Blog masonry

Background

National

Amaechi Reject ADC Presidential Primary Say Atiku Play Wuruwuru

Former Minister of Transportation, Rotimi Amaechi, don reject di results of di African Democratic Congress (ADC) presidential primary election wey hold on Monday. Amaechi yarn for im X handle say di election wuruwuru full inside Di former Rivers State Governor claim say dem block many party members from across di country make dem no vote,  as dem announce former vice presido Atiku Abubakar as winner, say di tin pain am, everywia blur. Amaechi, say im nor gree di result and […]

todayMay 27, 2026 14

south west

Army Send Special Forces To Rascal Bad Boys

Di Chief of Defence Staff, General Olufemi Oluyede, don order make dem deploy special forces and plane elements to Oyo State sake of di recent kidnapping wahala. Di Director of Defence Media Operations, Maj. Gen. Michael Onoja, tuk dis one for Abuja on Tuesday as he give update on top di work wetin army do for May. Onoja sti assure residents say soldiers nor go rest at all until dem catch all di kidnappers and bring total peace back to […]

todayMay 27, 2026 15

Lagos

Lagos Fire Service Call For Joint Action As Dem Plan Big Conference For Ikeja

Lagos State Fire and Rescue Service dey call for beta join-hand action for di whole country to stop fire disaster before di 2026 Lagos International Fire Safety Conference (LIFSC) start. Di big meeting, wey dem tag LIFSC 3.0, go hold from July 6 to 8 inside Ikeja, and di main tuk na how to stop fire for inside buildings and market places. Oga kpata-kpata for Lagos Fire Service, Margaret Adeseye, con fry mouth say, fire safety no be gornment work […]

todayMay 27, 2026 19

Lagos

Lagos Police Gbag Iron Damage Man Say Im Fake Im Own Kidnap

Lagos State Police Command say dem gbab one scrap iron dealer, and im friends, say wey dem chout iron damage, iron damage na pipo dem dey kidnap, dey damage pipo peace. Lagos Police Commissioner,  Fatai Tijani,  naim dey break dis news on Tuesday give journalists for dia headquarters for Ikeja. According to di senior officer, di iron damage guy even fake im  own kidnap because he wan use format take acollect 1.5 million naira from im oga .

todayMay 27, 2026 16

Lagos

Lagos Gornment Recover ₦270m From 419 House Agents

Lagos State Gornment don announce say dem kpake over 270 million naira  from di hand of 419 estate agents and house developers to give di owners  wey dem cheat. Di Commissioner for Housing, Moruf Akinderu-Fatai, naim dey break dis news on Tuesday during di 2026 Ministerial Press Briefing wey happen for Alausa, Ikeja. In fact Akinderu-Fatai rake full newsppaer, say dis money wey dem recover, na just omomo doings and dat dem ready to even do more dat security choke.

todayMay 27, 2026 15

Lagos

Baba Sanwo-Olu Greet Muslims For Eid-el-Kabir

By : Jolayemi Olajide Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, don congratulate all Muslims for Lagos and Nigeria as dem dey celebrate dis year Eid al-Adha Inside statement wey im Special Adviser on Media and Publicity, Gboyega Akosile, release on Tuesday, de govo tell pipo make dem hold di values of sacrifice, peace, and unity strong-strong. Sanwo-Olu say di festival dey remind everybody about how faith, patience, and to live with peace inside community take mata. He add say de celebration […]

todayMay 26, 2026 28 4

OBODO NAIJA

Lagos Police Burst Kidnap, Robbery Gangs, Kpai Four Suspects for Gun Battle

By : Jolayemi Olajide Lagos State Police don knack chest say dem block one major gbege for inside the state, as dem burst serious kidnap and robbery gangs, come kpai four suspects during heavy gun battle. The Senior Man for the Command, Commissioner of Police Tijani Fatai, naim yan this one give aproko people during dia monthly press briefing for the Force Headquarters. According to CP Fatai, the gallant operatives scata one dangerous kidnap plan for Ejigbo area. When the […]

todayMay 26, 2026 17

Sport Yarns

Manchester City Appoint Enzo Maresca As Dem New Coach To Replace Pep Guardiola

By : Jolayemi Olajide Manchester City don confirm say dem don appoint Enzo Maresca as dia new head coach, and di deal go run till June 2029. Maresca dey replace Pep Guardiola to start new levels for Etihad Stadium after the two sides agree on everything. The 45-year-old Italian coach go take over first-team work immediately and im go also join hand arrange the players wey the club go buy before the new season start.

todayMay 26, 2026 24

OBODO NAIJA

Court throwey case to block Goodluck Jonathan from 2027 election

By : Jolayemi Olajide Federal High Court for Abuja don throwey di case wey some pipo file to stop former Presido Goodluck Jonathan not to enter the 2027 presidential election. The court say di case na total waste of time and mouth-wash.Because of this one, the judge order the person wey carry the case come make he pay Jonathan N21 million for all di stress. As if dat one no do, the court still talk say the person must pay […]

todayMay 26, 2026 27

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds