Blog no sidebar

Background

National

Peter Obi Advice FG To Stop Di New Tax Law First Say Problem Dey

By: Esther Ayoola Di 2023 Presidential candidate of Labour Party, Oga Peter Obi again don advice wi Federal Government say make pause di new tax laws wey dem just gazette, say plenty error and policy wahala full inside am. For statement wey e post for X on Tuesday, Obi tuk say tax expert wey dem call KPMG Nigeria report show problem plenty wahala for di tax reform, say dividend, non-resident […]

todayJanuary 14, 2026 12 13

National

Tinubu, Dapo Abiodun Mourn As Olabisi Onabanjo Wife Kpai

By: Esther Ayoola Oga Presido, Bola Tinubu and Ogun State Governor Dapo Abiodun don express sorrow over di death of Madam Lucia Onabanjo, wife of late Chief Olabisi Onabanjo, former civilian governor of Ogun State. Madam Lucia kpai on Monday, January 11, 2026, for age 100, as her daughter Olubukunola Onabanjo confirm am. Di family describe am as a loving mother, grandmother and great-grandmother wey live long life full of […]

todayJanuary 14, 2026 8

Lagos

Lagos Court Odas Meta to Pay Femi Falana $25,000 Say Dem Scarra Im Mental Health

By: Esther Ayoola Lagos High Court for Tafawa Balewa Square don order Meta Platforms Inc. make dem pay Senior lawyer, Femi Falana SAN twenty-five thousand dollars say dem go put hand for im mata without permission. U sabi say, Falana go complain to court, say Meta publish video and voice message wey claim say e get prostate sickness, and say dat one na im private life, and for naija law, […]

todayJanuary 14, 2026 6 1

National

Police Clear Nigerians, No Fight Criminals If Dem Attack You

By: Rilwan Agbomeji Naija Police Force don open ogbonge secret, say, make Nigerians no try struggle or fight Jaguda boys, particularly di once wey carry dangerous weapon, to beg for survival instead. Police  tuk, tuk, Benjamin Hundeyin,  na dey yarn dis one on Tuesday for live tv sitdon tuk. Say like dis, di Naija police dey up of dia game, an dem dey handle di security challenges for di obodo […]

todayJanuary 14, 2026 11

foreign

Russia Warn Foreign Hands Wey Dey Put Mouth For Iran Marras

By: Rilwan Agbomeji Di story dey worwor every day for Iran, say Iran UN ambassador don go put accusation for  US Presido, Donald Trump head, dat Trump dey look for Iran trouble dey encourage violence. U sabi say, Trump for media yarn say di endgame na to win Iran and make dia pipo protest and take control of di govment. Internet don off for Iran for pass five days as […]

todayJanuary 14, 2026 12

Sports

Naija Set For Davis Cup Clash Against Uzbekistan For Lagos

By: Rilwan Agbomeji Say now, all don set for Davis Cup, di ogbonge table tennis World Group II match, wey go shelle between Naija and Uzbekistan for Lagos from February 7–8, 2026. Organisers say dem don ready for everything, from technical to security and logistics. Oga Presido of Naija Tennis Federation, Victor Ochei, wey tori pipo touchlight im frequency on Tuesday, say dis show say, Naija dey shine for international […]

todayJanuary 14, 2026 6 4

Sports

Mbappe No Dey Training As Arbeloa Take Charge For Real Madrid

By: Rilwan Agbomeji Striker Kylian Mbappe no show for Real Madrid training on Tuesday in Spain as new coach Alvaro Arbeloa take charge for im first session. Arbeloa, wey replace Xabi Alonso on Monday, go lead im first game against Albacete for Copa del Rey on Wednesday, but Mbappe fit no feature. Mbappe just return from knee sprain as late substitute for Spanish Super Cup final wey Real Madrid lose […]

todayJanuary 13, 2026 9 6

foreign

Over 100 Pikin Don Die For Gaza Since Ceasefire

By: Rilwan Agbomeji Di UN children’s agency, UNICEF, on Tuesday report say over 100 pikin don die for Gaza since October ceasefire. UNICEF spokesperson, James Elder, tell reporters for UN briefing by video link from Gaza say di dead include 60 boys and 40 girls, mainly from military attacks. E explain say di attacks happen through air strikes, drone strikes, tank shelling, gunfire, and quadcopters, while small number na from […]

todayJanuary 13, 2026 8 3

National

Fayose Tell Fubara Make E Climb Down From High Horse

By: Esther Ayoola Former Ekiti State Governor, Ayo Fayose, on Tuesday advise Rivers State Governor, Siminalayi Fubara, make e reconcile with Minister of FCT, Nyesom Wike, instead of dey engage in political confrontation. Fayose make dis statement during interview with media tuk tuk for Lagos. E explain say all di governors, including Fubara, get dia strength from other people, so humility dey important for leadership. Di former governor add say […]

todayJanuary 13, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds