Blog no sidebar

Background

OBODO NAIJA

NYSC warn Corpers to avoid internet scorscor doings

By : Jolayemi Olajide NYSC Director-General, Brig. Gen. Olakunle Nafiu, don warn corps members during Abuja interview on Thursday say national service no exempt them from Nigeria cyberbullying laws. Im drop dis warning through the tatafo pipo sake of say some corpers dey use social media misbehave, thinking say uniform go hide dem. Di DG clear di air say police go arrest any corper wey go break di law with […]

todayMay 28, 2026 25

Entertainment

Regina Daniels explain why she nor wan remarry again

By : Jolayemi Olajide Nollywood actress Regina Daniels use yam chop mouth say she nor wan do marriage again after she separate from her husband Ned Nwoko, say stress too much. She yarn dis one during live stream with TikToker Jarvis for Children’s Day carnival wey hapun for Asaba, Delta State. Regina say her mind don shift from marriage mata, but she still tanda kamkpe in building strong family with […]

todayMay 28, 2026 28

Sport Yarns

Neymar to Miss Brazil World Cup First Game Say Im Get Injury

By : Jolayemi Olajide Brazil team doctor, Rodrigo Lasmar, don konfamate on Thursday say Neymar fit miss dia World Cup opening match base on small calf wunjury wey im get. According to di Team doctor, Di 34-year-old Santos star don already dey receive treatment after MRI scan show grade two muscle tear and dat im go miss two to three weeks. Neymar land camp on Wednesday but skip training because […]

todayMay 28, 2026 27 1

Politics

Governor Fubara Brother eye di top political seat for Rivers

By : Jolayemi Olajide Ambassador Blessing Fubara Senior, Governor Siminalayi Fubara senior bro, don declare for Port Harcourt say im dey kamkpe for the Rivers governorship race under NDC flag. The man yarn dis one with im yamchop mouth give tori pipo say he carry full energy come to restore peace for rivarians Fubara Senior dey drop this hard tuk, after Im younger Bro Sim face beta frustration for di […]

todayMay 28, 2026 23

OBODO NAIJA

Cubana Chief Priest explain why im sti dey loyal to President Tinubu

By : Jolayemi Olajide Senior man influencer, wey be billionaire, Cubana Chief Priest don explain imself for Lagos, say im sti dey support President Bola Tinubu and APC. Di seniorman celebrity barman tuk dis one for one radio interview explaining say, im political waka just dey start even though say im lose the APC ticket for Orsu/Orlu/Oru East federal constituency. Cubana say naija politics mata im spread wetin nor good […]

todayMay 28, 2026 18

OBODO NAIJA

Sowore Scatta Table Say Make Nobody Trust INEC

By: Esther Ayoola Human rights activist Omoyele Sowore don untop election mata wipe INEC cord for neck, say im nor trust dem. Sowore yarn dis one for media chat wey hapun today, dat INEC nor dey free and fair but hope say dem go change for 2027. According to am, di figures wey dem dey announce for election no dey always correct, and e believe say Naija pipo naim get […]

todayMay 28, 2026 20

obodo oyinbo

13 Kpai For China Highway Crash

By: Esther Ayoola At least 13 people don die and 3 others injure after minibus jam truck for highway accident wey happen for Henan province, central China, early Thursday morning. China traffic police tok say di crash happen for G40 expressway near Nanyang city, as di bus carry 16 people instead of 9 wey am suppose carry. According to di police, di bus jam truck for di major road wey […]

todayMay 28, 2026 22

south west

Police Pour 2,500 Men Enter Ojude Oba Festival For Ogun

By: Esther Ayoola Ogun Police don spread more than 2,500 officers for Ijebu Ode and nearby areas ahead of 2026 Ojude Oba festival wey go happen Friday. Police spokesperson, DSP Oluseyi Babaseyi, yarn dis one for statement wey dem release on Thursday. According to am, di officers come from different units like Mobile Police, SWAT, Anti-Kidnapping Squad and Force Intelligence Department. Police say dem put di security arrangement to keep […]

todayMay 28, 2026 25

obodo oyinbo

Fire For Kenya Girls School Dorm Kill 16

By: Esther Ayoola Fire wey catch girls dormitory for Utumishi Girls Academy for Nakuru County, Kenya, don kill at least 16 people while 73 others dey hospital. Police source wey tuk to AFP say di fire start around 1 o’clock early Thursday morning as more than 220 girls bin dey sleep for di hostel. Emergency workers, ambulance people and rescue teams quickly reach di school to help victims and carry […]

todayMay 28, 2026 12

OBODO NAIJA

Federal High Court Go Dey Open Weekend For Election Case Filing

By: Esther Ayoola Federal High Court of Naija don order say all dia registries for every division across di kontri go dey open weekends and public holidays from 10am reach 2pm to collect only pre-election matter papers ahead of 2027 general elections. Chief Registrar of di court, Yahaya Shafa, yarn dis one for statement wey dem release on Thursday, say dem do am because di time wey law give for […]

todayMay 28, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds