News-edi 2

1834 Results / Page 58 of 204

Background

OBODO NAIJA

Umahi Talk Say Tinubu Back Am After Calls For Sack Over Staff Death

By: Yusuf Abuh Works Minister David Umahi don reject calls for Presido Bola Tinubu to remove am from office after di death of one female staff member for him private residence. Umahi, for one video wey trend on X on Monday, say some people try use di matter do politics but Tinubu tell am make e focus on building more roads for Nigerians. Di minister talk say power no dey […]

todayAugust 3, 2026 11

Lagos

LAWMA Don Lock Shop! Dirty Business Owners For Lagos Don Enter One Chance

By: Esther Daniel No be small Kasala for Ikotun, Igando and Alimosho as LAWMA storm di area on Saturday say hand touch some  market pipo dia, na so dem lock shops and businesses wetin nor good sake of say dem nor clean dia stores environment. All wetin di environment pipo dey tell dem, e be like say dem deaf. Di enforcement team from LAWMA Project WISE West enter area lock […]

todayAugust 3, 2026 15

OBODO NAIJA

Former President Goodluck Jonathan Enter Aso Rock Meet President Bola Tinubu Behind Closed Doors

By: Esther Daniel Former Presido Goodluck Jonathan hold secret closed-door talks with Presido Bola Tinubu inside Aso Rock Villa for Abuja on Sunday to discuss silent plans about di 2027 presidential election. One media report di private meeting inside di Presidential Villa on Sunday through dia political correspondents to explain why no official statement come out after di discussions. Tanimu Turaki PDP faction submit Jonathan credentials through formal documentation give […]

todayAugust 3, 2026 14

OBODO NAIJA

Political Analyst Kabiru Ojo Blast FG Student Loan Scheme On Sunday

By: Esther Daniel Political analyst Kabiru Ojo criticize di Federal Gornment student loan scheme during one exclusive interview with one media channel on Sunday to reveal how di policy dey cause more suffering for parents and students. Ojo expose di flaws of di scheme inside Abuja on Sunday through im press statement to show say over 70 percent of Nigerian students never get di loan. Di analyst condemn di gornment […]

todayAugust 3, 2026 43

Sports

Osimhen Score as Galatasaray Draw 3-3 With Rennes

By: Yusuf Abuh Victor Osimhen score one goal as Galatasaray play 3-3 draw with French club Rennes for pre-season match on Sunday, but di Turkish champions still never win any of dia three friendly games. Osimhen open di scoring for Galatasaray inside di 18th minute before Esteban Lepaul equalise, later score two more goals complete hat-trick and put Rennes ahead 3-2. Gabriel Sara also score for Galatasaray before Baris Yilmaz […]

todayAugust 3, 2026 11

obodo oyinbo

Iran Mark Present for Peace as US Suspend Fresh Attack

By: Yusuf Abuh Iran don bring out chest say, dem don reach peace agreement with Oman to open di Strait of Hormuz, since U.S don decide to respect demselves to end di war for inside middle east. U sabi say, US Presido Donald Trump say America and Israel agree say dem nor go fire tins enter Tehran, since dem don agree to tuk peace Since February 28, US, Israel and […]

todayAugust 3, 2026 12 1

OBODO NAIJA

SDP Presidential Candidate Adebayo Tell Tinubu To Park Im Kaya From Aso Rock

By: Yusuf Abuh Social Democratic Party presidential candidate, Adewole Adebayo, don tok say wi oga Presido, Bola Tinubu don already defeat himself ahead of the 2027 general election. Im yarn dis one TV sit down tuk say di gornment never solve poverty, insecurity and other governance problems, and say na why many Nigerians dey disappointed. E come advise Nigerians make dem face issues wey concern di country instead of putting […]

todayAugust 3, 2026 13

Lagos

Suspected Cult Boys Kpai Security Guard for Yaba

By: Yusuf Abuh Suspected cult boys don kpai one security guard  allegedly wey dem identify as Godwin for Abule Ijesha area of Yaba, Lagos, and dis one sef sup on Saturday. According to eye witness di attackers come with motor, meet am near where e dey work, shoot am for head and later use axe attack am. And dis one cause serious serious panic for di community. However, as at […]

todayAugust 3, 2026 11

OBODO NAIJA

Heavy Flood Don Swallow Delta High Court, Houses and Shops for Agbarho

By: Esther Daniel Heavy flood on Friday morning don cover Delta State High Court, houses and business places for Agbarho community in Ughelli North Local Gornment Area after overnight heavy rain from Thursday night . Residents say communities like Orhokpokpor, Ehwere, Ughrwughelli and Oviri suffer serious damage as flood destroy furniture, electrical appliances, food items, clothes and other valuables inside many homes. Shop owners suspend business while motorists and pedestrians […]

todayJuly 31, 2026 28

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds