Blog masonry

Background

Uncategorized

Lagos First Lady, Ibijoke Gather Boys To Stop Yahoo

Wife of di Lagos State Govo, Ibijoke Sanwo-Olu,  don advice young boys for Lagos make dem comot body from cybercrime, say na bad character bi dat. She yarn dis one for the Lagos Boy Child Initiative Residential Workshop wey happen for St. Gregory’s College, say boys must use social media for good and no allow peer pressure push dem enter bad tin. According to her, too much exposure to digital platforms without proper guidance dey make many boys chase quick […]

todayFebruary 26, 2026 4

OBODO NAIJA

How FG Package Kano Market Fire Victims With 5 Billion Naira  

Vice President, Senator Kashim Shettima, don throw mouth say Federal Gornment go join hand with Kano State Gornment and other agencies to stop fire disaster for markets. Shettima give dis assurance for Abuja when leaders of Association of Kano Business Community, led by Presido Alhaji Sabiu Bako, visit am for Presidential Villa to thank am for di support. Oga vice presdo explain dat Federal Ministry of Humanitarian Affairs don complete all di necessary papers to release di N5 billion  for […]

todayFebruary 26, 2026 3

OBODO NAIJA

New Police Oga Disu Vow To End Corruption And Oppression

President Bola Tinubu don officially decorate new Acting Inspector-General of Police, Tunji Disu, for State House, Abuja, on Wednesday. After di ceremony, Disu tell tori pipo how matas go dey go moving foward say, im go stop impunity for Nigeria Police Force, promise to end corruption and human rights abuse. Oga Disu make clear say di kontri na every get am and not just political leaders or police.

todayFebruary 26, 2026 5

obodo oyinbo

Iran, US Gather For Third Round Of Nuclear Talk For Switzerland

Say Iran and US go start third round of nuclear tuk for Switzerland,  an according to report both of dem still dey look for diplomatic solution. Iran Foreign Minister Abbas Araghchi reach Geneva on Wednesday, meet im Omani counterpart wey dey hellep arrange di tuk. Araghchi say dem fit reach  fair and balanced deal afta di meeting, but Iran nor wan give up right to use nuclear technology peacefully. Say Iran and US go start third round of nuclear tuk […]

todayFebruary 26, 2026 3

Sports

D’Tigress Drop Provisional Squad for Women’s World Cup Qualifiers

Nigeria seven-time African champions, D’Tigress, don announce dia provisional squad for FIBA Women’s Basketball World Cup Qualifying Tournament wey go hold for Lyon, France from 11–17 March 2026. Coach Rena Wakama pick mix of experience players and new talents wey go face France, Germany, South Korea, Colombia and Philippines. Big names like Amy Okonkwo, Sarah Ogoke, Promise Amukamara and Ezinne Kalu dey lead di team, plus young guns like Pius Idubano and Wandoo Hemba. Full roster still get plenty players […]

todayFebruary 26, 2026 5

Lagos

President Tinubu Appoint Tunji Disu As Acting Police IGP Afta Egbetokun Resign

By: Esther Ayoola Wi President Bola Tinubu don appoint Assistant Inspector-General of Police Tunji Disu as Acting Inspector-General of Police afta Kayode Egbetokun resign from di position. For statement wey presidential tuk,tuk Bayo Onanuga release on Tuesday night, di President say di appointment take effect immediately because of security challenges for di country. Dem say according to Police Act 2020, Tinubu go soon call meeting for Naija Police Council to consider Disu as di main man for di IGP role […]

todayFebruary 25, 2026 3

Lagos

Lagos CAN Name Dia New Secretariat Afta Oluremi Tinubu for Alausa

By: Esther Ayoola Lagos State branch of Christian Association of Nigeria don rename dia permanent secretariat afta Oluremi Tinubu, almost 30 years afta dem open di place. U sabi say di building wey dem dey name “Senator Oluremi Tinubu CAN Lagos State Secretariat” for Alausa, Ikeja, na Daniel Okoh, di national president of CAN, na im officially open am. Okoh praise Lagos CAN members for dia ogbonge doings and unity to make di project become reality. One floor of di […]

todayFebruary 25, 2026

National

Akure Police Commando Gbab 10 Suspected Kidnappers For Ondo State

By; Esther Ayoola Police for Ondo State don arrest 10 suspected kidnappers for Akure and recover ransom money wey dem collect from dia victims. Police tuk, tuk, Jimoh Abayomi, konfamate to tori pipo, from force headquarters, say di arrest na big breakthrough as dem dey continue crackdown on kidnapping and other violent crimes for di state. Say na joint operation between Anti-Kidnapping Section and PMF personnel from Force Headquarters carry out di arrest afta dem get solid intelligence along Ondo […]

todayFebruary 25, 2026 4

National

Ogbomoso Askident Kpai Pregnant Woman, Five Final Year Student For Kwara

By: Esther Ayoola Six people, including one pregnant woman and five final-year nursing students, say ni kpai for one big car askident for Kwara side of Ilorin, Ogbomoso road. FRSC Kwara commandant, Rosemary Alo, konfam say di askident hapun for Ote area for Kwara. Alo say, Some of di victims kpai on di spot, while some others kpai for hospital. Say di five nursing students, na 500-level students wey dey do Open and Distance Learning for one higher institution for […]

todayFebruary 25, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app