Blog no sidebar

Background

Lagos

Lagos Traffic Arrest Ambulance Driver Say Im Wunjor Dispatch Rider

By: Esther Ayoola Nor be small gbege oh, between Lagos State Traffic Management Authority and  one ambulance driver,  say im go,  wunjor one delivery rider for leg for Odo Iya-Alaro bridge wey dey go Maryland along Ikorodu road. The two  both of dem drag demsleves for  traffic wella wella, nor be small. Lagos state traffic management agency tuk tuk person, Adebayo Taofiq, confirm the matter for statement on monday. Wey […]

todayDecember 9, 2025 5

Lagos

Lagos Gorment Ginger Dia Women Leaders To Wrestle Tuberculosis

By: Esther Ayoola Based on the rascality of the ogbonge diseases wey dem dey call,  tuberculosis, Lagos State gorment  like this like this don enter meeting  appoint womens with capacity,  including female lawmakers, newly elected female local government chairmen, and wives of lawmakers say make dem act as Ambassadors to fight tuberculosis for community level. This particular event dem  hold for First Lady Banquet Hall, Lagos House, wia the  First […]

todayDecember 9, 2025 6

International

TikTok Lock Night LIVE For Naija

By: Rilwan Agbomeji TikTok don announce say dem go block Nigerians to dey use  LIVE late-night as from Sunday midnight, and na part of one serious safety investigation wey dem dey run. Plenty creators see in-app notice wey tell dem sharp-sharp say from 11pm reach 5am, LIVE don waka disappear and anybody wey try enter go just meet “No Access.” Di move shock users because even LIVE shows from other […]

todayDecember 8, 2025 23

Sports

Guardiola Ginger Im Boys To Stay Gallant Against Real Madrid

By: Rilwan Agbomeji Pep Guardiola don warn im Man City boys ahead of Wednesday Champions League clash with Real Madrid, say Bernabeu no be playground. E talk dis one afta City beat Sunderland 3–0 for Premier League, remind everybody say Madrid no be team you dey joke with. Even though Madrid just chop 2–0 to Celta Vigo, Guardiola yarn say Bernabeu fit humble any big team wey no shine eye. […]

todayDecember 8, 2025 8

National

Tinubu Wife Remi Warn Say She Fit Off Gov Adeleke Mic As Im Dey Sing

Nigerian First Lady Oluremi Tinubu don threaten to off Gov Adeleke mic as im dey sing for her installation as Yeye Asiwaju Gbogbo Ile Oodua on Sunday. Video wey trend show say Adeleke dey sing worship songs while dey give speech, but Remi waka go stage warn am make e stop or she go cut mic. She mouth say, I give you five minutes to conclude your speech, enough with […]

todayDecember 8, 2025 44

National

Court Reject Nnamdi Kanu Plan To Comot Sokoto Prison

Federal High Court Abuja on Monday block Nnamdi Kanu ex-parte request to move am from Sokoto prison go another centre. Kanu, wey dey serve terrorism conviction, say e want shift go Suleja or Keffi so e fit follow up im appeal well well. But Justice James Omotosho talk say dis kain request no fit pass without hearing from Federal Goment and Correctional Service. Di judge order say make dem get […]

todayDecember 8, 2025 15

National

Federal Goment Release N50m Free Money Package For Tertiary Students

Federal Goment don open ground for Abuja on Monday as dem launch one N50m Student Venture Capital Grant wey go ginger innovation, research and entrepreneurship for all for all tertiary schools across Naija. Education Minister Dr. Tunji Alausa talk say dis S-VCG no be any normal grant at all, na big national investment wey align with Tinubu Renewed Hope Agenda, and e go fish sharp brain ideas from campus, boost […]

todayDecember 8, 2025 12

National

Jaguda Boys Enter Church With Bad Character Kill Priest Wife For Anambra

By: Esther Ayoola Some armed Jaguda boys, based on rugged movement, don carry their bad character enter St. Andrews Anglican Church for Isiokwe, Lilu, Ihiala, Anambra State early Sunday, burn priest house and  kill two people. According to Eye wey see,   one of di persons wey kpai, na di wife of di priest, as them scatter  vehicles and properties scatter for the church compound. Di whole wahala happen early Sunday,  […]

todayDecember 8, 2025 6

National

Oga Presido Tinubu, Macron Align Marras On Naija Security

By: Rilwan Agbomeji Presido Tinubu and France oga patapata, Emmanuel Macron don reason for phone on Sunday on top di security gbege wey dey shake Naija. Di phone call happen for di same time when one US delegation and dia big big officials land Abuja go meet Nuhu Ribadu to reason di tori on top Christian persecution and killings.  Macron later yarn for X say France ready to stand gidigba […]

todayDecember 8, 2025 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds