News-edi 2

1802 Results / Page 3 of 201

Background

OBODO NAIJA

Wike Tok Say Kwara Gofnor Dey Blame Am For Everything

By: Mariam Ajayi FCT Minister, Nyesom Wike, don tok say Kwara State Gofnor, Abdulrahman Abdulrazaq, dey always blame am for anything wey happen for im office or house. Wike talk dis one for interview with tori pipo on Tuesday, say anytime di Gofnor see snake or any kind reptile, e go say, “Na Wike.” Di FCT Minister also accuse Abdulrazaq say e dey focus more on gossip instead of doing […]

todaySeptember 16, 2026 7

Lagos

Lagos Assembly Mourns Former Member Kamal Olorunoje

By: Mariam Ajayi Di Lagos State House of Assembly don mourn former member, Honorable Kamal Owolabi Olorunoje, wey kpai on Tuesday morning. Na Honorable Lanre Afinni, wey dey represent Lagos Island Constituency 2, announce di death for Plenary on Tuesday, tok say Olorunoje represent di same constituency for di 3rd Assembly before e later serve for Lagos State Civil Service Commission. Di House kon stand up to observe one minute […]

todaySeptember 16, 2026 8

Lagos

Lagos-Ibadan Holdup Make Road Users Lament

By: Mariam Ajayi Nor be small tin for di past one week for di lagos ibandan express way, as gorment send job men make dem go repair kara bridge. Say on Tuesday September 15, na mess and handpit smell drivers and passengers wan take kpai dem selfs. According by wetin some of di road drivers tuk, na one night dem don spend for di road, making dem spend more money […]

todaySeptember 16, 2026 7

Entertainment

Nollywood Legend Olu Jacobs Kpai for 84

By: Mariam Ajayi Veteran Nigerian actor and film executive, Olu Jacobs, kpai at the age of 84. Hin son, Olusoji Jacobs, naim announce di news untop Instagram on Wednesday. The family describe the late actor as The Lion of Lufodo and say dem dey grateful to God for hin life. Dem also beg bloggers and social media influencers to respect the family privacy for this difficult time.

todaySeptember 16, 2026 8 2

obodo oyinbo

UN Blow Alarm As Ebola Kpai 3,500 Pipo For DR Congo

By: Mariam Ajayi United Nations Ebola Coordinator, Julien Harneis, don raise alarm over di way world pipo dey handle Ebola mata, as di virus don reportedly kill about 3,500 pipo for eastern DR Congo. Di UN boss porporly dis mata for news statement on Tuesday, say if dem leave Congo, ehn, ehn, Ebola go finish Congo, and dat dem need beta help. Oga Harneis con kneel down dey  beg world […]

todaySeptember 16, 2026 7

OBODO NAIJA

ADC Drag Tinubu As Petrol Hit N1,470 Per Litre for Filling Station

By: Mariam Ajayi African Democratic Congress don tell Tinubu goment say na people wey no get mind dey dia, as petrol price don fly reach N1,470 per litre. ADC mouth-piece Bolaji Abdullahi naim dey  raise di alarm for Abuja. According to abdullahi, make APC confess oh, di plan wey dem get for Nigerians, say poor pipo dey cry wetin nor gud for di obodo naija, and nobody dey shake bodi. […]

todaySeptember 16, 2026 9

Lagos

Lagos FRSC Say Na Lagos Drivers Be Di Problem Of Lagos

By: Mariam Ajayi Lagos state FRSC sector commando, kahinde hamzat don fry mouth explain wey for lagos ibadan express way, wia ordour wan kpaikpai pipo, wia mess give demselves because of hold up. Just yesterday according to di ogbongelicious update over di askident naim hapun for di road, and as di traffic pipo dey try clear road na so drivers wey nor get patient begin rush block road. Kehinde say […]

todaySeptember 16, 2026 7

OBODO NAIJA

Police Rescue Two Kidnap Victims,Kpai Three for Niger

By: Mariam Ajayi Niger State Police don rescue two pipo wey kidnappers gbab from Wako village, New Bussa, after security team clash with di gunmen for Wawa forest on September 10. Police PPRO, SP Wasiu Abiodun, say surveillance team and vigilantes intercept di kidnappers after dem demand ransom for di two victims. Di gun battle leave three suspected kidnappers dead, while di two victims escape unhurt and other gang members […]

todaySeptember 15, 2026 14

obodo oyinbo

US Supreme Court Block Trump Mail Ballot Plan

By: Mariam Ajayi US Supreme Court don block President Donald Trump plan to change how dem dey send mail-in ballots give voters across America. Di court stop di plan on Monday after election officials warn say e fit cause confusion and disenfranchise millions of voters for dis year midterm election. Two conservative justices, Samuel Alito and Clarence Thomas, oppose di decision, while di court say Trump administration no likely win […]

todaySeptember 15, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds