News-edi 1

2593 Results / Page 56 of 289

Background

Sports

Japan Snatch Late Draw As Dem Hold Netherlands

Japan show strong fighting spirit for di FIFA 2026 world cup, coming back twice to force Netherlands play 2-2 draw for dia openingĀ  match for Texas on Sunday. Netherlands captain Virgil van Dijk naim score first with fine header, but Keito Nakamura quickly equalise for Japan. Crysencio Summerville later put di Dutch ahead again with a beautiful goal after one hour of play. As Netherlands begin feel say dem don […]

todayJune 15, 2026 15

obodo oyinbo

US, Iran Finally Gree Peace Deal

United States and Iran don agree on peace deal and immediate stop to all military operations after more than three months of war for Middle East. Pakistan Prime Minister Shehbaz Sharif announce di agreement on Sunday, say official signing ceremony go hapun for Switzerland on June 19. US Presido Donald Trump sef don konfam di deal and order make dem reopen Strait of Hormuz and remove di US naval blockade […]

todayJune 15, 2026 18 11

OBODO NAIJA

President Tinubu Hail Abdulsalami

Wi Presido, Bola Tinubu yesterday praise shege comot former military Head of State, Abdulsalami Abubakar, head, say im na oga na master for naija democratic. Tinubu tuk dis one for Abuja during public book presentation wey dem hold to honour Abdulsalami 84th birthday, and naĀ  Vice Presido Kashim Shettima represent am fry mouth for di event. Shettima drop Tinubu message say Abdulsalami leadership naim bee di stew for naija democracy, […]

todayJune 15, 2026 19

Lagos

NDLEA Kramp Brazil Businessman

Operatives of National Drug Law Enforcement Agency don arrest a 41-year-old Nigerian businessman, Abugu Ikechukwu, for Lagos airport say dem gbab am with liquid cocaine inside shirts and towels. According to NDLEA tuk, tuk, Femi Babafemi, Di man, just land for Murtala Muhammed International Airport from Brazil via Ethiopia, wan bin dodge enter Nigeria, not knowing say mehn dey at alert for di airport. Babafemi say dia test confirm di […]

todayJune 15, 2026 12 12

Lagos

Lagos Police To Arrest Cars

Lagos State Police Command don announce say dem go start statewide jogolo against motors wey get covered, fake, defaced or no plate number to improve security and reduce crime. Police tuk, tuk, SP Abimbola Adebisi, talk say di order come from Inspector-General of Police, Olatunji Disu, and e go start on Monday, June 15, 2026, under CP Tijani Fatai supervision. To tell u how di mata serious reach, commissioner of […]

todayJune 15, 2026 25 1

Sports

Okocha Collect Special FIFA Award

Super Eagles legend Augustine ā€˜Jay-Jay’ Okocha don collect one special ā€œSuperior Player of the Matchā€ award from FIFA for im beta doings against Spain wey im show for di 1998 World Cup. Di award, wey Michelob ULTRA and Copa90 collabo give am, na to honor players wey show dem-sef for World Cup games before di official Player of di Match award start for 2002. Di senior play naim post for […]

todayJune 12, 2026 32 2

obodo oyinbo

Ebola Spread Enter New Areas For DR Congo

World Health Organization (WHO) on Friday don share update say Ebola don dey spread enter northeastern Democratic Republic of Congo, especially for Ituri, North Kivu and South Kivu. WHO epidemiology head, Olivier le Polain, naim dey give dis update, say di virus dey enter new health zones almost every day, showing how di outbreak big and hard to control. According to WHO, since dem declare di outbreak on May 15, […]

todayJune 12, 2026 25

OBODO NAIJA

Sowore Tell Presido To Resign

Still on same mata, na Omoyele Sowore carry protester dey protest for wi decision headquarters, say make wi oga presido resign. Di senior man fry, fry mouth unto many tins for di Democracy day protest wey dem do for Abuja. According Sowore, security zero, food sef nor dey, say, Nigerians don lost dia democracy and dey demand back from di gorment.

todayJune 12, 2026 21

Lagos

Falz, Femi Falana Join Protest For Lagos

Nigerian rapper, Folarin Falana ,AKA Falz di bad guy, sef join protesters for Ikeja Underbridge, Lagos, on Friday to demand action against rising insecurity, economic hardship and bad governance across di country. Di protest, wey im join alongside im papa, human rights lawyer Femi Falana, and other activists, organise, pin point say enough don dey enough and dat Democracy Without Security na zero Falz drop some bars during di protest, […]

todayJune 12, 2026 42

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds