News-edi 2

1844 Results / Page 111 of 205

Background

obodo oyinbo

IMF Raise Alarm, Say Middle East War Fit Cause Hunger For Africans

By : Jolayemi Olajide International Monetary Fund, IMF don warn say if care is not taking di Middle East war e fit cause food crisis for Sub-Saharan Africa. Di organisation talk say di conflict fit scatter di economic progress wey di region dey enjoy after Sub-Saharan Africa enter 2026 with im strongest growth level for ten years. According to IMF, di region record 4.5 percent growth for 2025 because of […]

todayMay 20, 2026 16

Sport Yarns

Ronaldo Make History Again As Portugal Release World Cup Squad

By: Esther Ayoola Portugal national football team don confirm dia squad for upcoming FIFA World Cup 2026, with Cristiano Ronaldo set to make record sixth appearance for di competition. Head coach Roberto Martinez tuk say di selection carry emotional weight, especially as dem also honour former international Diogo Jota. Di 41-year-old striker being part of di squad mean say, im na one of di first 3 male player ever to […]

todayMay 20, 2026 22

Sport Yarns

Southampton Collect Ban Say Dem Spy Opponent Training Sessions

By: Esther Ayoola Southampton FC don collect punishment say dem dey spy dia opponent before match. According to independent disciplinary commission, Southampton watch training of Oxford United FC and Ipswich Town FC, and even film Middlesbrough FC before play-off semi-final. So like dis Middlesbrough go take Southampton place for championship playoff final and dem deduct dem 4 point from next season.

todayMay 20, 2026 15

Sport Yarns

Arsenal Finally Break 22-Year Jinx, Carry EPL Title

By: Esther Ayoola Arsenal Football Club don finally win di English Premier League title on Tuesday afta Manchester City draw 1-1 for Vitality Stadium. Dis na di first time for 22 years wey Arsenal go carry di Premier League trophy, afta dem don finish as runners-up for three seasons back-to-back. Manchester City bin need to win to keep di title race alive but dem fall hand beta style. Arsenal go […]

todayMay 20, 2026 15

obodo oyinbo

Putin Reach China For High-Level Talks With President Xi

By: Esther Ayoola Russia presido, Vladimir Putin don land China for two-day visit wey go centre on tuk with Xi Jinping, say dem dey try push stronger Russia-China relationship. Di visit come just few days afta US President Donald Trump also go Beijing for im own tuks with Xi, as global power tension dey rise. According to report, dis meeting also mark 25 years of di friendship between Moscow and […]

todayMay 20, 2026 13

obodo oyinbo

US Senate Move To Block Trump From Carry Military Action Against Iran

By: Esther Ayoola United States Senate don advance tuk on how to control War all to stop Donald Trump from using military force against Iran without Congress approval. Dem do di voting on Tuesday, say some of trump party mehn sef join Democrats support di move. Di US senators also express concern say di way di war dey go for Iran dem nor understand again oh, even with ceasefire for […]

todayMay 20, 2026 14

National

IGP Disu Honour 17 Fallen Officers For Yobe

By: Esther Ayoola Di Inspector-General of Police, Olatunji Disu, on Tuesday enter heavy rain  to honour di 17 police officers wey terrorists kpai for active service inside Yobe State. Di officers, wey be members of Police Mobile Force, kpai during terrorist attack for Nigerian Army Special Forces School for Buni Yadi, Gujba Local Government Area, on May 8, 2026. While addressing journalists during di ceremony, Disu drop micro soft word […]

todayMay 20, 2026 22

National

Wike Praise Speed Of Abuja Projects

By: Esther Ayoola FCT Minister, Nyesom Wike don loud matas say infrastructure projects for Abuja dey move fast and na with Ogbonge quality. Wike yarn dis on Tuesday during inspection of ongoing projects, saying di government of Bola Tinubu dey serious about opening satellite communities through massive road construction. Im also reveal say Body of Benchers annex building and several road projects don near completion and dat dem go commission […]

todayMay 20, 2026 25

National

Peter Obi Clear NDC Screening, Say Presidential Race Sti Open For Everybody

By: Esther Ayoola Di 2023 labour party presidential candidate Peter Obi don complete im screening as presidential aspirant under Naija Democratic Congress ahead of 2027 general elections. Afta di screening wey last more than two hours for Abuja, Di former Anambra governor salutate di party, say dem ma  sabi democracy. Na so tori pipo sti carry Goodluck Jonathan contesting mata   stone Obi, according to obi make Jonathan feel free to […]

todayMay 20, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds