Blog masonry

Background

Lagos

Lagos Gorment Set Tools For Lekki-Epe Expressway Construction

By: Esther Ayoola Lagos state gornment don konfamate say dem wan resume work for di 2 and 3 sessions of Lekki-Epe Expressway (from Ajah Bridge to Admiralty) on Sunday, January 25, 2026. Special Adviser to di Lagos State Governor on Infrastructure, Olufemi Daramola, na dey conversate dis update to tori pipo say,  di contractor don  already arrange im tools for ground afta smalle delay for Christmas, new year period. Say dis ogbonge project go last for 64-days and e go […]

todayJanuary 21, 2026 7

Sports

Naija Para Athletes Complain Over Allowance Delay

By: Esther Ayoola Na Naija para-athletes wey represent di country for di maiden West Africa Zone A and B Para Games wey hold for Abeokuta, Ogun State, from November 28 to December 4, 2025, dey complain say dem never still collect dia competition allowance, some tuk. One of di athletes, Chidera Okoro, ni dey touchlight dis mata give tori pipo, say dem never even see dia transport allowance for di event. Oga chairmo of di Local Organising Committee, Victor Achakpo,  […]

todayJanuary 21, 2026 12

Sports

Court Push Trial Of Driver Wey Kill Anthony Joshua Padi Friends

By: Esther Ayoola Di trial of Adeniyi Kayode, 46-year-old driver wey dey involved for di accident wey kill Anthony Joshua friends, Latif Ayodele and Sina Ghami, say court don carry im case go February 25, 2026. Di case wey suppose hapun for Sagamu Magistrate Court no fit continue because prosecution only get three of four witnesses. Prosecuting lawyer tuk say dem need more time to copy di case file give State Attorney General for advice.

todayJanuary 21, 2026 8

obodo oyinbo

Japan Court Give Life Jail sentence To Abe Killer Tetsuya Yamagami

By: Esther Ayoola Japan court don sentence di killer of former Prime Minister Shinzo Abe, wey dem dey call Tetsuya Yamagami, to life in prison. Yamagami bin admit say e shoot Abe for 2022, di mata sef ehn shock di whole Japan. Prosecutor dem tuk say dis crime na “unprecedented” and e get serious effect for society. Yamagami lawyer bin beg make court give am just 20-year maximum punishment, as di man dey 45 years but, Court just give dem […]

todayJanuary 21, 2026 9

National

NDLEA Gbab 77,792 Drug Offenders, Seize 14 Ton Illegal Drugs

By: Esther Ayoola Report card don show from di Naija Drug Law enforcement Agency, say NDLEA don arrest 77,792 pipo wey dey involve for drug business and dem seize about 14,847 kilogram of illegal drugs for di past five years. Na Retired Brigadier General Buba Marwa tuk dis one to tori pipo, during dia award ceremony for NDLEA headquarters for Abuja on Tuesday. He tuk say all dis arrests and seizures don shake both local and international drug cartels,  and […]

todayJanuary 21, 2026 6

National

Govo Mutfwang Promise Peace, Security as Army Chief Visit Plateau

By: Esther Ayoola For Security matas, Plateau State Govo, Caleb Mutfwang, don go promise say im government go continue to maintain peace, improve security and push development for im state. Mutfwang tuk dis one on Tuesday when Chief of Army Staff, Lieutenant General Waidi Shaibu, visit am for New Government House, Little Rayfield, Jos. Di Plateau govo nor waste time, praise Naija Army and other security agencies for dia strength, professionalism and sacrifice as dem dey tackle security wahala for […]

todayJanuary 21, 2026 6

National

Minister Of Interior Storm Immigration Office Say No More Extra Payment For Passport

By: Esther Ayoola Omo nor be small heat touch immigration office yesterday, say Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo, enter immigration office do surprise, cut chain say why dem dey delay passport office for Gwagwalada, Abuja. During di visit, di minister check di VIP and children section, question officials why work no start on time, and tuk with applicants wey still dey wait. According to Minister Tunji Ojo, everything wey dey hapun for di immigration office, delays and extra charged dey […]

todayJanuary 21, 2026 10

National

FG Advice Naija Pipo To Joinbodi Hellep Build, Protect Naija

By: Esther Ayoola Federal Gornment don call townhall meeting for Naija pipo, both public and private sector  say make everybody join bodi  to build and protect  di country call Nigeria. Na Oga Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, dey tuk dis one for Naija Reputation Summit 2026 wey hapun for Abuja, wia dem take totori matas on Naija good name. E say di launch of ogbonge movement wey dem dey call , give Naija good name, by Naija […]

todayJanuary 21, 2026 8

National

INEC Give Go Ahead For Ekiti Governorship Campaign

By: Esther Ayoola Di Independent National Electoral Commission don give go ahead to all political parties to start public campaign for Ekiti governorship election from Wednesday, January 21, 2026. Resident Electoral Commissioner, Dr Bunmi Omoseyindemi, ni dey yarn dis one, say di campaign go finish midnight, June 18, 2026. Im conversate dis one for meeting wey dem hold for Ado Ekiti, gather INEC officials and party leaders tell dem wetin dem go do for di campaign. Oga Bunmi advise all […]

todayJanuary 21, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app