News-edi 2

1831 Results / Page 30 of 204

Background

Sports

Chelsea Wan Sign Atalanta Young Defender Honest Ahanor

By:  Mariam Ajayi Chelsea dey in talk to sign Atalanta defender, Honest Ahanor, with di Italian club ready to sell di  highly-rated 18-year-old if Chelsea fit meet dia €40m (£34.3m) price. According  to report, Chelsea first show interest in Ahanor when dem dey negotiate di signing of Atalanta right-back Marco Palestra for July. Ahanor, wey mainly dey play left-back, join Atalanta from Genoa last summer for around €16m, with another […]

todayAugust 27, 2026 13

OBODO NAIJA

Nasarawa Gofnor Order Torchlighting Untop Missing Hospital Tins

By: Mariam Ajayi Nasarawa State Govo, Abdullahi Sule, don order immediate torchlighting into reported missing mattresses and fans wey dem donate to Umaisha General Hospital for Toto Local Government Area. Di  matter come up after lawmaker representing Umaisha/Ugya constituency for Nasarawa State House of Assembly, Sa’ad Abdullahi, raise alarm say hospital staff no fit account for some medical items wey e buy and donate to di facility. Di lawmaker, wey […]

todayAugust 27, 2026 8

Sports

Ander Herrera Go Back To Real Zaragoza

By: Mariam Ajayi Former Manchester United midfielder, Ander Herrera, don return to hin boyhood club, Real Zaragoza, after 15 years away, e say to play for di Spanish side for free na dream come true for am. Di 37-year-old midfielder join on  free transfer from Boca Juniors as e look to help di club rebuild and return to better days. Herrera start hin professional football career with Zaragoza before e […]

todayAugust 27, 2026 11

OBODO NAIJA

Army and Immigration Join Hand To Tighten Border Security For Yobe

By:Mariam Ajayi Nigerian Army and Nigerian Immigration Service don promise to work more together to strengthen border security, manage migration and tackle new security threat for Yobe State. Dem make di commitment on Wednesday when Commander Headquarters Sector 2, Joint Task Force North East, Operation HADIN KAI, Brigadier General Edet Effiong, receive di newly posted NIS Yobe Comptroller, Comptroller IZ Abubakar, during a courtesy visit to di Sector Headquarters for […]

todayAugust 27, 2026 10

OBODO NAIJA

Kwara Police Commissioner Start Surprise Inspection For Police Divisions

By: Mariam Ajayi Kwara State Police Commissioner, Ojo Adekimi, don start surprise inspection of police division and formation across di state to check officers discipline and work condition. Di inspection, wey start on Wednesday, cover Area Command, Metro, Ilorin, plus 12 divisional police headquarter inside Ilorin metropolis. Di State Police Public Relations Officer, Adetoun Ejire-Adeyemi, fry mouth on top dis mata for statement on Thursday. She tok say di exercise go […]

todayAugust 27, 2026 14

OBODO NAIJA

Federal Gorment Say 60% Of Active Electricity Customers Get Meter

By: Mariam Ajayi Federal Gornment don announce say 60 per cent of active electricity customer for Nigeria don get meter as gornment dey work to end estimated bill. Government say 668,000 meter don already dey installed out of di 1.033 million meters delivered under di World Bank-backed programme. Di initiative, wey include Presidential Meter Initiative, dey target di electricity metering gap and stop arbitrary estimated bill for registered customer.

todayAugust 27, 2026 11

Politics

Makinde Pick Anthony Ehilebo As Media Adviser For Im 2027 Campaign.

Oyo State Gofnor and presidential candidate of di Allied Pipo Movement, Seyi Makinde, don appoint Anthony Ehilebo as hin Special Adviser on Media and Digital Communication. Makinde media aide, Sulaimon Olarenwaju, announce di appointment for Ibadan, say e don take immediate effect, while more campaign team appointments go follow. Makinde say Ehilebo’s experience as communication strategist and lawyer go help push APM message and campaign to reset Nigeria ahead of […]

todayAugust 27, 2026 15

Sports

Italy Withdraw Support For Infantino FIFA Re-Election

By: Yusuf Abuh Italy Football Federation don withdraw dia support for FIFA Presido Gianni Infantino re-election bid, as concern over FIFA governance continues to grow. FIGC make di decision to align with UEFA and Presido Aleksander Čeferin, following controversy over plans to sell 20 per cent stake in FIFA commercial rights company to private investors. FIGC boss Giovanni Malago say dem want football system wey dey based on merit, solidarity, […]

todayAugust 27, 2026 19

obodo oyinbo

How Nepal Floods Kpai kpai Over 160 People As 403 People Missing

By: Yusuf Abuh At least 160 people don die and 403 others still missing after heavy floods and landslides hit northern Nepal near Tibet border on Wednesday, destroying whole communities. Nepali police say dem don recover 157 bodies, while Chinese state media report three deaths and 265 people missing for di Chinese side of di border. Nepal tourism ministry say 403 tourists, including 341 foreigners, don also go missing hours […]

todayAugust 27, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds