News-edi 1

2593 Results / Page 93 of 289

Background

OBODO NAIJA

Tinubu Tell New Ambassadors to Improve Naija Image

Wi oga Presido Bola Tinubu don tell Nigeria new ambassadors and high commissioners say make dem work hard to improve how world pipo go dey see Nigeria. Di Presido tuk dis one on Monday for induction programme wey hapun for Ministry of Foreign Affairs for Abuja. George Akume, wey be Secretary to di Gornment of di Federation,  na im represent am tuk for dis event. E still ask dem to  […]

todayApril 28, 2026 16

Lagos

Lagos Gorment Tell Employers to Check Workers Mental Health

Lagos State Gornment don tell employers make dem dey use Employee Assistance Programme to support workers mental health and improve safety for work. Dis one come as dem mark World Safety Day wey dey happen every April 28, as Lagos State Safety Commission release statement for Monday. Di Director-General of di Commission, Lanre Mojola, still congratulate workers, employers and safety people for di important day. Dem also tuk say even […]

todayApril 28, 2026 18

Politics

Jandor Hold Ground For 2027 Lagos Race

Di pipos democratic party 2023 lagos governorship candidate, Dr Abdul-Azeez Adediran wey dem sabi as Jandor don talk say im still dey inside 2027 Lagos governorship race. Dis one happen even as plenty APC leaders dey endorse Deputy Governor, Dr Obafemi Hamzat, for di position. Pipo like Governor Sanwo-Olu, Speaker Mudashiru Obasa and Chief of Staff Femi Gbajabiamila don show support for Hamzat. Reacting, Jandor tuk say e respect all […]

todayApril 28, 2026 26

Health

Dr Ibijoke Sanwo-Olu Launch N70m Health Fund for Lagos Hospitals

Wife of Lagos State Govo, Dr  Ibijoke Sanwo-Olu, don announce N70 million endowment fund to support poor pikins wey need surgery for Lagos State. She tuk dis one during pediatric surgical support event wey Orunsii Welfare Foundation organise. Say di fund go support patients for 14 public hospitals, including LASUTH and National Orthopaedic Hospital. She also talk say di initiative na about compassion and helping pipo, quoting say no be […]

todayApril 28, 2026 35

Education

Viral 394 UTME Result Na Fake – JAMB

Di Joint Admissions and Matriculation Board don come out reject one UTME result wey dey trend for social media, say na fake oh. Dem say di result show one girl from Cross River, Okon Winniefred Sampson, scoring 394 out of 400, Jamb now dey tuk say dat kind result nor dey dia system. According to JAMB spokesman, Fabian Benjamin, di result slip na fake result. Fabian still beg Nigerians make […]

todayApril 27, 2026 29

Politics

Opposition Parties Reject Ibadan Summit

Branches inside Peoples Democratic Party, African Democratic Congress, Accord Party and Labour Party don reject di Ibadan opposition summit, say e dey one sided. Dem tuk say dem go still bring separate candidates to challenge Bola Tinubu for 2027 election. PDP National Working Committee, with support from Nyesom Wike, accuse dia members say dem be  “imposters” wey dey deceive leaders like Atiku Abubakar and Peter Obi. Meanwhile, ADC groups, Accord […]

todayApril 27, 2026 24

Lagos

Lagos Taskforce Gbab 50 Area Boys Across Di State

Say Lagos State Environmental and Special Offences Unit (Taskforce) arrest about 50 suspected hoodlums during statewide environmental sanitation enforcement for Lagos. Dem carry out di operation across many hotspots like Ikeja, Agege, Abule-Egba, Iyana-Ipaja, Ijora, Lekki–Ajah Expressway and others, say dem do dia touch lighting wella. Chairmo of di Taskforce, Adetayo Akerele, na im dey convasate dis mata, say dem monitor di exercise wella and ensure say vehicular movement and […]

todayApril 27, 2026 47

Lagos

Police Oga Disu Order Make Police Officers Show Respect to Citizens

Oga inspector General of Police, Olatunji Disu don charge officers of Nigeria Police Force, Akelebe, say make dem try to dey get respect for members of di public. DI IGP give di directive during one courtesy visit to Lagos Govo Office, Alausa, Ikeja for Lagos. For Disu, say beta policing dey depend on cooperation and trust between police and di public.

todayApril 27, 2026 24

Lagos

Gbajabiamila Back Hamzat for Lagos Governorship Race

Chief of Staff to wi oga Presido, Femi Gbajabiamila, don openly back Lagos deputy governor, Obafemi Hamzat, for Lagos governorship election 2027. Di Chief of Staff make di declaration after Hamzat and top APC leaders visit am for im Oniru residence for Lagos on Sunday. According to Gbajabiamila, say Hamzat get beta leadership, and e get full confidence say, baba Hamzat go carry Lagos go higher level.

todayApril 27, 2026 71

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds