News-edi 2

1831 Results / Page 19 of 204

Background

OBODO NAIJA

Police Gbege Two Men Over Alleged ₦3m Burglary For Osun

By: Mariam Ajayi Police for Osun State don gbege two men wey dem suspect say dem dey part of di burglary where valuables worth about ₦3 million disappear for Ilesa on July 26, 2026. One of di suspects, 27-year-old Eyelade Anuoluwa, police say dem arrest am for Ibadan after intelligence from Ilesa Area Command, and e allegedly confess say e burgled di victim house and carry two laptops, iPhone 12, […]

todaySeptember 7, 2026 12

Sports

D’Tigress Crash Out Of World Cup After Tough Battle

By: Mariam Ajayi D’Tigress crash out of di 2026 FIBA Women’s Basketball World Cup after dem lose 99-81 to South Korea and 71-67 to Hungary. Di Naija ballers go play France today just to fulfill righteousness and at least to finish  with small respect. Like dis now every body dey point  Coach Rena Wakama, say nah hin be di problem casue say e resume  just four days to di tigree […]

todaySeptember 7, 2026 11

obodo oyinbo

Iran Threaten Say E Go Block Hormuz After US Sink 3 Oil Tankers

By: Mariam Ajayi Iran top security boss, Mohsen Rezaei, don threaten to block road near Strait of Hormuz like road safety, come dey command ships to pass Oman side. Dis one  pass pepper body sef,  as Iran Parliament Speaker, Mohammad Bagher Ghalibaf, vex warn America,  say, dem dey load  shege  for oil business, after US military sink three of dia oil tankers. While dis big men dey drag muscle, Israel […]

todaySeptember 7, 2026 10

OBODO NAIJA

As Tinubu Loan Money Take Dey Save Nigerian Student

By: Mariam Ajayi Federal gorment Student Loan Oga tuk say students dey rush loan as school fees and sapa dey squeeze dem. Sawyerr drop dis yarn  for TV sit down tuk, as e reveal say di loan don save naija students, if not, drop out for many. E say di way student take dey  apply for dis loan  show say, mehn dey pass through alot and alot dey pass through […]

todaySeptember 7, 2026 7

Lagos

Lagos Area Boss Kpai Man Wey Just Return From Obodo Oyinbo

By: Mariam Ajayi Some area jaguda boys  beat persin, him name na Basit, di man kpeme, say di man wan bin do hit and run. Di victim, wey just bounce back to Naija from obodo oyinbo and get wedding to do in two weeks, bin yam one resident for Patey area before boys chase am catch. Eye-witness, Afolabi Lawal, explain say di angry area boys use bottle and heavy stick […]

todaySeptember 7, 2026 14

Politics

Yayari Stand with Gwamna for Gombe 2027

By: Kofoworola Olayinka Former PDP chieftain Yayari don pledge for Gombe say e go work hard to support Jamilu Gwamna for di 2027 gofnorship election, after APC stakeholders visit am following im recent defection from PDP. Di APC delegation from Tumfure, Wuro Bobbo, NTA and other parts of Akko LGA appeal to Yayari to join di party, describing am as political asset wey fit strengthen APC ahead of di 2027 […]

todaySeptember 4, 2026 15

Education

WAEC Say Exam Malpractice Drop to 8.59%

By: Kofoworola Olayinka WAEC Head of National Office, Dangut, don beg stakeholders on Thursday to ignore unverified claims about WASSCE results and seek clarification directly from di council. E say new technology-driven reforms, including computer-based assessment and question, don help reduce examination malpractice. Dangut disclose say malpractice drop from 9.97 per cent in 2025 to 8.59 per cent in 2026, describing di development as positive result of WAEC reforms. E […]

todaySeptember 4, 2026 13

OBODO NAIJA

1,115 army officers dey sit promotion exam for rivers

By: Ayobami Dada About 1,115 Nigerian Army Warrant Officers and Master Warrant Officers don gather for Rivers State for 2026 promotion board. Di exercise dey happun for NYSC Orientation Camp, Nonwa-Gbam, and Headquarters 6 Division na im dey host am. Chief of Personnel Management, Major General Adewale Adekeye, advise di candidates to show professionalism and give dia best, but make dem no push beyond dia physical strength. GOC 6 Division, […]

todaySeptember 4, 2026 11

Sports

Modric, Neymar No Fit Carry Dem Star Power Go Mls

By: Kofoworola Olayinka Luka Modric don miss chance to move go MLS after San Diego FC and Inter Miami show interest for am. But di Croatian star choose to renew im Real Madrid contract for one more year before e later join AC Milan. San Diego FC also try to sign former Madrid stars Sergio Ramos and Keylor Navas, but both deals no happen. Inter Miami sef wan bring Neymar […]

todaySeptember 4, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds