Blog masonry

Background

Lagos

Lagos Internal Revenue Service Drag Lagos Employers for Tax Returns

By: Esther Ayoola Lagos State Internal Revenue Service, LIRS, don dey drop  reminder again, dat make  all employers for Lagos ensure say, by January 31, 2026 make dem submit  dia tax returns for 2025 financial year. For statement wey office release, LIRS Chairmo, Dr Ayodele Subair, tuk say, di order, dey under Nigeria Tax Administration Act 2025, and employers must declare all workers’ pay and pay correct tax. Oga Ayodele warn say any company wey no comply go face penalties […]

todayJanuary 16, 2026 16

Lagos

Makoko Residents Block Road Gorment Demolish Dia Building

By: Esther Ayoola Residents of Makoko, Ilaje Aiyetoro Community, Yaba, say nor be small matching dem do for Lagos State House of Assembly yesterday, block part of di road dey protest say gorment go demolish dia buildings. Di protesters, wey be affected residents, dey beg Lagos Gornment make dem limit di demolition to 100 metres, and dat if dey continue di way dem go, say plenty families go dey homeless. According to di protesters, di demolitions dey destroy livelihoods and […]

todayJanuary 16, 2026 20

National

President Tinubu Hail Baba Bisi Akande at 87, Call Am Pillar of Democracy

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu like dis, dey cut cap for senior govo, di b4, b4 govo Osun State  and APC pioneer chairmo, Chief Bisi Akande, as e clock 87 years of age. Tinubu describe am as mentor, ally and strong pillar wey hellep build and sustain democracy for Naija. According to Oga Presido, Baba Akande follow Obafemi Awolowo political ideology and later leave im accountant work for  public service fully. Tinubu tuk say, Akande serve Naija […]

todayJanuary 16, 2026 24

National

Rivers Lawmakers Accuse Fubara, Insist Say Dem Must Impeach

By: Esther Ayoola Lawmakers of di Rivers State House of Assembly today we be Friday, dey insist dat, dem must investigate dia govo, Siminalayi Fubara, even accuse am say, im dey blackmail dem. Di lawmakers hold press today for Port Harcourt, wia dem tuk dia mind say Fubara nor dey fit enough to handle crisis for di oil rich state. According to di lawmakers, Fubara dey infringe on di 1999 Constitution and na why, dem dey use dia legislative power […]

todayJanuary 16, 2026 16

obodo oyinbo

Museveni Lead Uganda President Election From first results with 76 percent

By: Esther Ayoola Oga Presido of Uganda, Yoweri Museveni like dis don dey dust im opponents, dey lead Uganda election result as counting of votes dey on. According to Electoral Commission of Uganda, afta dem count almost half of di polling units, Museveni get about 76 percent of di vote, while im main challenger, Bobi Wine, get around 20 percent. Like dis di gbege nor be here, say Bobi Wine party mehn dey complain dat dem don put dia candidate […]

todayJanuary 16, 2026 14

Sports

CAF Unveil eAFCON Game, For Gamers

By: Esther Ayoola CAF don unveil eAFCON, di digital version of TotalEnergies African cup of Nations, to take African football enter di eSports world, incase your country lose real life, you use di computer game hold bodi. For statement wey dem release on Friday, CAF tuk, say di move na part of dia commercial strategy to grow business and reach more people. CAF explain say dem dey do beta joinbodi with computer game giant, Konami, makers of eFootball, to do  […]

todayJanuary 16, 2026 19 2

National

How Govnor Ododo Scarra Terrorist Hideouts For Okene

By: Rilwan Agbomeji Kogi State Govo, Usman Ododo, dey vex wetin nor good say im nor wan use im two korokoro eyes see any jaguda for im state, so like dis im don order make security go pull down all terrorist hideouts for Okene Local Govment Area, say like dis security pipo don buy waka  destroy one suspected ISWAP camp for Sambel, Idoji. As security sources tuk, say extremist activities dey increase for di area every day. State Govment don […]

todayJanuary 16, 2026 15

National

Oyedele Repeat Tuk Say Small Investors No Go Pay Capital Gains Tax

By: Rilwan Agbomeji Chairmo of di Presidential Committee on Fiscal Policy and Tax Reforms, Taiwo Oyedele, don share update, say na small investors for Nigeria go gain from di new tax law wella. E yarn dis one for di Cowry Quarterly Economic Discourse wey hapun on Thursday, say anybody wey sell asset wey no pass N150m and gain no pass N10m for 12 months dey automatically nor go pay tax. E explain say pension funds and real estate investment trusts […]

todayJanuary 16, 2026 14

foreign

UN Hold Emergency Meeting On Top Protest For Iran

By: Rilwan Agbomeji United Nation Security Council don hold emergency meeting, say di kpai kpai, wey pipo dey kpai for Iran protest dem nor like am at all, at all. You sabi say, US Presido Donald Trump sti tuk for dis mata, even threaten to use military for di country. Iran UN deputy envoy talk say Iran no wan fight, but dem go respond if US start wahala, and accuse US say e dey cause di unrest. For im speech […]

todayJanuary 16, 2026 21 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds