News-edi 2

1831 Results / Page 29 of 204

Background

obodo oyinbo

Irab Write Conditions Like NEPA Bill To Open Strait Of Hormuz

By: Mariam Ajayi Iran security chief, Mohsen Rezaei, don tuk say Tehran dey prepare long list of conditions before dem go open Strait of Hormuz. Qatar Prime Minister don travel go Tehran go beg Iran make dem calm down, but Iran no gree. Meanwider, US gorment pipo say Iran action na just initial gragra as American naval blockade still tight. Di mata don turn serious gbas-gbos between Iran and America, […]

todayAugust 28, 2026 11

Politics

President Tinubu and APC Govo Jam Head to correct Campaign

By: Mariam Ajayi Presido Bola Tinubu and APC gofnors don hold closed door meeting for Aso Rock to settle di gbege wey dey happun for di party over 2027 campaign list. Vice Presido Kashim Shettima also meet di gofnors for NEC meeting before dem enter Presido Tinubu office to discuss di mata. Di political palava don dey ground since Wednesday as party leaders dey meet back to back to calm […]

todayAugust 28, 2026 10

OBODO NAIJA

High Court Give NDLEA Gbas Gbos, Make Dem Free KC Luxury

By: Mariam Ajayi Lagos Federal High Court Judge, Justice Friday Ogazi, just give NDLEA hot query make dem carry body bring social media big boy KC Luxury, come face court after dem suuk am for cell for 14 solid days like garri inside water without even charging am to any crime. AS KC Luxury lawyer wire the court ex parte motion, na so Baba Judge,  come tell the drug officers […]

todayAugust 28, 2026 16

Entertainment

Ayra Starr Go Make History for NFL London Halftime Show

By:Mariam Ajayi Afrobeats star Ayra Starr go become first major African artist to headline NFL halftime show when she performs for Philadelphia Eagles and Jacksonville Jaguars game for London on October 11. NFL announce di performance on Thursday, with Ayra Starr also confirming am for her Instagram page. Di game go hold for Tottenham Hotspur Stadium, London, as part of NFL 2026 International Games. Ayra Starr say she dey excited […]

todayAugust 27, 2026 16 1

OBODO NAIJA

Edo Gov Swear In New Commission Boss

Edo State Gofnor, Monday Okpebholo, don swear in Terry Igiebor and Shittu Shaibu as chairmen of two state commissions for Benin on Thursday, to improve ecological management and electricity regulation. Prof. David Osifo, Thomas Inegbedion, Abdulrask Abubakar, Alex Oniawu and Patrick Iluobe also join as members. Okpebholo congratulate dem and say dia appointments come with big responsibility. E say di electricity commission especially important to help improve power supply and […]

todayAugust 27, 2026 17

OBODO NAIJA

65 Nigerians Comot South Africa On Top Foreigners Wahala

By: Mariam Ajayi Another 65 Nigerians don return from South Africa as xenophobic attack and protest against foreigners. The returnees, wey include 30 adults, 34 children and one infant, arrive Lagos on Wednesday night through South African Airways. Foreign Affairs Minister, Bianca Odumegwu-Ojukwu, say private individuals fund the repatriation. She appeal to state governments to support the returnees, especially those wey leave their businesses and properties for South Africa.

todayAugust 27, 2026 14

OBODO NAIJA

Police Track N3.6bn Yahoo Money From Crypto

By: Mariam Ajayi Nigeria Police Cybercrime Centre, don trace more dan N3.6 billion suspected criminal money tru cryptocurrency conversion scheme. AIG Akaninyene Ezima disclose dis for Abuja, saying one Business Email Compromise suspect don make over N100 million from cyber fraud. E also say investigation into sextortion and romance scam uncover several victims linked to di same criminal identity.

todayAugust 27, 2026 11

OBODO NAIJA

Accord Candidate Say Petrol Fit Drop to ₦200 Under Hin Gorment

By: Mariam Ajayi Accord Party presidential candidate, Gbenga Olawepo Hashim, don tok say petrol no suppose pass ₦605 per litre if Accord enter gornment. Hashim say ₦605 go be di sustainable start price, and with time, petrol price fit drop reach as low as ₦200 per litre. E insist say cheap petrol no go affect government revenue or money wey dey enter FAAC. Di Accord candidate, wey oppose removal of […]

todayAugust 27, 2026 11

OBODO NAIJA

Federal Gorment Start Nationwide Toktok for New National Water Compact

By: Mariam Ajayi Federal Gorment don begin nationwide consultation with states and other stakeholders to develop a National Water Compact wey go help tackle Nigeria water and sanitation problems and strengthen water security across di country. Minister of Water Resources and Sanitation, Prof. Joseph Utsev, disclose dis on Thursday for Abuja during di stakeholders’ consultation workshop for di development of Nigeria National Water Compact. Utsev say di initiative important because […]

todayAugust 27, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds