News-edi 1

2593 Results / Page 92 of 289

Background

Lagos

Gas Truck Crash For Eko Bridge, Cause Emergency For LASEMA

Lagos State Gornment don activate emergency response after one gas truck accident for Eko Bridge, outward Apongbon. Di Gornment, through LASEMA spokesman Olawale Afolabi, konfamte dis mata on Tuesday. According to am, di askident hapun when di front tyre of di 10-tonne truck burst while e dey move. E explain say di truck wey carry about 10,090kg of cooking gas lose control, hit di road median and overturn. Di crash […]

todayApril 28, 2026 47

Sports

Flamingos Scatter Nazareth Queens 7-0 for World Cup Warm-Up Match 

Flamingos wey be Nigeria U-17 women team don mash Nazareth Queens 7-0 for their World Cup qualifier prep match for Abuja. Dem carry 2-0 go enter halftime as Wuraola Olayiwola score for 8th minute and Oluebube add another one for 34th minute. Na so For second half, Harmony Chidi shine with two goals for 48th and 54th minute, while Oluwakemi Adegbuyi score penalty for 59th minute to make am 5-0. […]

todayApril 28, 2026 29

obodo oyinbo

Xenophobia Kpai 2 Nigerians For South Africa, Diaspora Be FG For Help

Fresh xenophobic wahala don break out again for South Africa on Monday, dat two Nigerians don go down for di mata. For statement wey dem wrap like moimoi, na Nigerian Consulate General for Johannesburg, Nigerians, Ninikanwa Okey-Uche, dey konfamate dis mata say, Amaramiro Emmanuel and Ekpenyong Andrew, na im be di two pipo kpai name. Nigerians wey dey South Africa dey cry for help and dey beg Federal Gornment make […]

todayApril 28, 2026 27

Sports

Van Dijk Promise Correct Farewell For Salah

Liverpool captain Virgil van Dijk tuk say, for  sure,  Mohamed Salah go still get correct farewell, even if injury nor go allow am play again dis season. Salah, wey dey plan comot Liverpool after nine years, carry hamstring injury comot during their 3-1 win over Crystal Palace. Liverpool still dey wait scan result to know how serious di injury be, but only few matches remain for di season. Van Dijk […]

todayApril 28, 2026 19

Sports

Man United near Champions League Spot

Manchester United don move near Champions League qualification after dem beat Brentford 2-1 for Old Trafford on Monday. Casemiro na im open di scoring early for di match, while Benjamin Sesko add second goal before half time. Brentford try fight back as Mathias Jensen score late goal for im side. But di win still leave united third position, and dem dey 11 points clear of Brighton as top five go […]

todayApril 28, 2026 14

obodo oyinbo

US, Iran to Start Anoda Peace Tuk To Calm Di Strait Of Hormuz

US Presido, Donald Trump and im national security team like dis don dey review Iranian peace plan wey dem say fit end di war and reopen Strait of Hormuz. Konfaming dis tatafo, say Iran Foreign Minister Abbas Araghchi meet Russian Presido Vladimir Putin for St Petersburg, where e tuk say Iran dey consider US request to restart negotiation, as dem try find way end di crisis through diplomacy. While dem […]

todayApril 28, 2026 19

obodo oyinbo

King Charles and Trump Meet for White House on UK-US Relationship

King Charles III meet Donald Trump for White House on Monday, as both leaders find way to strengthen relationship between United Kingdom and United States, despite tension over Trump war for Iran. Di meeting hapun for Washington DC with full ceremony an na Melania Trump welcome Charles and Queen Camilla warmly. According to Trump say di visit importankpa to keep di both countries  “special relationship” strong.

todayApril 28, 2026 18

OBODO NAIJA

How Gunmen Kpai 29 Pipo for Adamawa Community

Say nor be small badness yesterday, as Gunmen attack Guyaku and Telabala communities for Gombi LGA of Adamawa State, kpaing nothing  less than 29 pipo. Witness tuk say di attackers enter during one football match for primary school around 5pm Sunday, begin shoot anyhow, pipo begin run for safety. Di gunmen no stop for there, dem still burn some religious buildings, while residents cry for di loss of dia family […]

todayApril 28, 2026 22

Politics

APC Shift 2027 Election Timetable, Fix Dates and Form Money

All Progressives Congress (APC) don release new timetable for 2027 general elections on Monday. National Organising Secretary, Sulaiman Muhammad Argungu, na im sign di notice and spokesman Felix Morka konfam am. Dem say dem adjust di dates to follow Nigeria constitution, Electoral Act 2026 and INEC schedule, so everything go run smoothly. According to di party, sale of forms go start April 25 end May 2 for party offices, submission […]

todayApril 28, 2026 31

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds