News-edi 1

2593 Results / Page 53 of 289

Background

obodo oyinbo

Ukraine drone blast Moscow Refinery

By : Jolayemi Olajide Nor be small lin, like Russia and Ukraine na dia oil business dem take dey play, One big oil refinery for Moscow don go catch serious fire on Tuesday as Ukrainian drones hammer di city. Moscow Mayor naim dey konfamate is mata, say over 60 drones naim jam the capital, and one of dem come scata for Gazprom refinery wey dey Kapotnya area. Ukraine tok say […]

todayJune 16, 2026 21

Sport Yarns

Iran players to Miss World Cup Match cause of Expired Visa to America

By : Jolayemi Olajide Iran national football team don dey complain say one of dia star players, Mehdi Torabi, visa don expire after dia match for Los Angeles. According to di aproko, Torabi only get single-entry visa, unlike im oda teammates wey get multiple-entry, so now e nor fit enter di US again to continue di tournament. Iran Football Federation don already start work to see how dem go quickly […]

todayJune 16, 2026 20

Economics

Dangote refinery reduce petrol price to ₦1,175

By : Jolayemi Olajide Dangote Refinery don drop dia petrol price to ₦1,175 per litre for marketers. According to dia management, dis na to see whether transporter fit reduce tfair small Oil experts believe say dis move go make competition better and help keep fuel supply stable for all corner of Nigeria.  

todayJune 16, 2026 21

Education

JAMB Release Mop-up Results for 2026 UTME

By : Jolayemi Olajide JAMB don finally release di result for di 2026 UTME mop-up exam wey dem do recently. The board tuk tuk, Fabian Benjamin, naim sorosoke dis update say candidates fit go check dia result now through di normal JAMB portal. Every student wey write the mop-up exam right now got go check dia result sharp-sharp to know wetin dey happen.  

todayJune 16, 2026 21

Politics

David Mark jinger boys say ADC court judgement nor go work

By : Jolayemi Olajide Senator David Mark, wey be the National Chairman of ADC, don tell party members say no sakement for di Justice Lifu judgement wey commot dia name for di 2027 election. Mark tell the party candidates for Abuja say the judgement na "arrow wey dem fire for Nigeria democracy heart," but e promise say higher courts go soon cancel di decision. Di one pain David Mark, na […]

todayJune 16, 2026 25

Sport Yarns

Senegal senior man football tuk, tuk share moral for France vs. Senegal world cup game

By : Jolayemi Olajide Say like dis now, di America, world cup dey hot, As Senegal ready to jam France for dia 2026 World Cup opener. According to di tuk tuk person for Senegal football, Ousmane Sonko, dis match be like two African side playing demsleves and dat di game get deep meaning for football. Sonko explain, say based on the plenty African players wey dey inside French squad, Sonko […]

todayJune 16, 2026 30

Sports

Kano Pillars Release Eight Players

Kano Pillars Football Club don announce say eight players go leave dia club as dia contracts expire for end of 2025/2026 NPFL season. Di players include Muhammad Galadima, Ugochukwu Gabriel, Zahraddeen Bello, Williams Ayuba, Bernard Ovoke, Christian Izuchukwu, Sudais Ali Baba, and Aliyu Yakubu. For statement, di club thank dem for dia professionalism, commitment and contribution while dem dey play for Kano Pillars. Di club wish dem well for dia […]

todayJune 16, 2026 23

OBODO NAIJA

Soldiers Rescue Wife Weh Bandits Shoot

Soldiers of Nigerian Army, with support from Air Force, don rescue di wife of late Major General Rabe Abubakar, Amina Abubakar, wey bandits carry go weeks ago. According to Defence Headquarters, through di Director of Defence Information, Major General Samaila Uba, dem say di rescue hapun under Operation FASAN YAMMA. Troops explain say dem jam di kidnappers for Tunga Village during serious search and attack operation against di criminals. As […]

todayJune 16, 2026 24

OBODO NAIJA

Okonkwo Drag ADC Over VP Choice

African Democratic Congress chieftain, Kenneth Okonkwo don criticize di party decision to pick Vice Presidential candidate from South-South for 2027 election. Im tuk dis one for TV sit down tuk say, di move fit worsen di political marginalisation wey South-East dey face since 1999, as dem never produce Presido or Vice Presido. Okonkwo also yarn say if ADC really choose candidate from South-South, e no go show fairness to other […]

todayJune 16, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds