News-edi 2

1831 Results / Page 18 of 204

Background

Sports

Falconets Face Spain for U-20 World Cup Opener

By: Kofoworola Olayinka Naija Falconets go face Spain on Monday by 5pm for dia opening Group F match of di 2026 FIFA U-20 Women World Cup for Poland. Spain na one of di strong teams for di tournament, while Naija get plenty World Cup experience but never win di title before. Falconets coach Moses Aduku say e go treat di match like cup final, after Nigeria beat Poland 1-0 for […]

todaySeptember 7, 2026 15

Politics

Peter Obi Say E Fit Fix Naija If E Become Presido

By: Ayobami Dada Peter Obi say hin record as Anambra gofnor show say e fit improve Naija if Nigerians give am chance to become presido for 2027. Obi promise say e go fight corruption, cut gorment waste, bring order to gofnance, stop election rigging and focus on health, education, security and poverty. Dis come after hin former running mate, Yusuf Datti Baba-Ahmed, say none of di politicians wey dey challenge […]

todaySeptember 7, 2026 10

Sports

Carrick Explain Why Rashford Comot for Everton Draw

By: Kofoworola Olayinka Manchester United manager Michael Carrick don explain say Marcus Rashford comot for dia 2-2 draw with Everton after e start dey feel small something for im body. Rashford wey start di match for Hill Dickinson Stadium comot for 70th minute after e give Everton defence plenty palava with im attacking play. Carrick say Rashford don dey sharp since e return to di team, adding say di England […]

todaySeptember 7, 2026 8

OBODO NAIJA

Federal Gornment Ready Give Nigerian $25m Each

By: Kofoworola Olayinka Federal Gorment don announce say qualified Nigerian shipowners fit access up to $25 million each under di Cabotage Vessel Financing Fund, CVFF, to buy vessels and grow dia business. Minister of Marine and Blue Economy, Adegboyega Oyetola, say gorment don finally ready to release di fund, more than 20 years after dem establish am. Oyetola say di cheap financing go help Nigerian shipowners buy modern vessels, expand […]

todaySeptember 7, 2026 8

Sports

Osimhen Injure Hin Upper Joint as AFCON Qualifier Dey Hang

By: Mariam Ajayi Super Eagles striker, Victor Osimhen don pick groin injury as Galatasaray confirm say e get serious strain for di muscle around him right groin. Osimhen pick di injury during Galatasaray 3-2 win over Istanbul BaÅŸakÅŸehir on Friday, after e score di first goal before dem carry am comot for 33rd minute because e dey feel pain. Galatasaray say Osimhen don start treatment, but dem never give time […]

todaySeptember 7, 2026 11

Sports

Fury Dey Vex Say Joshua Wan Dodge Fight

By: Mariam Ajayi Tyson Fury don accuse Anthony Joshua say e dey try dodge dia fight, as di former heavyweight champion say e don tire to wait for confirmation. Fury say di fight wey dem expect to happen for November fit no happen again, as e tell Joshua make e talk whether e still wan fight am for 2026 or e don comot. Fury, wey don lose twice to Oleksandr […]

todaySeptember 7, 2026 9

OBODO NAIJA

US No Fit Hold Tinubu And Hin Family For UNGA

By: Mariam Ajayi Naija UN envoy, Ambassador Jimoh Ibrahim, say Presido Bola Tinubu and hin family fit move freely for America during UN General Assembly. Ibrahim tuk say Nigerian Mission for New York never receive any notice from US government say dem wan restrict Tinubu movement during di UN meeting. E explain say agreement between UN and US protect representatives of member countries and dia families from movement restrictions while […]

todaySeptember 7, 2026 10

OBODO NAIJA

Bauchi Police Gbege Man Over Alleged Child Molestation

By: Mariam Ajayi Police for Bauchi State don arrest 20-year-old Isiyaku Usman over alleged defilement of seven-year-old girl for Darazo Local Government Area. Police say di suspect allegedly lure di pikin enter one uncompleted building, where e reportedly abuse her and collect two Android phones wey belong to her. Di Police Public Relations Officer, SP Nafiu Habib, say di girl papa report di matter on September 6, 2026, leading to […]

todaySeptember 7, 2026 11

OBODO NAIJA

Three siblings kpai inside Army barracks for Akure.

By: Mariam Ajayi Three siblings kpai after dem disappear from one farm and dem later find dia bodies near a stream inside Army barracks for Akure. Di 11-year-old twins, Joshua and Jacob Jonah, and dia five-year-old sister, Blessing, reportedly disappear after dem follow dia papa and mama go farm, before dem later find dia bodies near one stream. Dia papa, Samuel Jonah, say e doubt say di children drown and […]

todaySeptember 7, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds