Blog sidebar

Background

OBODO NAIJA

NYSC Don Set Date For Batch B Stream I POP

By: Emmanuel Ariyo-David National Youth Service Corps don approve Thursday, July 9, 2026, as official passing-out date for 2025 Batch ‘B’ Stream I corps members across Nigeria. NYSC announce di date for statement wey dem post for dia official X handle on Wednesday, signed by Director of Information and Public Relations, Caroline Embu. According to di statement, activities wey go lead to di passing-out exercise start since June 23. Di […]

todayJune 24, 2026 14

OBODO NAIJA

Sowore Fight To Get Im Freedom Back

By; Emmanuel Ariyo-David Federal High Court for Abuja don shift ruling till June 30, 2026, say na dia, dem go hear di bail application of senior man activist and publisher Omoyele Sowore Justice Mohammed Umar take di decision after both sides adopt dia processes for di mata. On June 16, di court revoke Sowore bail and order make dem arrest am after e no show for court over allegations of […]

todayJune 24, 2026 14

obodo oyinbo

Heatwave Dey Roast Europe, Thousands Lose Light

By : Jolayemi Olajide Serious heatwave don continue to hit Europe, say di place be like temo version of hell fire,  temperatures dey rise again, leaving tens of thousands of people without electricity. World Health Organization boss Tedros Adhanom explain,  say di heat don force some schools to close and dey threaten pipo health. According to am, temperatures for Europe dey rise almost twice faster than the global average, increasing […]

todayJune 24, 2026 9

OBODO NAIJA

State Police Matter, Retired Security Oga Gets Different Views

By: Emmanuel Ariyo-David Some retired military and police ogas don tuk  dia own tuk about how much power gofnor suppose get if state police start, with fear say some go fit abuse di system. Like dis Gofnors dey push make dem get more constitutional power to get state police Last week for Abuja, top lawyers, Attorneys-General and security chiefs meet under Nigeria Gofnors Forum Secretariat to discuss how di new […]

todayJune 24, 2026 6

Sport Yarns

FIFA World Cup Golden Boot Race Hot

By : JolayemI Olajide Race for the 2026 FIFA World Cup Golden Boot don hot up after second round of group-stage matches finish, with Argentina captain Lionel Messi leading the scorers table. The eight-time Ballon d’Or winner don score five goals and never record any assist so far. Messi start the tournament with hat-trick before adding two more goals for Argentina second group game.

todayJune 24, 2026 14

OBODO NAIJA

Akpabio Open National Assembly Door For Four New Senators

By: Emmanuel Ariyo-David Senate Presido Godswill Akpabio on Wednesday swear in four new senators wey win di recent bye-elections wey INEC conduct. Di lawmakers na Olaka Nwogu of PDP for Rivers South-East, Envulu Anza of APC for Nasarawa North, Ikeje Asogwu of APC for Enugu North and Dayo Faduyile of APC for Ondo South. Dem enter Senate after last Saturday bye-elections wey happen to fill vacant seats for di four […]

todayJune 24, 2026 6

south west

Ogun Police Gbab Two Suspected kidnapers

By: Emmanuel Ariyo-David Operatives of Ogun State Police Command don go kpai two suspected kidnappers and recover gun, cash and other items during one follow-up operation linked to di rescue of one kidnapped victim. Police talk say na officers from di Anti-Kidnapping Unit carry out di operation as part of efforts to fight kidnapping and other violent crimes for di state. According to statement wey police spokesman DSP Oluseyi Babaseyi […]

todayJune 24, 2026 8

Lagos

LAGOS ON CLEAN-UP MISSION, Throw 13 Pipo Inside Jail

By: Emmanuel Ariyo-David Any kind person wey dey play with Lagos State Gornment, dey on  along tin oh, like dis environmental law kramp some pipo for Oshodi. Magistrate court for Bolade, Oshodi don sentence 13 pipo to three months imprisonment each say dem go throw dia dirty yayaayaa for area, wey dey illegal .   Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, naim dey dey konfam say all 13 […]

todayJune 24, 2026 10

south west

NDC Turn Main Opposition As Lawmakers Switch Sides

By : Jolayemi Olajide Di political landscape for Edo State House of Assembly don witness massive shake-up as di Nigeria Democratic Congress (NDC) don emerge as di new major opposition party. Dis development follow di movement of three lawmakers who officially dump di All Progressives Congress (APC) and di Peoples Democratic Party (PDP) to join forces with di NDC. Edo NDC Chairman, Babatunde Olukoga, don submit a letter to Speaker […]

todayJune 24, 2026 9

south west

 Oyo Lockdown! Gov. Makinde Impose 16-Hour Curfew For 10 Local Government Areas

By : Jolayemi Olajide Security wahala don reach boiling point for Oyo State as Governor Seyi Makinde don officially declare 16-hour curfew for 10 local government areas wey dey border di Old Oyo National Park. Di new order, wey start today, Wednesday, June 24, 2026, mean say nobody suppose dey outside between 4:00 p.m. and 8:00 a.m. The curfew go last for at least 48 hours as security agencies intensify […]

todayJune 24, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds