Blog sidebar

Background

OBODO NAIJA

APC Boast Say Dem Go Pull Over 10 Million Votes Again For Tinubu

By: Esther Ayoola Oya, look wetin dey sup for politics: Di National Chairmo of APC, Nentawe Yilwatda, don rake full newspaper say im party go collobi pass 10 million votes for di 2027 presidential election. Yilwatda yarn dis one for TV sit down tuk on Monday afta President Bola Tinubu win di party presidential primary with 10.9 million votes. Im explain say, di reason why im dey get dis kind […]

todayMay 26, 2026 20

south west

Ogun Gornment Face Police Boss, Not To Mix Mouth For Church Land Case

By: Esther Ayoola Ogun State Gornment don warn one big police oga for Force Intelligence Department Abuja, AIG Enyinnaya Adiogu, to stop di double touch lighting wey im dey do on top one land case wey connect one Church for Sango-Ota. Inside one letter wey date May 23, di Ogun State Attorney General and Commissioner for Justice, Oluwasina Ogungbade, tell di AIG make he hands-off di mata since di land […]

todayMay 26, 2026 26

Lagos

Police Catch 9 Pipo Say Dem Kpake N60M Goods For Lagos

By: Esther Ayoola Zone 2 Police Command for Onikan, Lagos State, don catch nine suspects wey dey inside two big bad-gang wey work na kpake and divert goods wey pipo buy to sell. Oga Assistant Inspector-General of Police (AIG) for di zone, Olohundare Jimoh, clear every about di mata on Monday for press briefing Jimoh tuk say di Zone 2 Dragon Team detectives follow correct info wey original informant give […]

todayMay 26, 2026 25

Lagos

Police Burst Secret Drug Warehouse For Lagos, Seize 425 Bags Of Canadian Loud

By: Esther Ayoola Di Assistant Inspector General of Police (AIG) for Zone 2, Olohundare Jimoh, don burst one secret warehouse for Mende area of Maryland, Lagos, wia dem recover 425 bags of Canadian Loud and other drug items. Jimoh fry mouth say Police do dis special operation for No. 10 Olori Adekemi Ajibola Street, inside Mende over di weekend. Dem target one 41-year-old man wey name na Henry Ifeanyi, dat […]

todayMay 26, 2026 25

Sports

How 2026 World Cup New Rules Fit Benefit Football

O boy, see as di matter be, di 2026 World Cup wey dey come so, no be small thing o. FIFA don change di game rules kpatakpata to make sure say football sweet, e fast, and everything move correct. Di countdown for football history don enter final stage, e remain just 20 days make ball start to roll for June 11, 2026. Dis World Cup fit change di way wey […]

todayMay 25, 2026 62 5

Entertainment

Advanced Metastatic Kidney Cancer: “Wetin Alexx Ekubo Death Teach Us About Our Health”

One kain heavy silence dey always enter house anytime sickness land, di laugh wey dey burst everywhere go begin reduce, pipo go dey talk low-low, plans and dreams wey dey fly high go begin drag leg, even money wey plenty reach mountain go suddenly look like ordinary paper. For dis life, many pipo dey kill body pursue money, dem go wake before cock crow, suffer traffic, skip food, ignore body […]

todayMay 25, 2026 33

Sport Yarns

Messi Injury Scare Argentina Fans Before World Cup

By : Jolayemi Olajide Lionel Messi don raise fresh injury fear, after e ask make dem substitute am during Inter Miami match against Philadelphia Union for MLS on Sunday. Di Argentina captain hold di back of him left leg before comot for the game in the 73rd minute during di rain-soaked match for Miami. Even though Messi waka comot by himself and enter tunnel without help, fans still dey worry […]

todayMay 25, 2026 23

obodo oyinbo

Pope Leo XIV Warn Say AI Fit Bring Modern Slavery

By : Jolayemi Olajide Pope Leo XIV don call for better control of artificial intelligence, warning say di fast-growing technology fit create new forms of slavery if dem no handle am well. For him first encyclical titled “Magnifica Humanitas,” di Pope warn against di global race to build more powerful AI systems just for political and business dominance. He present di document for Vatican alongside AI experts including Christopher Olah, […]

todayMay 25, 2026 21

Health

No Chop “Ata Esha” Again! Aproko Doctor Warn Say Spoilt Tomatoes Dey Cause Liver Cancer!

By : Jolayemi Olajide Popular health influencer, Dr. Chinonso Egemba wey everybody know as Aproko Doctor, don warn Nigerians on Monday make dem stop to dey buy and chop spoilt tomatoes wey people dey call “Ata Esha” or “Awarawa.” Inside one heavy health advisory wey roll for his X account, di doctor talk say those white-white things inside di rotten tomatoes na fungus wey dey produce one dangerous poison called […]

todayMay 25, 2026 20

Lagos

Lagos Gornment Arrest Over 10,000  for  crossing Highway crossing

By : Jolayemi Olajide Baba  Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, don reveal say Lagos State Government arrest over 10,000 pipo for inside Alausa for di past one year because of environmental law breaking. Wahab tuk dis one  during dia  2026 Ministerial Press Briefing, say dem gbab 5,715 pipo wey dey cross highway, 102 people for open defecation, and thousands more for street trading, cart-pushing, and waste table-shaking. […]

todayMay 25, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds