Blog masonry

Background

National

FG Arrange Plan To Evacuate Nigerians From Middle East

By: Esther Ayoola Federal gornment say, dem dey arrange how to evacuate Nigerians wey dey trapped for some Middle East countries because of di ongoing crisis. Nor be amebo say di tension for di region rise afta United States and Israel carry out military strike against Iran on February 28. Tuk, tuk of di Ministry of Foreign Affairs, Kimiebi Ebienfa, say gornment dey work on administrative arrangements and release of money to start di evacuation. Dis update dey come afta […]

todayMarch 17, 2026 6

National

Wike Insist, Say Security Agencies Gallant On Top Banditry Issue For Abuja

By: Esther Ayoola Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, don dismiss claims say banditry dey hapun frequently for Abuja. Wike tuk dis one during inspection of ongoing projects for di capital say im security agencies stand fit for crime. E admit say crime fit hapun anywhere for di world but insist say reports about banditry for Abuja say na bad belle pipo dey yan okpata.  

todayMarch 17, 2026 8

National

22 Passengers Wunjor As Train For Abuja–Kaduna Head Shake For Im Corridor

By: Esther Ayoola Say at least 22 passengers wunjor afta train wey from Abuja dey go Kaduna head shake for im corridor, forcing di train to stop and delay di journey. According to report About 429 passengers and 70 crew members bin dey inside di train when di incident hapun. Managing Director of Nigerian Railway Corporation, Kayode Opeifa, konfamate di number of pipo wey wunjor when im visit di corridor Opeifa tell journalists for Kaduna say di rail line still […]

todayMarch 17, 2026 4

National

Bomb Explosions Shake Maiduguri Afta Suspected Boko Haram Attack

By: Esther Ayoola Say nor be small tin hapun for Maiduguri dat bomb explosions hit di town on Monday evening, one for Monday Market and another near University of Maiduguri Teaching Hospital. According to report di bombs blast around 7:02 pm, hours afta suspected Boko Haram terrorists launch different attacks on three military positions across di state. Konfaming di report, Head of Operations of di Federal Fire Service, Borno branch, Mohammed Kafaran, say Federal Fire Service ni go assess di […]

todayMarch 17, 2026 4

National

Judge Vex, Tell Sowore Lawyer Make E Kneel For Court

By: Esther Ayoola Justice Mohammed Umar for Federal High Court Abuja omo cut chain on Monday for Omoyele Sowore lawyer, Marshall Abubakar, for court because say e tuk anyhow for court. Judge even tell am make e comot come kneel down for front of everybody. Say Abubakar raise hin voice for court say, date wey dem fix nor favour, di tin vex judge. Other lawyers con manage calm di judge down, while Sowore dey face case from DSS for say […]

todayMarch 17, 2026 9

obodo oyinbo

UK Gorment Dey Do Give Away With £53m To Hellep Poor For Iran War

By: Esther Ayoola Say like dis British Gornment dey do give away of £53 million to hellep pipo to manage demselves as oil price rise. U sabi say prices of tins rise because of di wahala wey dey go on for di Middle East. Prime Minister Keir Starmer say di money go mainly reach low-income pipo wey dey rural area wey dey use heating oil. Unlike gas and electricity wey Ofgem dey control, heating oil price dey  rise wetin nor […]

todayMarch 17, 2026 4

obodo oyinbo

China’s Zhejiang Province Call For Global Collabo To Boost Economy

By: Esther Ayoola Department of Foreign Affairs of China’s Zhejiang Provincial People’s Gornment, Prof Gu Jianxin say countries need to work together for stable economy instead of competition, as e go hellep world economy grow. Gu tuk dis one as dem dey do reception for journalists for Hangzhou wey come from different countries. Di journalists come from Zhejiang afta dem attend sessions about China 15th Five-Year Plan, especially cooperation for AI, agriculture, infrastructure and people exchange. Gu sti explain how […]

todayMarch 17, 2026 10

obodo oyinbo

UN Boss António Guterres Beg World Pipo To Stop Anti-Muslim Hate

By: Esther Ayoola UN Secretary-General António Guterres tok say make all countries join hand stop di rise of anti-Muslim hate. E tuk say fear and exclusion no suppose dey, from di way im dey see Muslims. Guterres also yarn say plenty Muslims dey suffer discrimination, marginalization, and unfair profiling every day. As Ramadan dey end, e call on gornment make dem protect equality and stop malice.

todayMarch 17, 2026 3

Lagos

Arewa Community For Lagos Beg Presido Tinubu To Con Settle APC Crisis For Lagos

Arewa Community, Lagos branch,  don wire sms give wi oga presido Bola Ahmed Tinubu  say make e con intervene over wetin dem call attempt to weaken di Northern Lagos branch structure inside All Progressives Congress ahead of di 2027 elections. Di petition, wey dia oga, Musa Saleh sign, say di Arewa Community structure for Lagos bin dey officially inaugurated for 2021 by President Tinubu. Say more than 200 members of di group on Monday visit di party secretariat for Ikeja […]

todayMarch 17, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app