News-edi 2

1831 Results / Page 28 of 204

Background

Entertainment

Odumodublvck Don Choose Arsenal League Trophy Over Grammy

By: Kofoworola Olayinka Nigerian rapper Odumodublvck don talk say e go choose Arsenal to win Premier League title over make e win Grammy Award. E make di statement for one viral interview with DJ Semtex, where e talk about im love for Arsenal and dia title chase. Odumodublvck say e meet Super Eagles midfielder Eberechi Eze during New Balance advert shoot after Arsenal lose to Manchester City. E say Eze […]

todayAugust 28, 2026 18 3

Politics

Atiku: Na Me Start Opposition Group

By: Kofoworola Olayinka Atiku Abubakar don reject claim say e dey block opposition group ahead of 2027 election, saying na im start di group. E talk dis while e dey push to unite opposition politicians against APC for di 2027 presidential election. Atiku say most of di politicians wey start di group still dey together despite dia gbege, but Peter Obi and Rabiu Kwankwaso don comot. E insist say na […]

todayAugust 28, 2026 15

obodo oyinbo

Trump Don Comot Maduro From Power for Venezuela

By: Kofoworola Olayinka US Presido Donald Trump don send American forces enter Venezuela on January 3, 2026, where dem reportedly capture Presido Nicolas Maduro and im wife, Cilia Flores, before dem carry dem go America. Trump later tuk say US go oversee Venezuela political transition, while America also move to take control of how Venezuela crude oil go dey sell and how di money go dey handle. Di move mean […]

todayAugust 28, 2026 19

crime& security

Military Vehicle Crash Kpai Five Traders for Taraba Market

By: Kofoworola Olayinka Five traders don reportedly kpai while several others sustain injuries after military vehicle from FOB Wukari crash into people for Peva Market, Takum LGA, Taraba State, on Wednesday afternoon. Resident, Tony David, confirm di incident, saying di victims dey display dia goods by roadside when di military vehicle lose control and hit dem. Di vehicle dey escort traders from Wukari to Takum to provide security because of […]

todayAugust 28, 2026 14

crime

Niger Kidnap Gbege: Gornment No Still Hear From Terrorists

By: Kofoworola Olayinka Niger State Gornment say dem never hear from terrorists wey abduct worshippers during Friday prayers for Borgu LGA on August 21. Commissioner for Information, Obed Nuhu, disclose dis on Thursday, saying di attack happen for three different locations and suspected Lakurawa and Boko Haram carry am out. Nuhu say gornment still no know di exact number of people wey dem carry go, because di kidnappers never contact […]

todayAugust 28, 2026 13

OBODO NAIJA

Atiku Tell Tinubu: Your Time Don Reach, Prepare Handover

By: Kofoworola Olayinka ADC presidential candidate, Atiku Abubakar, don knock Presido Tinubu gornment over promise to reduce transport fares, saying di policy come too late after fuel subsidy removal. Atiku say di gornment fail to cushion di high cost of living, adding say only about 120,000 vehicles don convert to CNG in more than three years. E say di figure na less than one per cent of about 14 million […]

todayAugust 28, 2026 13

obodo oyinbo

Norway King Harald V Don Kpai at 89

By: Kofoworola Olayinka Norway King Harald V don kpai  at age 89 on Friday after more than 30 years for di throne, with im 53-year-old son, Crown Prince Haakon, automatically taking over as king. Britain King Charles III mourn di death, describing Harald as im dear cousin and a big figure wey guide Norway through plenty changes. NATO Secretary General Mark Rutte and European Commission President Ursula von der Leyen […]

todayAugust 28, 2026 9

Education

WAEC 2026 Results Don Enter Fresh Gbege

By: Kofoworola Olayinka WAEC official for Anambra, Olanrewaju Fadehan, don blow whistle over alleged glitches and irregularities for di 2026 school candidates results wey examination body release. Fadehan talk for viral video say students wey write di computer-based exam na dem suffer di wahala pass. E say di problem show around di period WAEC suppose release di results between August 3 and 5, 2026, as dem normally release am on […]

todayAugust 28, 2026 10

Sports

Masai Russell Scatter Tobi Four-Year World Record Four Zurich

By:Mariam Ajayi American hurdler Masai Russell don blaze through 100m hurdles in 12.09 seconds for Zurich Diamond League, beating Tobi Amusan. Amusan start di race well, but Russell increase speed for middle of di race and leave everybody behind. Tobi Amusan finish second with season-best 12.23 seconds. Di result give Russell di big win, while Amusan settle for second place for di race.

todayAugust 28, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds