Blog sidebar

Background

National

FRSC: Six Kpai, 23 Injured As Trailer Lose Control For Lagos–Ibadan Expressway

By: Esther Ayoola Say Six pipo ni kpai, while 23 others get wunjury for one road crash wey happen near Four Square Camp for Lagos–Ibadan Expressway. FRSC Public Relations Officer Odunsin Afolabi ni convastae dis one, say di askident  hapun around 11:27 am, and dia rescue team reach di scene in just two minutes. Afolabi Yanyanpu say na one trailer speeding and fatigue, ni cause di crash. Di FRSC tuk […]

todayFebruary 3, 2026 13

National

Senate Ready To Finish Electoral Act Bill

By: Esther Ayoola   Wi Senate go resume debate on di controversial Electoral Act amendment bill on Tuesday, as pipo dey vex over di delay, say e fit affect di 2027 general elections. Dem don form seven-member ad hoc committee wey go harmonize senators’ positions and settle wahala wey dey di bill. Di committee, wey dem form last Thursday afta three-hour private session, don spend three days to check di […]

todayFebruary 3, 2026 18

National

CJN Charge Judges To Dey Sharp, Manage Cases Faster

By: Esther Ayoola Madam Chief Justice of Naija (CJN), Justice Kudirat Kekere-Ekun, don go  ell Naija  judges say, dem suppose sabi how to manage cases and dat  justice suppose dey  fast. Justice Kekere-Ekun yarn dis one for Abuja yesterday during one refresher course wey National Judicial Institute (NJI) organise for top court judges on “The Management of Evidence in Trial.” She tuk say to deliver justice quick, judges gats sabi […]

todayFebruary 3, 2026 8

National

IGP Explain How Naija Police Go Take Sharpen Dia Skills For Peace-Keeping

By: Esther Ayoola Oga Inspector General of Police Kayode Egbetokun say Naija Police go need focus more on specialised skills for peace-keeping work, dat, na wetin dem go dey do moving foward. IGP explain say, nowadays, di work dey hard police to do peace keeping because of terrorist threats, violent extremism, organised crime and digital wahala. Egbetokun drop dis yarnings yesterday for one two-day lecture wey Naija Police do with […]

todayFebruary 3, 2026 15

National

FG Join States And Local Government For Electricity Subsidy

By: Esther Ayoola Say wi Federal Gornment don wash hand comot from electricity mata, dat Moving forward, electricity subsidy, dem nor go dey carry am alone. Dem tuk say from 2026, di cost go dey shared between federal, state, and local governments. Director-General of Budget Office, Tanimu Yakubu,  ni  yarn dis one, say, President Tinubu don direct make subsidy costs dey clear, tracked, and shared fairly among di other two […]

todayFebruary 3, 2026 15

National

Court Stop NLC, TUC From Strike As FCT Government Go Court

By: Esther Ayoola Justice Emmanuel Subilim for National Industrial Court don stop NLC, TUC, and three oda groups from any strike or protest for now. Di order come afta FCT Minister, Nyesom Wike, and FCTA go court to block di mass protest wey dem plan for 3rd February. Court also tell security agencies make dem make sure say law and order no collapse. Recall, NLC and TUC tuk say make […]

todayFebruary 3, 2026 16

obodo oyinbo

President Trump Slash India Tariff Go 18% From 50%

By: Esther Ayoola President Donald Trump don drop ogbonge update, say US go cut tariff wey dem dey charge Indian goods from 50% to 18% afta meeting with Prime Minister Narendra Modi. India come agree say, dem nor go dey buy Russian oil again and dem go dey buy oil from US and maybe Venezuela. According to Trump, dis waka with India go reduce trade barriers and India go dey […]

todayFebruary 3, 2026 17

obodo oyinbo

Iran, US Set Tuk For Istanbul To Avoid War

By: Esther Ayoola Iran say dem dey hope for progress to start nuclear tuk wit US again. Some people dey tuk say di Iran president don order make dem revive di negotiations. Tehran dey look tori wey some countries for di area bring come and dat e don reduce tension wit Washington. Reuters Report, say US and Iran go meet for Istanbul on Friday, US envoy Steve Witkoff and Iran […]

todayFebruary 3, 2026 12

Sports

FIFA Presido Begin Waka To Stop Russia Football Ban

By: Esther Ayoola FIFA president Gianni Infantino don drop yarns say, time don reach to remove Russia from football ban. You sabi say, FIFA banned Russia since dem enter war with Ukraine for 2022. Infantino say, di ban nor hellep anybodi, say, instead e only bring more disappointment and hatred. Di FIFA president dey yarn dis one for TV sit don tuk say, make dem begin allow Russia players to […]

todayFebruary 3, 2026 8

Sports

Team Nigeria, Uzbekistan Land Lagos For Davis Cup Showdown

By: Esther Ayoola Say like dis area dey hot for di Davis cup, dat, Team Nigeria don move dia training camp from National Stadium, Surulere go Lagos Lawn Tennis Club, wey go host dia Davis Cup World Group II match against Uzbekistan on February 7–8. Uzbekistan team sef don land Lagos on Sunday, dem do dia first on-court practice on Monday. Di Uzbek team carry three players plus four officials, […]

todayFebruary 3, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds