Blog masonry

Background

Lagos

Man Chop Life Jail After Sexual Assault On 6-Month-Old Pikin For Lagos Court

Justice Rahman Oshodi for Ikeja Sexual Offences and Domestic Violence Court don sentence one man, Victor Dickson, to life imprisonment, sake of say, e rape im neighbour 6-month-old pikin. Di judge tuk say prosecution show strong evidence wey prove di sexual assault case, pass reasonable doubt. Court also say, all di circumstantial evidence point directly to di convict, and im story no fit convince dig court. Justice Oshodi explain how di man lose di case, say di man no get […]

todayApril 14, 2026 11

Lagos

Oba Of Ketu Call Out Ikosi King And LCDA Chair Over Disputed NIPOST Land

Unto updates for Kosofe area of Lagos, Oba of Ketu, Isiaka Oyero, don fault di building of a palace for disputed land wey dey Ikosi-Isheri LCDA. E explain say di land na one-acre wey Oyero family donate give Nigerian Postal Service for 1980, make dem build post office, na why, di mata sti dey court. Oba Oyero accuse Oba of Ikosi, Alamu Oloyede Onikosi, and Ikosi-Isheri LCDA chairperson Samiat Bada, say dem sti dey continue construction for di land despite […]

todayApril 14, 2026 34

south west

Ogun APC Endorse Tinubu For 2027, Pick Senator Adeola As Governorship Candidate

Ogun State APC don endorse President Bola Tinubu for second term for 2027 election, and dem also choose Senator Solomon Olamilekan Adeola as di consensus governorship candidate for di party. Dem take dis decision for strategic caucus meeting wey hapun for di party state secretariat for Abeokuta on Monday. Governor Dapo Abiodun and im deputy, Noimot Salako-Oyedele, join di meeting, wey dem say na to strengthen unity and plan beta future for di party for di state. Abiodun tuk say […]

todayApril 14, 2026 10

obodo oyinbo

Middle East Wahala Grow As Trump Start Hormuz Blockade

US blockade for Iran ports don start for Strait of Hormuz, as Donald Trump dey insist say, im still get space for Peace deal. Im put dis one for im Truth social on Monday. However, Iran on di other hand  dey accuse US, say na piracy dem dey do for di Strait of hormuz, as plenty pipo dey protest di mata for Tehran.

todayApril 14, 2026 9

National

How 28-Year-Old Man Allegedly Kill Him Two Sisters, Daughter For Ondo

Police for Ondo State don start investigation afta one 28-year-old man, Femi Agbeye, allegedly kpai two of im sisters and im 5-year-old pikin for Okitipupa GRA. According to report, di mata start April 8 for dia family house for Doctor’s Road, as reports tuk say di man enter inside, lock door, then carry out di attack. As tori pipo touch light eye witness frequency, dem say, everything hapun inside di house even before help come. Him papa tuk say di […]

todayApril 14, 2026 13

National

Presido Tinubu Hold Emergency Security Meeting Wit Service Chiefs

Wi oga Presido, Bola Tinubu don hold closed-door meeting for Presidential Villa, Abuja with Chief of Defence Staff Olufemi Oluyede and one French General. Say di meeting, na part of beta collaboration to tackle Naija security wahala wey dey ground. Di President sti do emergency security meeting,  join all service chiefs and intelligence heads wey dey di country.   People wey attend include Army, Navy, Air Force chiefs, DSS, NIA and Inspector-General of Police, all to strengthen security work.

todayApril 14, 2026 14

National

Vice Presido Shettima Put Bodi For Youth Dialogue, Call For Investment

Vice President tuk say Naija need serious plan to train young leaders, because na dem dey carry di future of di country. Di vice presido hammar dis mata for Abuja Dialogue 2026 for Abuja, say time don reach to stop tuking, telling leaders to show workings. Shettima make am clear say, if gorment nor invest on youth, say dem dey endanger di future of di kontri.

todayApril 14, 2026 10

National

Police Gbab 50 Suspects, Seize Heavy Weapons For Anti-Crime Operation

Naija Police don do Rambo style arrest about 50 suspects and recover plenty dangerous weapons for different operations wey dem carry out across di country. Police say dem do di arrests between January and April 2026 as dem dey push harder to stop serious crimes. Force PRO, DCP Anthony Okon Placid, yarn dis one for press briefing wey hapun for Guzape, Abuja. According to am, di operation target criminals wey dey do gunrunning, kidnapping, armed robbery and other violent wahala.

todayApril 14, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds