Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

 Police and local hunters kpai three kidnappers, rescue victim for Oyo State

By : Jolayemi Olajide Oyo State Police Command don tuk say dem Rambo style kpai three suspected kidnappers and rescue one person wey dem bin kramp for Otu area inside Oke-Ogun axis. Di police tuk, tuk, DSP Ayanlade Olayinka, clear dis one for statement wey im release on Tuesday. Dem talk say the heavy operation hapun after local hunters call dem for help on Monday, May 25, 2026, when the bad boys open fire on top dem inside bush. True […]

todayMay 26, 2026 22

obodo oyinbo

Naija and Türkiye Sign Big Deal to Take Mining to Next Level

By : Jolayemi Olajide Naija and Türkiye don sign fresh agreement for Istanbul to join hand work for solid minerals and mining mata. Nigeria Minister of Solid Minerals Development, Dele Alake, naim use im yamchop mouth break di news say Baba Tinubu support di movement. Alake say di country don ready to work with the Turkish gornment to change how they dey manage mining, train pipo, and bring beta development. He con add say di new changes inside Naija mining […]

todayMay 26, 2026 20

OBODO NAIJA

Tinubu salute Muslims for Eid, say goment dey work round di clock to fix Naija

  By : Jolayemi Olajide Wi oga Presido, Bola Tinubu don assure Nigerians say all the reforms wey im goment dey do go continue and dat im dey mout mehn to handle security, steady economy, and progress. Inside im 2026 Eid-el-Kabir message wey comout on Tuesday before Wednesday celebration, baba Seyi salutate all Muslims for Nigeria and across di world. Tinubu talk say true-true, im know say some areas still dey face security wahala like terrorism and banditry and dat […]

todayMay 26, 2026 27

obodo oyinbo

How Israel Heavy Bombing Kpai 11 Pipo For Lebanon

By : Jolayemi Olajide Israeli air strikes don go kpai at least 11 pipo and wound 15 others inside eastern Lebanon, as the small peace agreement between them dey face big trouble.The attack block di village of Mashghara inside Bekaa Valley on Monday night, and Lebanon government news konfam say everywia scatter.Prime Minister Benjamin Netanyahu tuk say im give order make army drop heavy bomb join after Hezbollah pipo do dia own attack.Now, the Israel military kon talk say dem […]

todayMay 26, 2026 17

Sport Yarns

Milan Fire Coach Allegri As Dem Fail To Enter Champions League

By: Esther Ayoola AC Milan don officially sack dem coach, Massimiliano Allegri, and dem don also change plenty things for di club management afta di team finish fifth for Serie A. Di club tuk say di way di team take collapse for di end of di season and how dem fail to qualify for Champions League na complete failure. Allegri just come back for his second time as Milan coach last year May 2025, when e replace Sergio Conceição. But […]

todayMay 26, 2026 21

Sport Yarns

Evra Pick Osimhen As The Dream Striker For Manchester United

By: Esther Ayoola Former Manchester United star Patrice Evra don drop micro soft word, say Naija striker, Victor Osimhen, na di dream player wey United need to buy for next season. Osimhen, wey dey play for Galatasaray right now, once a again don dey get call from Premier League sides. Even though plenty gist don carry am go different English clubs from Merseyside reach West London, no single deal yet. Instead, di 27-year-old ballast dey fire goals for Turkey, as […]

todayMay 26, 2026 30

Sport Yarns

Aruna Quadri Fall Hand For World Ranking, Drop To Number 4 For Africa

By: Esther Ayoola Naija table tennis star, Quadri Aruna, don fall hand for di latest ITTF world ranking as e drop down by 20 places go 76th position. Dis na di first time since 2014 wey di Nigerian champion go drop out of di top two players inside Africa. Before now, na only Aruna and his Egyptian rival, Omar Assar, dey control di continent, but now two other players don pass Aruna for ranking. Egypt’s Youssef Abdel-Aziz and Algeria’s Mehdi […]

todayMay 26, 2026 54

obodo oyinbo

Tragedy For Philippines, Four Kpai As Nine-Storey Building Collapse

By: Esther Ayoola Emergency officials for Northern Philippines don stop de two-day rescue operation to find at least 12 pipo wey dem believe say dey trap inside one collapsed building. Dis nine-storey building collapse put for one hotel near Angeles City on Sunday, and e don kill four pipo so far, including one Malaysian man and two construction workers. According to report, dem bin dey get hope say dem go rescue workers go save more pipo, but everything don jam […]

todayMay 26, 2026 23

OBODO NAIJA

US Bomb Iran Again As Peace Tuk Dey Happen For Qatar

By: Esther Ayoola America don launch fresh air strikes for southern Iran, even as top Iran negotiators gather for Qatar to discuss peace deal with Washington. US military tuk say dem carry out di attack to protect dia soldiers from threats by Iranian forces, while di targets include missile launch sites and boats wey bin dey waka kukere waka for sea. Iranian sources sti claim say some IRGC fighters die after the strikes, afta di group allegedly attack one vessel […]

todayMay 26, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds