calabar Coastal Highway […]

todayJune 15, 2026 18

Lagos

Lagos Residents Cry Out Say Dirty Dey Smell

Plenti residents for Ikotun, Idimu, Ejigbo and Egbeda area of Lagos don cry out say dirty dey smell dem despite gornment effort to clear waste. Lagos Waste Management Authority bin say dem remove 418,500 tonnes of dirty for across di state for May, wey average 13,200 tonnes every day. According to aproko pipo wey go touchlight one Industrial chemist, Harrison Chinaka, say dirty for Alimosho area dey wey fit cause […]

todayJune 15, 2026 17

Lagos

Lagos Barbar Pursue Guiness World Record

Say like dis Guinness world record, dey monitor one 24-year-old hairstylist, Ikechukwu Damilola wey dem dey call “Transformation King,” wey wan break world record, say im don reach 90 hours out of 120-hour to break Guinness World Record hairdressing marathon for Lagos. Di attempt dey happen for Oto-Awori Local Council Development Area for Ijanikin and GWR officials dey monitor am. Chairmo of di LCDA, Mr. Kareem Abiodun, talk say di […]

todayJune 15, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds