News-edi 1

2593 Results / Page 54 of 289

Background

Local

Oyo Declare Tuesday Public Holiday

Oyo State government don declare Tuesday, 16th June 2026 as work-free day to mark Islamic New Year, Hijrah 1448AH. Gofnor Seyi Makinde approve di holiday as way to show respect and solidarity with Muslim community for the state. Na oga Commissioner for Information, Prince Dotun Oyelade, sorosoke di mata, say di Hijrah na important event wey mark Prophet Muhammad migration from Mecca to Medina. Gofnment still urge residents make dem […]

todayJune 16, 2026 24

Lagos

Lagos Council Chairmo Appoint Mehn To Rascal Rascality

Chairmo of Igbogbo/Baiyeku Local Council Development Area, Hammed Aroyewun, don vow say dem go continue raid criminal hideouts for di area. E talk dis one on Monday as e dey brief journalists for council secretariat. E also talk say security operatives recently carry out surprise operation for one suspected black spot, wia dem recover hard drugs and other illegal items. According to am, di raid come as result of intelligence […]

todayJune 16, 2026 41 14

Sports

Mo’ Salah Celebrate Birthday For World Cup

Unto World cup updates, Belgium and Egypt play 1-1 draw for dia World Cup opener on Monday, as Belgian second-half equaliser spoil Mohamed Salah birthday wey turn 34. Emam Ashour naim score first for Egypt early for first half inside Seattle. Romelu Lukaku enter as substitute, naim con force Egypt player Mohamed Hany to score own goal wey level di match. With di result, Egypt still dey find dia first […]

todayJune 16, 2026 25

obodo oyinbo

Ebola Spread To New Areas

Ebola cases for Democratic Republic of Congo don rise reach 782, with 178 people don die as di outbreak continue spread. Health authorities yesterday konfam 72 new cases and 29 deaths for Ituri and North Kivu provinces. Di disease don also reach two new health zones, Nia-Nia for Ituri and Mabalako for North Kivu, making di affected areas reach 31. Officials say 359 patients dey isolation or treatment, while 40 […]

todayJune 16, 2026 20

Local

Anambra Police Nab Man Weh Kill Him Girlfriend

Anambra State Police don arrest 33-year-old man, Ifechukwu Okechukwu, for allegedly kill him 23-year-old girlfriend and bury her body secretly for Nkpor. Police spokesman, SP Tochukwu Ikenga, say, di arrest hapun after trending videos and information from concerned members of di public reach dem. Ikenga also say police intercept video of exhumed corpse for Nkpor and another one of 10-year-old boy wey get serious body injuries. He add say four […]

todayJune 16, 2026 13

OBODO NAIJA

Why Court Wan Wipe ADC From Di 2027 Election

African Democratic Congress (ADC) don reject one Federal High Court judgment wey order INEC to deregister dem and four other political parties. U sabi say, Justice Peter Lifu of di Federal High Court for Abuja give di order on Monday, say di parties no meet constitutional and electoral requirements. Di party Publicity Secretary, Bolaji Abdullahi, naim con sorosoke for statement to reply, post for X, say di judgment dey unconstitutional […]

todayJune 16, 2026 22

Local

Adeleke Challenge Court Ruling Wey Scrap Five Political Parties

Osun State Govo, Ademola Adeleke don condemn di Federal High Court judgment wey order make dem deregister five political parties, say na abuse of court process and violation of Court of Appeal order. For statement wey im tuk, tuk, Olawale Rasheed, release for Osogbo on Monday, Adeleke talk say di Court of Appeal don already order make all proceedings for di mata stop pending further hearing. Di govo express surprise […]

todayJune 16, 2026 26

Sport Yarns

Amorim to Pick Up AC Milan Coaching Job

By : Jolayemi Olajide Dem really tuk say, one man food na another man poison, say former man united coachie, Ruben Amorim don dey close to become AC Milan new coach Dis na according to report from Italy,  Milan go  later this week to sign two-year contract. The 41-year-old Portuguese manager go replace Massimiliano Allegri, wey dem sack after poor results  wey make Milan miss Champions League qualification.  

todayJune 15, 2026 20

obodo oyinbo

Court don find two men guilty for fire attack on Keir Starmer property.

By : Jolayemi Olajide London court don kpake  two  jaguda boys, Roman Lavrynovych and Stanislav Carpiuc, find  dem guilty, say dem bin dey plan to  burn prime minister,  Keir Starmer. house and car. Di two men, wey be 22 and 27 years old, do di attack for May 2025. Dem go target two houses for north London one house wey company wey Starmer use to direct manage, and di second […]

todayJune 15, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds