News-edi 2

1831 Results / Page 16 of 204

Background

obodo oyinbo

Cape Verde Bus Crash Kill 25, Mostly Children

By: Ayobami Dada Cape Verde don begin two days national mourning after bus crash for Fogo Island kill 25 people, mostly children and teenagers, on Saturday night. Di bus wey carry 32 people dey return São Filipe when e veer off road enter deep ravine, killing di driver and 24 others. Families and residents gather across Fogo Island on Sunday to bury di victims and pay dia final respect.

todaySeptember 8, 2026 7

Lagos

Lagos Charge Over 100 Suspects for Oshodi

By: Ayobami Dada Lagos State Gornment take over 100 suspects for Special Offences Mobile Court, Bolade, Oshodi, on Friday, September 4, 2026, over alleged public peace breach and unlawful use of government property. State lawyer Oluwabusola Omotunde tell di court say security operatives arrest dem between 2 a.m. and 4 a.m. for Victoria Island, Lekki and Ajah corridor because of di alleged offences.

todaySeptember 8, 2026 9

Sports

Falconets Chop 2-0 First Breakfast For World Cup

By: Yusuf Abuh Falconets don chop first breakfast for FIFA U-20 Women’s World Cup as defending champions Spain show dem pepper 2-0 inside Poland on Monday. Di Spanish girls hold ball like say dem own am, come open score line for 13th minute through Marisa Garcia to put Nigeria for tight corner for ArcelorMittal Park. Coach Moses Aduku girls try dia best to equalize di score, but Spain solid defense […]

todaySeptember 8, 2026 11

obodo oyinbo

Qatar Cry Out Say Iran And US Dey Spoil Business For Dem

By: Yusuf Abuh Oya oh, Middle East dey boil like dis, pepper bodi everywia as  Qatar Foreign Ministry spokesperson, Majed Al-Ansari, dey cry give US make dem calm down for di Strait of Hormuz, say oil business dey suffer. According by di oyinbo wey dem speak news statement, “industrial catastrophe naim dey hapun for di strait of Hormuz. Kpler data show say na only about 10 cargo ships dey manage […]

todaySeptember 8, 2026 10

OBODO NAIJA

Obi Hail Seyi Makinde Say E Get Doings To Be President

By: Yusuf Abuh Political shocky shocky naim hapun for Abuja on Monday, dis NDC presidential candidate, Peter Obi, whether messi, abi Maradona confusion gadinma, unto say nobody dey see di next move coming. On Monday na so di presidential candiate enter di inauguration of Allied Peoples Movement, APM presidential candidate, Seyi Makinde, campaign office, say di Oyo state qualify to be presido. Na so everybody shout Shuuuiiii, what do mean, […]

todaySeptember 8, 2026 8

Lagos

Lagos Police Vex, Gbab 4 Suspects Wey Kpai Abroad Returnee

By: Yusuf Abuh Lagos police command dey vex oh, like dis dem arrest four suspent base on Lagos island jungle justice. Lagos Police Command don lock four suspects inside cell after jungle justice beating wey dem take kpai kpai one abroad-returnee, Basit Kolade. Lagos Police tuk, tuk, Abimbola Adebisi, naim dey sorosoke di ogbonge update say dis wahala badness hapun along Freeman Street as Basit and e wife dey drive […]

todaySeptember 8, 2026 8

Politics

Borno Group Say “No Be Like Dat”, Back Commissioner

By: Kofoworola Olayinka Borno coalition of clubs and associations don defend di state Youth and Sports Commissioner, Saina Buba, over im controversial comment say pipu wey no support APC fit face flogging. Di group say di commissioner make di statement by mistake during Tinubu rally for Maiduguri over di weekend, and e no mean to intimidate opposition supporters or undermine democracy. Speaking for Maiduguri, di coalition spokesman, Garba Idi, appeal […]

todaySeptember 7, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds