Blog masonry

Background

obodo oyinbo

China Sharply Blast Israel Move To Grab Palestine West Bank

By: Rilwan Agbomeji China don yarn serious gbege say dem no gree make anybody waka enter Palestinian land, days afta Israel Security Cabinet approve move to grab more West Bank. Lin Jian from China Foreign Ministry talk say dem dey oppose any new settlement for Palestinian area and anybody wey wan chop dia land. On Sunday, Israel Cabinet don give green light make dem build more settlements wey plenty people dey call illegal. Di whole plan go make Tel Aviv […]

todayFebruary 12, 2026 9 2

National

Umahi: I Go Resign If Abuja–Kaduna–Kano Road No Meet Standard

By: Rilwan Agbomeji Minister of Works, David Umahi, don go rake full newspaper say e go resign if dem find say Abuja–Kaduna–Kano Road project no meet standard. Umahi yarn dis one on Wednesday as e dey defend im budget before joint session of National Assembly. Some lawmakers question why dem give part of di contract to one company wey dem say no too dey known for road construction and wey people link to generator business before. However, Umahi say e […]

todayFebruary 12, 2026 5

Lagos

One Man Kpai, Wife Wunjure As Truck Crush Dia Car For Lagos

By: Rilwan Agbomeji One man don kpai on Thursday morning, while im wife wunjure as truck wey dey carry granite jam dia car for Eleko Junction, Lekki–Ajah Expressway, Lagos. LASTMA talk say di truck wey full ground with granite dey rush from Epe side, dey move with top speed. Brake failure make di truck lose control sharply, dash enter di Toyota wey dey go Epe from Ajah. Di gbege cause serious wahala for road, and police don start full touchlighting […]

todayFebruary 12, 2026 13

Sports

CAF Send Technical Team Go Check Tanzania, Uganda, Kenya For 2027 AFCON

By: Rilwan Agbomeji CAF don send team of technical people go check stadiums and oda facilities for di three countries wey go host 2027 Africa Cup of Nations, Tanzania, Uganda, and Kenya. Dem win di bid wey dem dey call PAMOJA 2027, pass di joint bid wey Nigeria and Benin Republic put. Untop yarnings with tori pipo, CAF Presido, Patrice Motsepe say AFCON go come every four years afta 2028, and 2027 go be di last time e go happen […]

todayFebruary 12, 2026 9

National

APC, NNPP Question U.S. Over Visa Ban Wey Dem Wan Put For Kwankwaso

By: Rilwan Agbomeji All Progressives Congress (APC) and New Nigeria Peoples Party (NNPP) don reject di proposed visa ban and asset freeze wey some US lawmakers wan place on former Kano governor, Senator Rabiu Kwankwaso, plus Miyetti Allah groups over alleged religious freedom violations. Di bill wey dem call “Nigeria Religious Freedom and Accountability Act of 2026” na Rep Chris Smith and some oda US lawmakers sponsor am, and dem say na to punish people wey dem accuse of abusing […]

todayFebruary 12, 2026 6

Lagos

Police To Mount Emergency Desk For Inside Lagos Hospitals And Tertiary Schools

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Commissioner of Police, Olohundare Jimoh, don talk say dem dey plan to put police desk for all state govment hospitals and tertiary schools for Lagos. Jimoh yarn dis one for Lagos Campus Security and Safety Summit 1.0 wey Ministry of Tertiary Education and Govnor aide on Students’ Union Affairs organise for LASU College of Medicine, Ikeja. Im say di move go help stop delay wey dey happen when accident and gunshot victims need quick treatment […]

todayFebruary 12, 2026 6

Sports

Spurs Sack Thomas Frank Based On Bad Home Form

By: Esther Ayoola Tottenham Hotspur don sack dia manager Thomas Frank afta dem lose 2-1 for house to Newcastle on Tuesday night. Dis one dey inside Sky Sports news, di Danish coach wey join Spurs last summer from Brentford leave di club as dem dey struggle for 16th position for Premier League table, just five points above relegation zone. Spurs never win any league match for 2026 and dia home form dey smell. Dis poor run of results na wetin […]

todayFebruary 11, 2026 10

National

Reps Committee Hail Women Affairs Ministry Inclusive 2026 Budget

By: Esther Ayoola House of Representatives Committee on Women Affairs don praise Ministry of Women Affairs and Social Development for di strong work wey dem dey do to solve problems for women across di country dey face. Committee Chairperson, Hon. Kafilat Ogbara, tuk dis one on Tuesday during 2026 budget defence with di Minister, Hajiya Imaan Sulaiman-Ibrahim, for National Assembly, as she hail di ministry for efforts on gender-based violence, women empowerment, healthcare and education. She still urge di minister […]

todayFebruary 11, 2026 12

obodo oyinbo

US Deploys 200 Soldiers to Hellep Train Naija Army

By: Esther Ayoola Say United States don send about 200 soldiers to come Nigeria to train Naija army how to fight Islamist militants. According to report from di Wall Street Journal on Tuesday, One American military oga tell di newspaper say the deployment hapun few weeks afta President Donald Trump accuse Naija gornment say dem no dey protect Christians well from terrorist attacks. Di report tuk say di US soldiers go help strengthen Nigeria counterterrorism power through training and operational […]

todayFebruary 11, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app