Blog masonry

Background

Lagos

Sanwo-Olu Host Japan Ambassador, Promise Stronger Lagos-Japan Partnership

Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don welcome Japan Ambassador to Nigeria, H.E. Suzuki Hideo, for courtesy visit for Lagos House, Marina, as dem tuk about how to make Lagos and Japan relationship strong. Oga govo give di Ambassador special Eyo plaque as sign of honour and to show Lagos rich culture. Both men use di meeting discuss better way to improve economic cooperation, infrastructure development and investment between Lagos and Japan.  

todayFebruary 19, 2026 9

OBODO NAIJA

President Tinubu Package New Election Bill 2026

President Bola Ahmad Tinubu don sign di Electoral Act Amendment Bill 2026 into law on Wednesday, even as many Nigerians dey complain about one clause wey make electronic transmission of election results optional. Di signing hapun for Presidential Villa with Senate President Godswill Akpabio, Speaker Abbas Tajudeen, Senate Leader Opeyemi Bamidele, Deputy Speaker Benjamin Kalu and other top government officials present on wednesday. According to Tinubu, say im follow di senate bumper to bumper, saying day di bill go make […]

todayFebruary 19, 2026 4

Sports

Arsenal Blow Two-Goal Lead, Dirty Dia Title Hope

Arsenal title hope for Premier League don suffer big setback as dem throway two-goal lead and play 2-2 draw with bottom team Wolves on Wednesday night for Molineux. Bukayo Saka score early goal and Piero Hincapie add another one for second half, make am be like say Mikel Arteta boys go extend dia lead for top of di table. But Wolves no gree give up, as Hugo Bueno pull one back before late drama happen for stoppage time.  

todayFebruary 19, 2026 7

obodo oyinbo

Bill Gates Cancel Last Minute AI meeting

Say area don gather for New Delhi for one ogbonge AI summit, dat Indian leader Narendra Modi go tok, plus tech chiefs like OpenAI Sam Altman. Bill Gates bin suppose tuk too, but e cancel last minute. Gates say im comot body so dat pipo go really focus on wetin AI Summit really mean.  

todayFebruary 19, 2026 7

Sports

Alcaraz Make Strong Return, Beat Rinderknech For Doha Open First Round

By: Esther Ayoola World number one , Carlos Alcaraz don start im betterlicioius doings again oh, afta Australian Open win,  beating Arthur Rinderknech 6-4, 7-6 (7/5) for Doha first round on Tuesday. Yarning with tori pipo after di match, E explain dat, e no easy oh, because Arthur na strong player wey nobody wan jam for first round. Alcaraz tuk say e happy say e fit remain calm for di match, positive, and play correct tennis. For next round, e […]

todayFebruary 18, 2026 17

obodo oyinbo

Peru Fire President Jose Jeri Over Corruption Wahala

By: Esther Ayoola Peru Congress don fire interim presido, Jose Jeri, wey be di seventh presido of di kontri and e don rule  for di last ten years. Dem accuse am say e hire plenty women for him gornment and say e dey linked to one Chinese businessman for corruption wahala. Jeri take over from leader Dina Boluarte, wey dem bin impeach, because pipo complain about di wahala for di country. Prosecutor don already start check whether Jeri use him […]

todayFebruary 18, 2026 7

National

Muslims And Christians Enter Prayer Mood As Ramadan, Lent Start

By: Esther Ayoola Millions of Muslims and Christians for di world don start dia special spiritual time today. Muslims don ready for Ramadan, wey dem go fast from morning till night, pray more, and do plenty charity. Christians wey dey observe Lent, go also dey pray, do penance, and control demself till Easter. Saudi Arabia sef don konfamate dis doings, say dem don see di new moon, so Ramadan 1447 go start today, Wednesday. Believers don get ogbonge advise to […]

todayFebruary 18, 2026 10

National

How Drama Promax Take Sup For Nass Over E-Transmission For 2027 Elections

By: Esther Ayoola Drama burst for National Assembly of Naija on Tuesday as lawmakers approve electronic transmission of election results but sti keep manual collation as backup ahead of 2027 elections. A move wey bring serious argument for both Senate and House of rep. For Senate, about 15 lawmakers led by Enyinnaya Abaribe protest against di clause wey say manual Form EC8A fit serve as main result, if electronic transmission fail. Na so dem march out, accusing di ruling parti […]

todayFebruary 18, 2026 10 2

National

Manufacturers Block NAFDAC Office, Kick Against Sachet Alcohol Ban

By: Esther Ayoola Say like dis manufacturers of spirit drink, wey dey under Food, Beverage and Tobacco Senior Staff Association dey protest, say dem nor go gree oh, for NAFDAC office, Oshodi-Apapa expressway, block di gate enter, say make NAFDAC open dia offices. Dem say NAFDAC seal dia factories because of di ban on sachet alcohol drinks and PET bottles wey small pass 200ml. Di workers carry placard wey write say “Tinubu no want make jobs loss,” “Stop to dey […]

todayFebruary 18, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app