News-edi 2

1831 Results / Page 17 of 204

Background

obodo oyinbo

Iran Say Hormuz Still Dey Closed, Warn US

By: Kofoworola Olayinka Iran security chief Mohsen Rezaei say vessels wey enter Strait of Hormuz without Iran approval go face sanctions wey fit affect dia insurance and future passage. E insist say di waterway still completely closed, accusing America of lying about ships and oil tankers wey dey cross am through routes near Oman. Rezaei also say Iran don test-fire new anti-destroyer missile over US aircraft carrier as warning say […]

todaySeptember 7, 2026 11

OBODO NAIJA

Dangote Say Drivers, Cooks Fit Buy Shares for Refinery

By: Mariam Ajayi Aliko Dangote tuk say drivers, cooks, traders and other ordinary Nigerians go get chance buy shares for Dangote Refinery through di proposed IPO. E say di offer wey get 4.1 billion shares at N525 each fit raise over N2 trillion and help ordinary people own part of di 700,000-barrel-per-day refinery. Dangote add say investors fit also enjoy dollar-denominated dividends, wey fit help dem handle expenses outside Naija.

todaySeptember 7, 2026 8

OBODO NAIJA

Anambra Police, NSCDC Don Tighten Security for First Lady Visit

By: Mariam Ajayi Anambra Police, Civil Defence Don Begin Security Checks Ahead of First Lady Oluremi Tinubu Visit. Di security agency say di exercise na to identify possible security gaps, check arrangements and strengthen dia readiness around venues, major roads and important facility. Dem also dey focus on threat detection, intelligence sharing, movement control, traffic management, emergency response and protection of lives and property.

todaySeptember 7, 2026 8

OBODO NAIJA

Makinde Say E No Go Bring Back Fuel Subsidy

By: Ayobami Dada Seyi Makinde say if e win 2027 election, e no go bring back fuel subsidy, but e get another plan to make Nigerians benefit from dia oil. E say domestic refineries go dey get crude oil at better price, so local communities fit benefit without high cost. Makinde say di benefit suppose dey inside di crude supply price from di beginning, instead of government secretly spending money […]

todaySeptember 7, 2026 7

Sports

Okonkwo Get Naija Call-Up for AFCON Qualifiers

By: Ayobami Dada Arthur Okonkwo don receive Naija call-up for di AFCON qualifiers against Madagascar and Guinea-Bissau. Di 24-year-old goalkeeper wey dey on loan at Charlton from Wrexham go compete with Stanley Nwabali and Maduka Okoye for starting spot. Naija go host Madagascar for Uyo on September 25 before dem travel go face Guinea-Bissau four days later.

todaySeptember 7, 2026 9

Politics

Peter Obi Say Makinde Qualify to Be Presido

By: Ayobami Dada Peter Obi say Seyi Makinde qualify to become Naija presido for 2027 election. E tok dis on Monday for Abuja during di inauguration of Makinde campaign office, saying e ready work with anybody wey Nigerians genuinely elect. Obi call on politicians to unite and work together to save Naija from hunger, poverty and insecurity.

todaySeptember 7, 2026 9

OBODO NAIJA

Peter Obi Call Make Naija join hands Fight Hunger

By: Damilola Adekunle Peter Obi don call on Naija leaders and citizens to join hand together rescue di country from poverty, hunger and insecurity ahead of di 2027 presidential election. Obi make di call on Monday for Abuja, where e attend di commissioning of Oyo State Gofnor Seyi Makinde 2027 presidential campaign office. Di former Anambra gofnor say Makinde qualify to contest for presido, adding say whoever Naija choose through […]

todaySeptember 7, 2026 9

Sports

UEFA Go Honour Nepal Flood Victims Before UCL Matches

By: Damilola Adekunle UEFA go honour victims of di deadly floods wey hit Nepal before all Champions League matches dis week, with one-minute silence and special banner. Di football body say di banner go carry message “You are not alone Nepal”, as European football family show support to victims and dia families. Di 2026/27 Champions League league phase go start Tuesday, September 8, with 36 teams set to battle across […]

todaySeptember 7, 2026 10

OBODO NAIJA

Oye Say Tinubu Reforms Don Boost Nigeria Economy

By: Kofoworola Olayinka Oye say Tinubu gorment economic reforms don help correct some major problems wey dey weaken Naija economy, but e warn say economic growth must still improve ordinary Naija life. E point to di country $53.11 billion foreign reserves and 4.43 per cent GDP growth for second quarter of 2026 as signs say di economy dey gain momentum. But Oye say di figures no mean prosperity yet, as […]

todaySeptember 7, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds