Blog masonry

Background

National

Na Im Be Say, Naija Govt And ASUU Don Finally Hammer New Deal

By: Rilwan Agbomeji Finally finally say wi Federal Govment and di Academic Staff of Universities don finish dia long negotiation over di 2009 FGN–ASUU agreement. ASUU share dis update for dia official Facebook page on Wednesday. Di new deal go start from January 1, 2026, and e go dey reviewed every three years.

todayDecember 24, 2025 12

National

Sad Christmas Eve For kano State As Two Lawmakers Kpai All Of A Sudden

By: Rilwan Agbomeji No be small thing ooo, Kano State enter deep mourning afta two of dia lawmakers kpai one by follow for same day. According to di tuk tuk persin of Kano State govo,  Sanusi Bature Dawakin Tofa,  Sarki Aliyu Daneji wey dey represent Kano Municipal Local Government die few minutes afta Aminu Sa’adu from Ungoggo Local Government also kpai. Im say, di sudden death shock politicians and residents, as both men dey active for State House of Assembly […]

todayDecember 24, 2025 8

Lagos

How Sanwo – Olu Arrange Support For Tinubu Tax Reform

By: Rilwan Agbomeji Lagos Governor, Babajide Sanwo-Olu, say im government ready back Tinubu tax reform with fair and friendly system. Sanwo-Olu yarn dis one yesterday for Tax Reform Summit wey happen for Lagos. Di Office of Special Adviser on Taxation and Revenue join State Treasury Office host di meeting. Di summit focus on Lagos plan to turn tax reforms to real results for di people.

todayDecember 24, 2025 9

Sports

AFCON 2025 – Simon Sure Say Super Eagles Go Beat Tunisia

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles winger, Moses Simon don talk say Naija go fight hard make dem collect full points against Tunisia for AFCON 2025. Di match go happen Saturday for Complexe de Fès for Morocco, as both teams dey eye anoda win. Simon say team dey confident and ready to overcome Tunisia, wey dem dey call Carthage Eagles. Nigeria and Tunisia don start di tournament with win, and dis clash go show who really ready to rule di group.

todayDecember 24, 2025 8

foreign

Libya Army Oga And Four Others Kpai For Plane Crash Wey Happen For Turkey

By: Rilwan Agbomeji Badness sup for Libya say dia oga of army , Lieutenant General Mohammed al-Haddad, and four senior officers don go kpai for plane crash for Turkey on Tuesday night. Di plane crash happen shortly afta e take off from Ankara, Turkish capital, officials for Turkey and Libya confirm. According to reports say Turkish security men later find di wreckage of di Falcon 50 aircraft for Haymana area near Ankara, Interior Minister Ali Yerlikaya talk. Libya Prime Minister […]

todayDecember 24, 2025 5

National

FG Slam 16-Count Charge On Top Malami And Im Pikin Head

By: Rilwan Agbomeji Federal Govment don carry 16-count money laundering go court against former AGF Abubakar Malami and im pikin Abubakar Abdulaziz Malami say dey allegedly thief ₦1.014bn. FG talk say di mata happen between 2022 and 2025 for Abuja, and dem don file am for Federal High Court. According to report say dem use beta strong technology take hide di money. Govment say dem trace di ₦1.014bn reach one commercial bank, and very soon dem go carry di mata […]

todayDecember 24, 2025 9

Sports

Super Eagles Coachie Chelle Tell Players To Do Beta

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles coach, Eric Chelle, don change am for im players tell dem say, make dem nor repeat that anyhow character wey dem do against Tanzania with anybody E say, even though super eagles win 2 goals to 1 on Tuesday, say super eagles suppose do beta But sha im go manage di three point, but moving faward, na only beta football e want to dey see di eagles play.  

todayDecember 24, 2025 8

foreign

Russia Use Drone Take Attack Ukraine

By: Rilwan Agbomeji Zaporizhia oga talk say Russia don launch 704 air attack, including 17 air strike, for Zaporizhia area for di past 24 hours, wey don kill one person and injure three for December 24, 2025, for Ukraine. Ukraine officials talk say overnight drone attack don hit Moscow, wey even start industrial fire for Tula region wey dey south of Russian capital, as retaliation for wetin Russia don do. Chernihiv city council yarn say Russian drones don also damage […]

todayDecember 24, 2025 9

Sports

AFCON – Naija Super Eagles Show Workings Beat Tanzania 2-1

By: Rilwan Agbomeji Nigeria don start dia AFCON 2025 campaign well, as Super Eagles beat Tanzania 2-1 for Stade de Fez, as Semi Ajayi and Ademola Lookman score. Tanzania try fight back, even score one, but Lookman quick reply make Nigeria take all three points. With dis win, Nigeria dey top Group C join with Tunisia wey beat Uganda 3-1 while Tanzania go need beta result next match.    

todayDecember 24, 2025 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app