News-edi 2

1833 Results / Page 56 of 204

Background

OBODO NAIJA

Wike Say Fubara Miss Second Term Chance Over Rivers Crisis

By: Esther Daniel FCT Minister Nyesom Wike talk on Tuesday say di political crisis for Rivers State don cost Gornor Siminalayi Fubara im chance to contest for second term. Wike yarn during im monthly media chat say wrong advice from political allies and outside interests make Fubara abandon di political structure wey bring am to power. Di former Rivers governor reveal say e warn Fubara several times make e no […]

todayAugust 4, 2026 14

Entertainment

Opeyemi Famakin Reveal Wetin Push Am Into Food Criticism

By: Esther Daniel Career story don come outside as popular Nigerian food critic Opeyemi Famakin reveal say na im mama love for food inspire am to enter food journalism and criticism, no be because e wan become influencer. Famakin make di revelation during one interview wey come out on Tuesday, explain say food don always dey at di centre of im family life from when e be small. According to […]

todayAugust 4, 2026 22

OBODO NAIJA

Wike Vow Say Na Only Tinubu Fit Win Rivers For 2027

By: Esther Daniel FCT Minister Nyesom Wike declare inside Abuja on Tuesday say President Bola Tinubu na di only candidate wey fit win Rivers State for di 2027 elections through one strong political coalition. Wike tell tori people say any candidate wey dey count Rivers votes dey waste time because im people don already pitch dia tent with di Presido. Di former gofnor explain di matter say politicians from PDP, […]

todayAugust 4, 2026 14

Sports

Cameroon, Morocco And Algeria Qualify For Wafcon 2026 Quarter-Finals

By: Esther Daniel Cameroon, Morocco, and Algeria don carry ticket go WAFCON 2026 quarter-finals after strong group performance. Cameroon top Group D with six points after dem beat Ghana 1-0 on Sunday. Host nation Morocco top Group A with seven points after 0-0 draw against Senegal on Monday night, while Algeria beat Kenya 2-0 to qualify second.

todayAugust 4, 2026 14

Lagos

Lagos Water Project Don Move, New Pump Equipment Land for Iju, Adiyan

By: Esther Daniel Lagos water matter don receive fresh ginger as State Gornment on Tuesday take deliver new pumping equipment to upgrade Iju and Adiyan Waterworks. Environment Commissioner Tokunbo Wahab confirm di development through im X handle, say di equipment na part of Gofnor Sanwo-Olu administration plan to strengthen water infrastructure. Di new machines go replace old pumping systems and help improve clean water supply for millions of Lagos residents. […]

todayAugust 4, 2026 11

OBODO NAIJA

Osun Election Fire Don Start, Adeleke Vow Say Victory Must Be His

By: Esther Daniel Political battle don hot as Osun Gofnor Ademola Adeleke on Monday declare for Osogbo say e go win di August 15 gofnorship election if di process free and fair. Adeleke appeal to Presido Bola Tinubu make gornment protect voters and direct security agencies to stop violence, after im claim say people dey lose dia lives. Di gofnor warn against any attempt to manipulate di election, urging supporters […]

todayAugust 4, 2026 20

Lagos

Oriade LCDA Don Bubble, Olojede Celebrate One Year with Better Package

By: Esther Daniel Better things don land for Oriade LCDA as Chairman Rasaq Olojede on Monday celebrate one year for office by launching free medical outreach and skills training for residents. Di council boss share free glasses, drugs and tailoring tools give youths and women, say di programme na to improve people life and help more residents stand on dia own. Olojede promise residents say more development projects and people-focused […]

todayAugust 4, 2026 17

Sports

Heskey Drop Man United Transfer Advice, Enzo Fernandez Fit Be Casemiro’s Successor

By: Esther Daniel Transfer gist dey as former Aston Villa striker Emile Heskey tip Manchester United to go for Chelsea midfielder Enzo Fernandez as di man wey fit replace Casemiro. Heskey yarn say Enzo’s quality and World Cup-winning experience fit give United di strength dem need to battle Arsenal, Liverpool and Manchester City for Premier League title dis season. Casemiro don pack im bag comot Old Trafford for Inter Miami, […]

todayAugust 4, 2026 9

obodo oyinbo

Blood Don Flow, Drone Strike Scatter Russia Beach As Seven People Kpai

By: Esther Daniel Sunday fun turn nightmare as drone strike hit Arkhipo-Osipovka beach for Krasnodar, Russia, kill seven people including three pikin and throw di area into panic. Gofnor Veniamin Kondratyev accuse Ukraine of targeting civilians, say 40 people wunjor and 17 pipo still dey hospital for treatment. People wey witness di attack tok say dem hear gunfire before one heavy blast as Russian air defence try stop di drone […]

todayAugust 4, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds