Blog masonry

Background

obodo oyinbo

UK Gorment Make Move To Ban Social Media For Under-16

Di United Kingdom gornment say like dis dey consider new law wey go stop children wey never reach 16 years from using social media. Prime Minister Keir Starmer put dis one news tuk on Monday, say im dey  check things like time limit, app curfew and how platforms algorithm go be for di UK Childrensis. Say Platforms like Instagram and TikTok fit face stricter rules if di plan work. Starmer say, di main aim na to protect children health, sleep, […]

todayApril 13, 2026 12

obodo oyinbo

US And Israel Join Body Put Naval Blockade On Iran Ports

Prime Minister Benjamin Netanyahu don decide  say Israel go support US President Donald Trump plan to put naval blockade on Iran, and say dem dey work closely with America. US military don announce say dem go start the blockade for all Iranian ports after tuks with Iran jam beta rock. Trump also tuk say dem go block the Strait of Hormuz, wey be very important trade route, until Iran open am wella. Di blockade go start 1400 GMT and go […]

todayApril 13, 2026 26

Sports

How Armed Robbers Attack And Kpai Ghana Footballer, Dominic Frimpong

For Ghana, say Premier League footballer Dominic Frimpong kpai afta armed robbers attack  dia team bus on Sunday night as di team dey come back from away match for Ashanti Region. Di club Berekum Chelsea FC naim konfamate dis mata, say masked men wey carry guns and assault rifle open fire for di team bus, na so players scata. Ghana Police Service tuk say di incident hapun around 10:30pm for Ahyiresu-Kwame Dwumor Sreso road for Nyinahin District, and dem rush […]

todayApril 13, 2026 22

National

ADC Leadership Crisis, Supreme Court To Hear David Mark Appeal For Abuja Tuesday

Say Supreme Court of Naija go hear appeal on Tuesday for Abuja, where di court go decide mata wey involve leadership wahala of African Democratic Congress. According to appeal wey David Mark and im lawyer file, say make court hellep to stop execution of Court of Appeal ruling of March 12, so dat status quo go remain. Dem sti ask say make Independent National Electoral Commission no change ADC national leadership arrangement, as dem dey wait make court finish hearing […]

todayApril 13, 2026 19

National

Yobe Gorment Put Mouth For Military Air Strikes For Borno State

Yobe State Gornment, through im Security Adviser Brig Gen Dahiru Abdulsalam (retd.), don explain wetin hapaun for Borno say di incident involve Boko Haram for Jilli community. Dem also clear say, di strike no happen for Yobe State, but for Gubio Local Government Area inside Borno State. E explain say on Saturday, April 11, 2025, Air Component of Joint Task Force Operation HADIN KAI carry out air strike for Jilli, because say na Boko Haram stronghold be dat, and dem […]

todayApril 13, 2026 15

National

FG Remove Import Duty For Buses, EVS, Machine To Ease Economy Wahala

Federal Gornment don grant waiver wey go remove import duty for mass transit buses, electric vehicles, and manufacturing machines. Dis move come as President Bola Ahmed Tinubu direct economic team make dem find way reduce pressure wey high fuel price and global crisis dey put on Nigerians. According to statement wey Presidential aide Dada Olusegun post for X, di policy na to hellep reduce inflation and make life and business cheaper. Gornment say dem sti dey plan more tax cuts […]

todayApril 13, 2026 11

Sports

Inter Milan Run Comeback Beat Como 4-3, Open Gap For Title Race

By: Esther Ayoola Inter Milan do beta comeback win against Como 4-3 for Serie A, move nine points clear Napoli wey only draw 1-1 with Parma. Como bin dey lead 2-0 before first half end, thanks to goals from Alex Valle and young star Nico Paz. Marcus Thuram bring Inter come back into di match with two sharp goals wey level everything. Denzel Dumfries and later finish from Manuel Akanji assist complete di sweet comeback win for Inter.

todayApril 13, 2026 18

Sports

Fear Grip Arsenal Fans As City Close EPL Title Gap

By: Esther Ayoola Say like dis now, Arsenal fans dey worry as title race don dey tight afta dem lose 2-1 to Bournemouth for Emirates Stadium. Di defeat mean say dia lead don reduce to just six points with Manchester City sti getting one match in hand. City no waste time as dem beat Chelsea 3-0 to show say dem sti dey serious for di race. If City win dia next match against Arsenal plus dia outstanding game, dem go […]

todayApril 13, 2026 13

Sports

Rivers United Climb Back Top As Ikorodu City Shine For Matchday 34

By: Esther Ayoola Rivers United don return go top of di Naija Premier League table afta dem knack Plateau United 1-0. Wisdom Samuel na im score di only goal for di match for inside 11th minute of di game. Ikorodu City also carry strong win against Kano Pillars, as dem boost dia hope for continental competition. Di Matchday 34 results don make di title race and relegation battle hot as all teams sti dey fight for points.

todayApril 13, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds