Blog masonry

Background

National

Senator Ndume Beg Tinubu To Rescue Di Over 400 Villagers Wey Terrorist Carry

Senator Ali Ndume wey dey represent Borno South don beg oga Presido, Tinubu make e put more effort to rescue di over 400 pipo wey insurgents carry from Ngoshe community for Gwoza area last month. U sabi say di people wey di jaguda boys carry, na mostly women and children. Ndume tuk dis one for press briefing say e bad say gornment never sti bring back di victims, even afta soldiers don take back di area.

todayApril 14, 2026 13

National

Minister of Education Alausa Inaugurate Two Model Science Schools For Kogi

Education Minister, Dr Tunji Alausa, don open two model science secondary schools for Kogi State on Monday. He praise Governor Ahmed Usman Ododo for im strong effort to betalicious education. Di schools, GYB Model Science Secondary School for Nagazi and Okebukun for Kabba-Bunu. Alausa stress di federal gorment readiness to partner state gorment to make sure say dem bring beta education.

todayApril 14, 2026 11

National

Court Shift El-Rufai Bail Mata To April 14

By: Esther Ayoola Kaduna State High Court on Monday don adjourn di hearing of bail application wey former govo Nasir El-Rufai file, go April 14, 2026, as e show face for court under tight security for ICPC case. Dem dey accuse am and im co-defendant Amadu Sule for financial misconduct and abuse of office, but court later agree to remove Amadu Sule from di arraignment. El-Rufai plead not guilty to nine charges, while im lawyer, Ukpon Akpan, beg court make […]

todayApril 14, 2026 8

National

Adamawa ADC Suspend Atiku, Babachir Lawal, Others Say Dem Dey Cause Division

By: Esther Ayoola One faction chairmo for Adamawa state Africa democratic Congress, ADC, Raji Zumo, don announce say dem don suspend former Vice President Atiku Abubakar. Dem make di announcement for press conference wey hapun on Monday. Di ADC faction chairmo, also suspend former SGF Babachir Lawal and party transition committee chairmo, Sadiq Ibrahim. According to am, di reason be say dem dey cause division for di party.

todayApril 14, 2026 13

Sports

Lookman Eye Champions League Semi-final As Atletico Madrid Battle Barcelona

Ademola Lookman dey prepare body to become di only Nigerian wey go reach UEFA Champions League semi-final dis season as Atlético Madrid dey host FC Barcelona for dia important second leg quarter-final today. Atlético get two-goal advantage after dem win di first leg for Camp Nou. For Nigerian fans, all eyes dey on Lookman wey don score 5 goals and give 3 assists in 16 appearances since e join Atlético Madrid.

todayApril 14, 2026 13

Sports

Sinner Beat Carlos Alcaraz  Carry Monte Carlo Title

Jannik Sinner don win Monte Carlo Masters final, e beat Carlos Alcaraz 7-6 (7/5), 6-3 to carry im third ATP 1000 title dis year. Before dat one, Sinner  complete “Sunshine Double” after im win both Indian Wells and Miami back-to-back. With dis achievement, e join Novak Djokovic and Rafael Nadal as only players wey don win four ATP 1000 titles one after another. Say like dis , Sinner dey prepare for  Roland-Garros and Wimbledon Championships to continue im winning run.

todayApril 14, 2026 9

National

AGF Fagbemi Push For Community Justice, Say Time Don Reach For State Police

Naija Attorney-General and Minister of Justice, Lateef Fagbemi, don share update say di Naija security problems, only federal gorment nor go fit run am, say men need to put hand. Im yan dis one for di 2026 Law Week of di Nigerian Bar Association, Sokoto branch. According to am, many serious security problems dey start normally start from local level, family palava and resource control. E call for strong community justice system and say make pipo revive idea of state […]

todayApril 13, 2026 13

Lagos

Lagos Police Clear False Alarm Say Area Dey Free From Cult Operations

Lagos State Police Command don clear air on di rumour wey fly say cultist wan test dia power for Shitta, Akerele, Itire/Aguda and Ishaga  area, say di report na false alarm. Dis one di police put for statement wey di police tuk tuk person, PRO Abimbola Adebisi release to tori pipo on Monday Say, CP Tijani Fatai don order heavy security presence, with plenty patrol and better monitoring for all those areas. PRO Abimbola Adebisi advise people make dem ignore […]

todayApril 13, 2026 15

National

How Gunmen Kpai Traditional Ruler, Burn Im Body And Others For Imo State

Say nor be small thin sup on Friday for Asa Awara Road near Ochia Autonomous Community, Imo State, dat unknown gunmen go kpai Eze Paulinus Ekwueme, di traditional ruler, im two brothers, driver and security aides as dem dey return from meeting. According to report, Di attackers open fire, kill dem, then burn dia bodies and di monarch official vehicle for road. Police tuk tuk, Okoye Henry naim explain dis mata to tori pipo on Monday, say, Imo State Police […]

todayApril 13, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds