Blog masonry

Background

Sport Yarns

Messi Injury Scare Argentina Fans Before World Cup

By : Jolayemi Olajide Lionel Messi don raise fresh injury fear, after e ask make dem substitute am during Inter Miami match against Philadelphia Union for MLS on Sunday. Di Argentina captain hold di back of him left leg before comot for the game in the 73rd minute during di rain-soaked match for Miami. Even though Messi waka comot by himself and enter tunnel without help, fans still dey worry ahead of di World Cup. Inter Miami coach Guillermo Hoyos […]

todayMay 25, 2026 23

obodo oyinbo

Pope Leo XIV Warn Say AI Fit Bring Modern Slavery

By : Jolayemi Olajide Pope Leo XIV don call for better control of artificial intelligence, warning say di fast-growing technology fit create new forms of slavery if dem no handle am well. For him first encyclical titled “Magnifica Humanitas,” di Pope warn against di global race to build more powerful AI systems just for political and business dominance. He present di document for Vatican alongside AI experts including Christopher Olah, wey admit say pressure on AI companies sometimes dey clash […]

todayMay 25, 2026 21

Health

No Chop “Ata Esha” Again! Aproko Doctor Warn Say Spoilt Tomatoes Dey Cause Liver Cancer!

By : Jolayemi Olajide Popular health influencer, Dr. Chinonso Egemba wey everybody know as Aproko Doctor, don warn Nigerians on Monday make dem stop to dey buy and chop spoilt tomatoes wey people dey call “Ata Esha” or “Awarawa.” Inside one heavy health advisory wey roll for his X account, di doctor talk say those white-white things inside di rotten tomatoes na fungus wey dey produce one dangerous poison called aflatoxin. He clear ground say this poison dey cause liver […]

todayMay 25, 2026 21

Lagos

Lagos Gornment Arrest Over 10,000  for  crossing Highway crossing

By : Jolayemi Olajide Baba  Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, don reveal say Lagos State Government arrest over 10,000 pipo for inside Alausa for di past one year because of environmental law breaking. Wahab tuk dis one  during dia  2026 Ministerial Press Briefing, say dem gbab 5,715 pipo wey dey cross highway, 102 people for open defecation, and thousands more for street trading, cart-pushing, and waste table-shaking. Di gornment carry out dis massive clear-out to mark di […]

todayMay 25, 2026 13

Education

From Corper To Big Boss: How Professor Segun Aina Take Climb Enter Di Top Seat For JAMB

Di tori of how 39-year-old Professor Segun Aina take become di new Registrar of di Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) normally suppose to be beta ginger for everyone. Na Thursday, May 21st, 2026 wey news break say na new senior man, Prof Aina, go take over for JAMB after Professor Ishaq Oloyede tenure finish on July 31st, 2026, expectation dey very high, nor be lie for reason being dat Prof Aina di first youth in history to double as […]

todayMay 25, 2026 44 7

Health

Floating Fortress: How One South America Journey Land Pipo With Sickness for Doctor House

Di open ocean normally dey flow with fresh breeze, but one cruise ship bring one ogbonge sickness, wey spread body like egg for aboki meshai bread, don leave pipo dey wonderment. Dis time around nor be corona virus, dem call dis sickness Hantavirus. Dis virus pick race dey spread like say im dey run Olympic race with cheetah, just di same way one bad apple fit spoil full basket of tomatoes before you blink eye, na so e hapun for […]

todayMay 25, 2026 29 2

Health

CENTRAL AFRICA ON FIRE: Di Full Gist On Di Latest 2026 Ebola Outbreak

They say "wetin dey sweet for mouth, na inside stomach e dey turn to bitter leaf." That na exactly di story for one small village for Northeast Congo, where simple celebration turn to cry-cry night. Pesin wey no do any evil, wey just chop life with family, start to complain of small headache for evening,  by midnight, sweat don cover am, and before day break, strange blood start to run comot for him eye and nose, leaving everybody for di […]

todayMay 25, 2026 26

Sport Yarns

Onyinyechi smash world record as Nigeria pack 49 medals for African powerlifting Open

By : Jolayemi Olajide Naija Para lifters set records, Onyinyechi Mark smash both world and African records for the African Open Para-Powerlifting Championships plus as Nigeria pack 49 medals join bodi. Na so Team Nigeria finish for second position with 32 gold, 12 silver, and 5 bronze medals, meanwhile Egypt take first place after dem pack 84 medals total. Onyinyechi show dem pepper for di women’s 67kg category to change the record books, and another beta correct gold come from […]

todayMay 25, 2026 29

OBODO NAIJA

Police begin touchlight how Popular Businessman “Egonaejeije” take kpai inside Abuja House!

By : Jolayemi Olajide Police for Abuja don begin dig inside mata of how pipo kpai one big electronics businessman, Chief Godwin Chinedu Lucky Adimike, wey many people know as “Egonaejeije Na Awka-Etiti.” The 53-year-old businessman, wey get big face for Alaba International Market for Lagos, kpai for Karu General Hospital after dem find am with heavy wound for im house for Hassan Adamu Street, Guzape district. Dis sad level hapun after argument burst over family business money, and di […]

todayMay 25, 2026 30

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds