News-edi 2

1831 Results / Page 21 of 204

Background

OBODO NAIJA

Obi Warn Riggers Say Mehn Don Wise for Di Town

By: Mariam Ajayi Nigeria Democratic Congress,  Presidential Candidate Peter Obi don raise voice dey shout, say  nobody gree  for any kind of vote-stealing or trick come 2027. Obi drop dis heavy bomb on Thursday for inside Port Harcourt town hall meeting. Di former Anambra Gorfnor insist say dis time around, every single vote must enter tally sheet complete without any corner-corner or mago mago-way.

todaySeptember 4, 2026 9

Lagos

Sanwo-Olu Beat Chest Say Nigerians Dey Feel Jagaban

By: Mariam Ajayi Sanwo-Olu don hail Tinubu as man of the pipo, say some pipo dey look am with suspicious eyes. Senior man talk this one on Thursday for the 7th Freedom Online Annual Lecture wey hold for Ikeja, Lagos. E use the August 15 Osun election wey opposition Governor Ademola Adeleke win take give example, say Tinubu dey work day and night to bring better democracy to Nigeria.

todaySeptember 4, 2026 8

Sports

Fury Confirm Say E Go Fight Joshua for New York

Former heavyweight champion Tyson Fury don confirm say e go face Nigerian-British boxer Anthony Joshua for Madison Square Garden, New York. Fury make di announcement for Instagram, but e no mention di exact date for di fight. Joshua and im promoter, Matchroom Boxing, never confirm di venue as of now. Di fight dey expected to happun for November, with November 20 reportedly being  di target date.

todaySeptember 3, 2026 10

obodo oyinbo

Trump Says US and Iran Fight No Go Last Long

By: Mariam Ajayi Trump say US-Iran fight no go last too long, but US fit strike Iran anytime. Trump say America ready to attack Iran anytime, as Tehran vow to unleash new war strategy. Meanwider,Iran Health Ministry say US attacks don kill 18 pipu, including two women and one child. Kermanpour say 142 pipu don sustain injuries from di ongoing US attacks on Iran, including 61 women and 44 minors.

todaySeptember 3, 2026 17

OBODO NAIJA

INEC Warns Of AI Disinformation Ahead 2027 Election

INEC Warns AI-Generated Fake News Fit Undermine Nigeria’s 2027 General Elections INEC Chairman, Professor Joash Amupitan, give di warning on Wednesday for Abuja, during di 13th Annual International Conference of communication scholars and professionals. Amupitan, through INEC National Commissioner Sani Adam, say di commission dey audit im electoral technology systems and dey plan mock presidential election to test readiness for di 2027 polls. INEC say di measures important to identify […]

todaySeptember 3, 2026 12

OBODO NAIJA

Federal Workers Demand N300k Minimum Wage

By: Mariam Ajayi Na Federal Workers Forum write Presido Tinubu and National Assembly, ask make dem increase minimum wage from N70,000 to N300,000. Di group say N70,000 no fit meet workers’ needs because cost of living don high. Dem also want Level 17 officers to earn up to N1.5 million, while urging government to pay outstanding consequential adjustments. Di workers say dem need urgent action to prevent hunger and hardship.

todaySeptember 3, 2026 15

Lagos

Pensioners Protest Lagos Security Men Tear-Gas Dem

By: Mariam Ajayi Civil society groups don condemn Lagos Gornment over alleged tear-gassing of pensioners. Di elderly pensioners protest for Lagos Assembly, demanding payment of their outstanding pensions and gratuities. CSOs don call for investigation and accountability over di incident. Dem say e dey worrying say security operatives dey disrupt peaceful protests, especially when elderly people dey involved.  

todaySeptember 3, 2026 12

Lagos

Lagos Get 10 Private Hospitals For Every One Public Hospital

By: Mariam Ajayi Lagos Health Commissioner, Prof. Akin Abayomi, don reveal say private health facilities for Lagos outnumber public hospitals 10 to one. E say public hospitals still dey handle about 40 per cent of patient visits, putting serious pressure on dia facilities. Abayomi say dis pressure dey help informal health providers spread across di state. E say new task force go strengthen monitoring and protect patients for both public […]

todaySeptember 3, 2026 7

obodo oyinbo

Trump Want Make Dem Change Strait Of Hormuz Name

By: Kofoworola Olayinka US Presido Donald Trump don suggest make dem change di name of Strait of Hormuz to “Trump Strait.” Trump make di suggestion for im Truth Social page, saying America now dey control di waterway. He ask whether dem suppose rename di Strait of Hormuz after am, calling di proposed name “Trump Strait.” Trump even joke say, just like America, di new name go make di place “hotter” […]

todaySeptember 2, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds