News-edi 1

2593 Results / Page 91 of 289

Background

Lagos

Lagos Gornment Launch New Tech System For Sharp Emergency Response

Lagos State Government don launch one new digital platform wey dem call Lagos Emergency Responder Management System (LERMS), Dis new system go make all emergency agencies to join bodi and respond to emergencies anywhere gbege happen. For statement wey gornment release, dem talk say dem unveil am for Folarin Coker Staff Clinic Conference Hall for Alausa, Ikeja. For di launch, Commissioner for Special Duties and Inter-Governmental Relations, Gbenga Oyerinde, tuk […]

todayApril 30, 2026 23

OBODO NAIJA

FG Declare May 1 as workers Day Public Holiday

Federal Gornment don declare Friday, May 1, 2026, as public holiday to mark International Workers’ Day. Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo, announce di  holiday and hail Nigerian workers for dia hard work and contribution to di country. E tuk say workers effort dey very important for Nigeria growth and better development. Gornment still encourage dem make dem continue to dey patriotic, work well, and stay committed to dia duties.

todayApril 30, 2026 23

Politics

Vice Presido Kashim Shettima Tell APC Leaders to Stay United

Vice Presdio, Kashim Shettima don tell leaders and people wey wan contest under All Progressives Congress make dem ensure  peace and work together as dem dey prepare for primaries and 2027 election. For one statement wey dem release for Abuja on Wednesday, e warn say if party members nor dey unite, e fit affect dem chances to win. Shettima beg dem not to  provoke each other and always show maturity […]

todayApril 30, 2026 30

Politics

Tinubu Back Hamzat as Lagos Governorship Candidate

Presido, Bola Tinubu don give im support to Obafemi Hamzat as APC consensus candidate for Lagos governorship election next year. Tinubu give di endorsement on Wednesday when GAC members visit am for Presidential Villa for Abuja. Earlier dis week, Babajide Sanwo-Olu don already name Hamzat as di person wey im want make succeed am. Sanwo-Olu talk am after one private meeting for Lagos House, where Hamzat declare say im wan […]

todayApril 30, 2026 25

OBODO NAIJA

FG Push 30-Day Credit, Direct Fuel Sale to Save Airlines

 Federal Gornment through Aviation and Petroleum Ministries and NMDPRA don tuk say airline fuel marketers must give operators 30-day credit and also sell aviation fuel direct to dem. Dem tok dis one for executive summary wey come out Monday for Abuja, after high-level meeting wey involve FAAN, NAMA, NCAA, airline operators and fuel marketers. Di reason why dem take dis decision na to tackle serious jet fuel shortage and price […]

todayApril 28, 2026 22

Politics

Peter Obi Pay Visit to Jonathan for Abuja

Di 2023 presidential candidate of labour party and now of di African Democratic Congress (ADC), Peter Obi, don  pay August visit to former Presido, Goodluck Jonathan for Abuja to tuk about how di country dey go and 2027 election. Di meeting hapun behind closed door, as Obi carry some South-East political leaders go meet am. Obi tell journalists say di visit na part of im consultation waka as e dey […]

todayApril 28, 2026 24

OBODO NAIJA

Naija New Housing Minister Promise Affordable Houses

Di new Minister of Housing and Urban Development, Muttaqha Darma, don promise say im go use teamwork take solve Nigeria housing shortage and make houses more affordable. E tuk dis one for handover ceremony wey happen for Abuja on Monday evening. Darma say im administration go work closely with all important pipo for di housing sector to fit achieve better results.

todayApril 28, 2026 19

OBODO NAIJA

Bandits Kpai 11, Injure 2 for Gurbi Community for Katsina

For Katsina State, some Jaguda boys, oyinbo dey call dem suspected bandits don go attack Gurbi community for Kankara LGA, kpai eleven pipo and wunjor two others. Police spokesman Abubakar Sadiq na im dey konfamate dis mata, say once dem receive distress call, joint security team with police and military quickly move go di area. Dis attack happen around 2:40pm on April 26, 2026, as di gunmen enter di zanga, […]

todayApril 28, 2026 18

Sports

FIFA Plan New Yellow Card Rule

Say like dis FIFA, dey consider new disciplinary rule ahead of expanded FIFA World Cup. Di proposal be say dem wan add second “amnesty point” wey go wipe yellow cards after group stage and again after quarter-finals, dis one mean say, suspension go reduce. According to report, Dem dey do am because with 48 teams, players fit play up to six matches before semi-finals, and under current rule two yellow […]

todayApril 28, 2026 32

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds