Blog sidebar

Background

Lagos

LSSTF, Police Airwing Start Sky Patrol To Tackle Crime For Lagos

By: Esther Ayoola Lagos State Security Trust Fund don begin touchlight area from air with ogbonge collabo with Nigeria Police Force Airwing Command to fight crime. For statement wey dem release on Monday to tori pipo, LSSTF Executive Secretary, Ayo Ogunsan, explain how dem wan take buy waka with di police. Ogunsan say dem go use helicopter patrol to gada security informate, and  respond fast to threats, say criminals nor […]

todayFebruary 24, 2026 5

Lagos

FAAN Rescue All 14 Fire Victims For Lagos Airport

By: Esther Ayoola Say nor be small Fire catch for Old Terminal of Murtala Muhammed International Airport for Lagos yesterday afternoon around 3:20pm. According to report, Federal Airports Authority of Nigeria, FAAN, and Lagos State Fire Service do beta rescue, save all 12 pipo wey di fire trap, and dem konfam say nobody die. FAAN oga Madam Olubunmi Kuku, later clear newsmen on di update, dat, dem don start investigation […]

todayFebruary 24, 2026 2

Lagos

LAWMA Arrange New Plans For Waste Management

By: Esther Ayoola Lagos Waste Management Authority don announce new way, wey dem wan take manage dirty for Apapa-Iganmu area, say na operation show your Payment Receipt. Dis dem disclose for statement signed by oga LAWMA, Muyiwa Gbadegesin, con post for   Lagos State Gornment’s official social media platforms on Monday say make all residents and business owners readi dia assigned Private Sector Participant waste operators. Oga LAWMA say, di exercise […]

todayFebruary 24, 2026 5

Lagos

Lagos Gorment Approve 13% BRT Fare Increase From March 2

By: Esther Ayoola Lagos State gornment don approve BRT bus fare increase by 13% say na Bus Reform Initiative schemes. LAMATA Head of Corporate Communication, Kolawole Ojelabi ni put dis for statement give tori pipo, say Govo Babajide Sanwo-Olu gree for di increase because bus operators dey complain money nor reach dem do anything. Ojelabi say, di new fares go start from Monday, March 2nd, 2026.

todayFebruary 24, 2026 6

Lagos

Cement Truck Crush LASTMA Officer, Two Okada Riders For Badagry

By: Esther Ayoola Tragedy hapun for Badagry Roundabout, Lagos on Monday, say one cement-loaded truck run LASTMA officer plus two okada riders, and all kpai on di spot. Eyewitness tuk say di truck dey rush anyhow, e lose control, and na so e scara area. Police and FRSC pipo rush to di scene, while traffic jam everywia. Divisional Police Officer of Badagry Police Station, CSP Folajimi Agosile, also konfamte dis […]

todayFebruary 24, 2026 3

National

President Tinubu Make Plan To Start State Police For Rascal Jaguda Boys

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don announce ogbonge plan say, like dis, na to create state police be di way forward for di plenty security wahala for di kontri. Baba Seyi dey yarn dis one  wia im dey do wakies with governors of di obodo Naija for Abuja on Monday Mehn dey waka for di dinner,  Tinubu  dey think security,  say di reason na to make […]

todayFebruary 24, 2026

National

Kaduna Police Go Hard On Bandits, Gbab Suspected Drug Suppliers

By: Esther Ayoola Kaduna State Police Commissioner, Rabiu Muhammad, don share report card say dem do commando neutralise plenty suspected bandits for Kajuru, Tafa, Igabi, and Kauru Local Government Areas during dia February 2026 operation. Im dey yarn dis one for force headquarters, say na based on  intelligence-doings, dem take locate di  bandits’ camps and criminal hideouts. Mohammed say nor be small gun battle dem do with di jaguda boys, […]

todayFebruary 24, 2026 3

National

El-Rufai Drag ICPC, I-G & AGF Go Court Over Abuja House Raid

By: Esther Ayoola Former Kaduna State Governor, Nasir El-Rufai, don drag Independent Corrupt Practices Commission, ICPC, go court for ₦1 billion, say dem enter him Abuja house without permission. Im lawyer, Oluwole Iyamu, SAN, clear tori pipo for Abuja say di search warrant wey Chief Magistrate for FCT issue on February 4 nor follow at all. For di suit wey dem file on February 20, El-Rufai name ICPC, di Magistrate, […]

todayFebruary 24, 2026 3

National

How APC Chairmo Package Big Move For Naija Politics

By: Esther Ayoola Di National Chairmo of di All-Progressives Congress (APC), Prof. Nentawe Yilwatda, don officially open di governing board of di Progressives Institute (TPI) to think out ways for 2027 election. Dis ceremony hapun on Monday for di APC National Secretariat for Abuja. Yilwatda say, dis move na big step wey go hellep not just di APC but improve Nigerian politics.

todayFebruary 24, 2026 3

obodo oyinbo

Trump Say War For Iran Na Easy War Despite General Warnings

By: Esther Ayoola Oga Presido of United States, Donald Trump, dey vex wetin nor good say im Joint Chiefs of staff chairmo, General Dan Caine, warn am say, Iran attack fit be big problem. Trump write for social media on Monday say, Caine believe say Iran get power well, well.” Washington Post report say Caine tell Trump say dem dey short of important ammo and dat dem nor go fit […]

todayFebruary 24, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app