News-edi 2

1834 Results / Page 70 of 204

Background

Education

FG Reduce Textbook Assessment and Ranking Fee

By: Esther Daniel Federal Goment don reduce money wey publishers and authors go pay to assess and rank textbooks, as dem dey prepare to start di National Textbook Ranking System. NERDC Executive Secretary, Salisu Shehu, tok dis one for statement wey dem release on Wednesday for Abuja, say assessment fee don drop from ₦2,000 to ₦1,500 per page, while ranking fee reduce from ₦1 million to ₦750,000 for each textbook. […]

todayJuly 22, 2026 17

Sports

Arsenal Sign Real Madrid Captain Misa Rodriguez On Free Transfer

By: Esther Daniel Arsenal Women don complete di signing of Real Madrid captain, Misa Rodriguez. Di 27-year-old goalkeeper join di English club after im contract with Real Madrid expire. Rodriguez go add more strength to Arsenal goalkeeping department wey already get Daphne Van Domselaar, Anneke Borbe and Isabella Damm. Di Spanish goalkeeper make 215 appearances for Real Madrid and also don represent Spain 24 times. She become Arsenal seventh signing […]

todayJuly 22, 2026 19

Entertainment

VDM Join Police Raid Alleged Baby Factory For Abuja Over Seven-Day-Old Baby Sale

By: Esther Daniel Social media activist, Martins Vincent Otse, popularly known as VeryDarkMan (VDM), don join operatives of di Nigeria Police Force Special Tactical Squad (STS) for raid of one alleged baby factory for Karshi area of Abuja. Di operation happen after allegation come out say dem dey sell one-seven-day-old baby. VDM share videos of di operation for im official social media page, e show how e follow police officers […]

todayJuly 22, 2026 25

OBODO NAIJA

Gunmen Attack Benue Village, Kill 15-Year-Old Boy

By: Esther Daniel Gunmen don attack Olahimu village for Ugboju District, Otukpo LGA of Benue State on Monday around 7:00am, kill one 15-year-old boy, Muhammad Isiyaku. Di attack leave one pesin missing and dem report say hundred of cattle don disappear as restulers tif dem, as residents abandon dia homes over fear of more attacks. According to the family, di attackers target cattle belong to late Ardo Risku Muhammad family, […]

todayJuly 22, 2026 18

Sports

Ola Aina Say Arsenal No Be Option for Am

By: Esther Daniel Super Eagles defender Ola Aina don laugh brush aside talk say e fit join Arsenal, as one Nigerian fan ask am di question during Wimbledon. Aina wey dey 29 years, reply with smile say, "I too old for Arsenal." Di defender don spend three seasons with Nottingham Forest after e join di club from Torino for 2023, and before dat e also play for Fulham. Even though […]

todayJuly 22, 2026 15

OBODO NAIJA

former Taraba Deputy Gov Tell Atiku, Obi Make Dem Join APC

By: Esther Daniel Former Deputy Governor of Taraba State, Alhaji Armayau Abubakar, don call on opposition leaders like Atiku Abubakar and Peter Obi make dem support President Bola Tinubu and join di All Progressives Congress (APC). Abubakar make di call on Tuesday for Abuja, where e talk say Nigeria no suppose get opposition at dis time because di APC government don achieve enough to compare with oda political parties. According […]

todayJuly 22, 2026 23

OBODO NAIJA

Dalung Say Tinubu Dey Work Hard to Lose 2027 Election

By: Esther Daniel Former Minister of Sports, Solomon Dalung, don tuk say oga Bola Tinubu dey "work very hard" to lose di 2027 presidential election because of di economic hardship and insecurity wey Nigerians dey face. Dalung make di statement on Tuesday through im X account, wia e argue say gornments no dey lose election because opposition strong pass, but because dem lose touch with di people. According to am, […]

todayJuly 22, 2026 13

Entertainment

Burna Boy Make History For Spotify With World Cup Song

By: Esther Daniel Nigerian Afrobeats star, Burna Boy, don make history as di first male artiste wey reach number one for Spotify new Global Music Video Chart. E achieve di record with 'Dai Dai', im World Cup song wey e sing with Shakira, make am di first African and first male artiste to top di chart. Di song also climb reach number 13 for Billboard Hot 100 dis week and […]

todayJuly 22, 2026 22

OBODO NAIJA

Benjamin Kalu Office Deny N1bn Church Instrument Budget Tori

By: Esther Daniel Nor be small tin, na everyday money dey vanish, like dis Office of Deputy Speaker of House of Representatives, Benjamin Kalu, don deny report, which be say dem N1 billion for 2026 budget for music instrument, say na fat lie. For statement wey Chief Press Secreto Levinus Nwabughiogu release on Wednesday, di office tok say di report na anyhow, yamayam tuk. According to di statement, di actual […]

todayJuly 22, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds