News-edi 2

1844 Results / Page 109 of 205

Background

Lagos

Hamzat Win Big for APC primary as Sanwo-Olu tank Voters

By : Jolayemi Olajide Lagos State Governor Babajide Sanwo-Olu and his deputy, Dr. Obafemi Hamzat, don tank APC members well-well as dem come out for numbers to vote inside the party primary election wey happen across the state. Inside the peaceful voting wey happen for all the 377 wards, party members pick Dr. Hamzat as dem consensus governorship candidate for the 2027 election, where him pack 2,210 votes for his […]

todayMay 21, 2026 19

obodo oyinbo

Marco Rubio Call For New Relationship Between United States

By : Jolayemi Olajide United State Secretary of State, Marco Rubio don bring new proposal for relationship between United States and Cuba, as e talk say dem fit give $100 million food and medical support. For video message wey e send go Cuban people on Wednesday, Rubio talk say dis plan fit open new door between Washington and Havana as di money go hellep solve food and drug wahala wey […]

todayMay 21, 2026 12

OBODO NAIJA

Road Clear For Ogundu Chinda, After Fubara, Others, Comot For Rivers Governorship Race

By : Jolayemi Olajide Di road don clear well-well for di 10th National Assembly lawmaker wey dey represent Obio/Akpor Federal Constituency, and kinsman of FCT Minister Nyesom Wike, Ogundu Chinda to carry di governorship ticket of All Progressives Congress (APC) for Rivers State. Di road clear after Governor Siminalayi Fubara, Alabo George-Kelly and Tonye Cole comot dia body from di APC Governorship primary race wey go hold on Thursday. Fubara, […]

todayMay 21, 2026 14

OBODO NAIJA

George-Kelly Comot From Rivers All Progressives Congress Governorship Primary Race

By : Jolayemi Olajide Rivers State Governorship Aspirant for di All Progressives Congress (APC), Alabo George-Kelly, don comot body just few hours after Siminalayi Fubara announce say im no dey  join  body again inside di APC governorship primary race. For statement wey George-Kelly release on Wednesday, say e take di decision after one big meeting with APC leaders. George-Kelly talk say na loyalty, respect and leadership dey guide am for […]

todayMay 21, 2026 15

Uncategorized

Ajose Explain Why E comot From Lagos Governorship Race

By : Jolayemi Olajide Lagos APC governorship aspirant, Samuel Ajose, don confirm say e don pull out from di 2027 governorship race to back Deputy Governor, Obafemi Hamzat. E talk dis one for TV siddon talk on Wednesday, say e step down sake of say, APC leaders don already show di direction wey dem wan follow for di Lagos governorship marras ahead of primaries. E sti add say na respect […]

todayMay 21, 2026 18

OBODO NAIJA

NNPP Threaten Say Dem Go Do Mass Protest Over Inec Screening Delay

  By: Jolayemi Olajide di New Nigerian pipos party don threaten mass protest for Abuja say if INEC nor stop delaying dia primary screening across Nigeria. Di party oga, Dr. Boniface Aniebonam, dey claim say INEC's slow action dey cause heavy political tension and dey ground dia internal preparations nationwide. NNPP warn say although dem pause protest before to stop hoodlums, dia patience don finish small, small. Dem dey demand […]

todayMay 21, 2026 20

OBODO NAIJA

Jamb Release 279 Utme Results Wey Dem Bin Seize

By : Jolayemi Olajide JAMB senior oga, Fabian Benjamin don announce on Thursday say dem don release 279 UTME results wey dem bin sieze afta clear investigation show no evidence of exam malpractice. Di board explain say dem clear dis results following deep checks across Nigeria, while dem cancel other results wia proof of cheating dey. Dis action come as part of di board effort to maintain exam integrity after […]

todayMay 21, 2026 15

OBODO NAIJA

Tinubu Appoint Professor Segun Aina As New Jamb Registrar

By: Jolayemi Olajide President Bola Tinubu don appoint Professor Segun Aina to replace Professor Is-haq Oloyede as JAMB Registrar when im final tenure expire on July 31, 2026. Professor Aina, wey go turn 40 in July, na expert for digital infrastructure and examination systems from Obafemi Awolowo University. Di Presidency note say Aina get deep experience for admissions management dating back to im NYSC days with di board. E go […]

todayMay 21, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds